By: Yusuf Abuh
Wi oga Presido, Bola Tinubu don ginger Naija Liquefied Natural Gas, NLNG to reduce gas flaring and make better use of Nigeria gas reserves so Nigerians fit enjoy more economic benefits.
Tinubu make di call on Wednesday for State House, Abuja, when e meet NLNG Board members wey di company Managing Director and CEO, Adeleye Falade carry come.
Baba Seyi say NLNG must look beyond making money from international market and focus more on using Nigeria gas resources to boost di local economy