Blog horizontal

Background

Lagos

Police Hunt Driver Wey Kill House Agent For Lekki

By: Esther Ayoola Lagos state police command don carry fork, wrake and all dia equipment  enter Lagos dey find one driver wey dem accuse of killing a house agent, Yinka Agboola, because of fight over parking space for, orchid road, Lekki. U sabi say,  Konfam bin report last week how di wahala take start,  dem tell di driver make e move im motor from middle of road and even show […]

todayDecember 15, 2025 6 1

Lagos

FRSC Share Report Card Say 91 Kpai For Lagos Road Crash

By: Esther Ayoola Federal Road Safety Corps, Lagos state branch, don mark present, share report card say, not to make anibodi fear, say from dia record say wawawa driving don kpai at least 91 people across di state between January and November 2025. Lagos FRSC Sector Commander, Kehinde Hamzat, yarn dis one for tuk tuk meeting wey im do with tori pipo wey dem hold for Ojodu-Berger on Friday. Di […]

todayDecember 15, 2025 5

Lagos

Nigerian Wear Chain For Dia Officers Neck Say Dem Try For Dia Old Age

By: Esther Ayoola Nigerian navy over di weekend don hold dia awards night for naval dockyard, Victoria island, Lagos, to mark di formal end of dia 2025 activities and celebrate officers wey perform well. Vice admiral Idi Abbas, chief of naval staff, tell journalists say di event na to recognise officers and ratings wey show dedication and help di navy achieve dia mandate for di year. Di ceremony, wey sup on […]

todayDecember 15, 2025 9

Lagos

Early Mormor Fire Scarra 48 Shops For Elegushi Market, Lekki

By: Esther Ayoola One early mormor fire don scatter Elegushi Model Market for Lekki area of Lagos State, say e burn wetin nor good from about 48 shops. Permanent Secretary of Lagos State Emergency Management Agency, Olufemi Oke-Osanyintolu, wey jump comot sleep go the area na dey confamate dis tori for statement on Sunday. E talk say dem receive emergency call around 2 a.m., and when dem reach the place, […]

todayDecember 15, 2025 4

National

President Tinubu Wire Call To West African Leaders To Join Bodi Fight Terrorism

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don  recharge 100 naira,  wire wire call  to West African leaders say make dem join hand fight terrorism and military takeovers for di region. As im dey vex, i nor fit tuk so, im carry the phone give im  vice, Kashim Shettima for di 68th ECOWAS summit wey sup for Abuja on Sunday. Tinubu yarn say no single country fit bring stability alone, and […]

todayDecember 15, 2025 8

National

FG Rake Full Newspaper Say Health Sector Standard For Di Obodo Nigeria

By: Esther Ayoola Wi Federal Gorment don bring mata dey rake full newspaper say Nigeria health sector dey stable for di last two and half years, and nothing serious don disturb am. Minister of Health, Ali Pate, yan this one on Sunday for TV sit down tuk, say na because di federal gorment give am beta attention and dem put money for di sector. Pate talk say, “For di last […]

todayDecember 15, 2025 5

National

PDP Back Governor Diri Say Make Dem Do Autopsy Test For Im Late Deputy

By: Esther Ayoola Bayelsa PDP don support Governor Douye Diri decision to carry out autopsy on him late deputy, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, make dem sabi how im die. Governor Diri give the order on Saturday when former President Goodluck Jonathan come condole with am and Ewhrudjakpo family for Government House, Yenagoa. Diri talk say dem do am because social media dey spread fake rumor and talk about wetin kpai the […]

todayDecember 15, 2025 7

obodo oyinbo

Syria Security Man Go Kpai 3 Americans

By: Esther Ayoola Syria Interior Ministry don comot bodi from US wahala, gbebodia, yarn say, na one of dia security officer go kill two US soldiers and one civilian interpreter for Palmyra on Saturday. Di ministry talk for state TV on Sunday say, normally, dat particular officer get bad character and di man suppose comot from work because e get extremist Islamic belief. Washington sef confamate say, di jaguda boy […]

todayDecember 15, 2025 7

Sports

NFF Call For Sponsors To Bring Video Assistant Referee To NPFL

By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation (NFF) don clear mata say dem nor hapi with how referees dey do their work for Naija football leagues, after Nigerian refs miss chance to officiate 2025 Africa Cup of Nations (AFCON). NFF tuk this one after dem Executive Committee meeting wey hold for Abuja, dey call on senior mhen make dem con sponsor video assistant referee doings for the NPFL. Confederation of African […]

todayDecember 15, 2025 3

National

Court Clean Room For Wi Former Minister Ngige For Kuje Prison

By: Rilwan Agbomeji Now make we comot body enter court, wia wi Former Labour Minister, Chris Ngige, deny all di 8 charges wey EFCC put for im head, for Abuja High Court and dat im carry ₦2.2 billion contract give family and friends. Di Minister say walahi im nor do anything like dat. Justice Maryam Hassan talk say make Ngige rent one room for Kuje Correctional Centre since im dey […]

todayDecember 12, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app