Blog horizontal

Background

Sports

Enzo Maresca Say VAR Mistake Na Part Of Football

By: Ayobami Dada Manchester City manager, Enzo Maresca, don describe di VAR mistake wey allow Erling Haaland controversial winning goal against Manchester United as “part of football.” City beat United 1-0 for Old Trafford on Sunday, but Haaland goal cause plenty talk after VAR check fail to cancel di goal. Speaking on Wednesday before City Carabao Cup match against Norwich on Thursday, Maresca say di VAR matter no suppose cover […]

todaySeptember 17, 2026 7

obodo oyinbo

European Union Wan Ban Under-13 Pikin From Social Media

By: Ayobami Dada European Union don bring plan wey go stop pikin wey never reach 13 years from using social media,as di EU dey try protect children from things wey dey make dem spend too much time online. EU chief, Ursula von der Leyen, announce di plan on Wednesday for European Parliament, say under di new plan, pikin go only fit use social media with limited and supervised access until […]

todaySeptember 17, 2026 7

Obodo Niger

Ondo Gofnor give kidnappers, criminals 14 days to comot from forest

By: Ayobami Dada Ondo State Gofnor, Lucky Aiyedatiwa, don give kidnappers and other criminals wey dey hide for di state forest 14 days to comot. Di Gofnor Senior Special Assistant on Forestry, Bidemi Obayangban, make dis one known during interview with newsmen on Wednesday for Akure. Obayangban say di order dey mainly target kidnappers and other criminals wey dey use di forest as hideout. And e add say di move […]

todaySeptember 17, 2026 5

Obodo Niger

Tinubu Mourn Olu Jacobs As Di Veteran Actor Kpai At 84

By: Ayobami Dada Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don mourn veteran Nollywood actor, Olu Jacobs, wey kpai at di age of 84. For statement wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, release on Wednesday, Tinubu tok say Olu Jacobs na one of Nigeria big-time actors, wey im career cover theatre, TV and movies for inside wi Obodo Nigeria and wi Obodo World. Tinubu say di late […]

todaySeptember 17, 2026 5

Politics

Lagos Lawmakers Konfamate 12 Pipu Wey Gofnor Sanwo Olu Nominate

By: Ayobami Dada Di Lagos State House of Assembly on Tuesday don konfamate 12 pipu wey Lagos State Gofnor, Babajide Sanwo Olu send as nominees to serve for two gorment commissions and one agency for di state. Na di Chairman of di committee, Hon. Mojeed, present di report and talk say di committee carefully check di nominees based on dia qualifications, how dem perform during screening and dia conduct. E […]

todaySeptember 17, 2026 4

Sports

Axel Witsel Hang Him Boot for Belgium National Team

Veteran midfielder Axel Witsel don announce say e don retire from international football on Wednesday, after e represent Belgium 140 times. Di 37-year-old play im last game for Belgium for July, when dem lose 2-1 to Spain for World Cup quarter-final. Witsel first play for Belgium in 2008 and e become important player for di country golden generation, alongside players like Kevin De Bruyne, Romelu Lukaku and Eden Hazard. But […]

todaySeptember 17, 2026 8

obodo oyinbo

China Ready To Protect Iran Rights

China Foreign Minister, Wang Yi, say Beijing ready to hellep protect Iran rights as e meet Iran Foreign Minister, Abbas Araghchi, on Wednesday for China. Wang say China ready to tok and work with Iran and make sure say Iran legitimate right dey protected. Di meeting come as China dey try help find way to settle di war between Iran and America. Di talks happen one week before China Presido, […]

todaySeptember 17, 2026 5

OBODO NAIJA

Federal Gorment Hellep Workers As Petrol Price Dey Rise – NLC

Nigeria Labour Congress (NLC), don call on Federal Gornment to quickly bring measures wey go reduce di suffering wey rising petrol price dey cause. NLC Presido, Joe Ajaero, tok for statement on Wednesday say petrol don reach about ₦1,430 per litre for major cities, while di price fit dey higher for places wey hard to reach. Labour warn say di petrol price increase go make economic hardship worse, as transport […]

todaySeptember 17, 2026 5

OBODO NAIJA

Only Six Northern Gofnors Support Tinubu For 2023 – Shettima

Vice Presido, Kashim Shettima don reveal on Wednesday say na only six out of 19 northern Gofnors support President Bola Tinubu presidential ambition for di 2023 election. Shettima talk dis one for di palace of Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, during di turbaning of Kwara Gofnor, AbdulRahman AbdulRazaq, as Sardauna of Ilorin Emirate. E say di tension wey follow di 2023 presidential campaign and election dey very clear, and […]

todaySeptember 17, 2026 8

Lagos

Nobody Kpai For Di Askident Wey Happun For Otedola Bridge

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don rescue everybody wey involve for di serious askident  wey happen for Otedola Bridge, inward Berger, on Wednesday afternoon, as nobody kpai for di askident. Na two trucks, one trailer, one white Honda car and one Lexus dey involved for di askident as initial check show say one container truck develop mechanical problem as e dey move, di driver kon lose control, jam […]

todaySeptember 17, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds