Di Federal Gornment don pause di bridge work for Aseese side for Lagos-Ibadan Expressway today November 20th 2026, afta heavy traffic block road pass 20 hours, wey pipo nor fit go where dem dey go on time.
Federal Ministry of Works and CBC Construction Company been plan di work from Wednesday reach Sunday, but Ogun State traffic diversion wey cause serious traffic from Wednesday afternoon reach Thursday afternoon make dem stop di work for now.
Di Presidential Media Adviser, Sunday Dare, shake im head on top di traffic wahala as e ask why dem choose to do di bridge for day time wen people dey waka pass for di Aseese road , instead of night wey pipo nor too many for road.
He tok dis one for im Facebook page on Wednesday night 18th of November say pipo dey abandon dia motor inside traffic dey trek go where dem wan go.