By: Esther Ayoola
Oga govo, Babajide Sanwo-Olu don sama beta warning to truck and cargo motor owners, say make dem nor dey give dia motor to drunk drivers.
Sanwo Olu, make am clear say, any driver wey dem catch on hard drugs go get am hot, hot from di state gorment.
U sabi say, na About 1,000 officers of National Drug Law Enforcement Agency Lagos State Command, don benefit from di governor free eye care program to hellep dem stay fit for duty.
Dem hold di exercise for NDLEA Area Strategic Command for Festac, through Ministry of Transportation
Untop yanings with newsmehn, Senior Special Assistant on Transportation and Logistics, Hassan Adekoya, say officers, dey get am clear, any driver wey dem catch go hear word by force.