Blog horizontal

Background

National

Tinubu Enter London To Naija Sign £746m Deal With Citibank To Fix Apapa Port

By: Esther Ayoola Wi Oga Presido Bola Ahmed Tinubu on Thursday for London joinbodi with Naija a Ministry of Finance, wey Wale Edun lead, sign £746 million deal with Citibank to upgrade ports for obodo Naija. Edun tuk say di agreement go help modernise Apapa Port and Tin Can Island Port, reduce congestion and make business move faster. According to gornment, dem do am to strengthen Naija trade, improve efficiency, […]

todayMarch 20, 2026 1

Lagos

Lagos Trade Fair Traders Beg FG To Stop Roadblocks, Taxes For Market

By: Esther Ayoola Traders for Lagos International Trade Fair Complex don wire call like dis to Federal Government to check all di wahala wey dey with roadblocks and taxes wey dey slow containers and goods for di market. Dem tuk say conventional security agencies and other bodies dey disturb trade, wey dey affect business growth. According to report, Di Minister of Industry, Trade and Investment visit di market for Lagos […]

todayMarch 20, 2026

Lagos

Lagos Police Commissioner Go Patrol To Guide Area For Eid El Celebration

By: Esther Ayoola Officers, dat is olokpa of di lagos police command don do join body patrol with Naija military to check mate every every for di Eid el fitr celebration. Say dis convoy sef na di commisoner of police Olohundare Jimoh ni lead di team enter some corners for Lagos on Thursday. For di police commissioner say, di major aim na to make sure say every wia dey safe […]

todayMarch 20, 2026

Lagos

Lagos Police Put Strong Security For Eid To Stop Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Lagos State Police command like dis don arrange plenty security measures for Eid-el-Fitr to make sure say pipo stand fit for di celebration. Police tuk tuk,SP Abimbola Adebisi yarn dis one for statement wey dem release on Wednesday for Lagos. She tuk say na Inspector-General of Police, Olatunji Disu, and Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, give di order for di deployment. According to di police tuk, tuk, […]

todayMarch 19, 2026 8

Lagos

Lagos Gorment Warn Against Illegal Parking Operators For Computer Village

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don alert residents and motorists on Wednesday, say some fraudsters dey pose as parking operators for Computer Village, Ikeja to collect money from drivers. LASPA General Manager, Adebisi Adelabu, tell newsmen dat dem don uncover how di fraudsters dey work with touts to illegally charge of N1,000 for parking. She also explain say some illegal operators dey arrest cars without gorment permision, make owners […]

todayMarch 19, 2026 5

Lagos

LASRERA Seal Ikorodu Office of Fake Real Estate Agent

By: Esther Ayoola Di Lagos State Real Estate Regulatory Authority (LASRERA) tuk say dem seal di office of some fake real estate agent for Ikorodu on Wednesday. Dem accuse di company of pretending to be licensed realtor and dey use fake registration number. Untop yarnings with newsmen, Special Adviser to di Governor on Housing, Barakat Odunuga-Bakare, say dem dey do dis to protect residents from fraud and restore trust for […]

todayMarch 19, 2026 2

National

Oyo Police Re-Catch Suspected Kidnapper Weh Escape Custody

By: Esther Ayoola Oyo State Police Command don re-arrest one suspected kidnapper wey escape from police hand before. According to police tuk tuk, DSP Ayanlade Olayinka on Wednesday, di Police catch di man, Ayomide Kareem, 25 from Osorun’s Compound, Oyo, for Irepo Junction, Ojongbodu, around  during one routine stop-and-search patrol. Dem stop am because e dey waka suspicious, and wia dem con see say  na di same person wey escape […]

todayMarch 19, 2026 5

National

VP Shettima Vow Say FG Go Crush Terrorists, Visit Maiduguri Bomb Blast Victims

By: Esther Ayoola Vice Presido Kashim Shettima don tuk say Federal Government go make sure say dem defeat terrorism, and anybody wey dey behind recent attacks go face serious action. E tuk say apart from order wey president don give security chiefs, government dey put more money for equipment and logistics to strengthen di fight against terrorism. Shettima yarn dis one for Maiduguri when e go visit people wey bomb […]

todayMarch 19, 2026 1

National

CDS Oluyede Insists Say Borno, Yobe Pipo Must Join Fight Against Boko Haram

By: Esther Ayoola Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, on Wednesday for Maiduguri Say na some residents for Borno and Yobe dey support insurgents, say if not, why dem nor dey share informate with security. Di Army chief  yarn dis one afta one four-hour security meeting wey include Army Chief Waidi Shuaibu and Operation Hadin Kai commander Abdulsalam Abubakar, as dem review how Boko Haram and ISWAP sti dey operate. […]

todayMarch 19, 2026 1

National

Police Pay N2.4B Insurance Money To Officers, Families

By: Esther Ayoola Say di Naija Police don pay over N2.4 billion insurance money to 1,075 officers and pipo wey lose dia life on duty, under di Group Life Assurance plus IGP Family Welfare Schemes. Di Inspector-General of Police, Olatunji Disu, ni give di cheque to families on Wednesday for Force Headquarters, Abuja. Dat di money cover different years, including 2018 reach 2026, plus some old once wey dem never […]

todayMarch 19, 2026 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app