Blog horizontal

Background

National

VP Shettima Open Nigeria Business Meeting Centre For Davos To Collobi Investors

By: Esther Ayoola Vice President Kashim Shettima don officially open Nigeria House for Davos as 2026 World Economic Forum (WEF) start for Switzerland, tuk say e go hellep attract investors enta Nigeria. He explain say na di first time wey Nigeria go get House for Davos to show di country economic opportunities. Shettima add say Nigeria House go serve as hub wey investors fit meet, discuss business, and make partnership […]

todayJanuary 19, 2026 2

National

Ilorin Enter Mourning As Chief Imam Shaykh Solih Kpai For age 75

By: Esther Ayoola Di Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, don announce say di Chief Imam of Ilorin, Shaykh Muhammad Bashir Imam Solih, don kpai  early mormor at di age of 75. Di Emir share dis report with tori pipo on Monday afternoon  say dem receive di news with total shock. He describe di late Chief Imam as a man of wisdom, honesty, loyalty and strong dedication to Islam and […]

todayJanuary 19, 2026 3

National

FG Drop New Housing Plan to Tackle Naija Housing Wahala

By: Esther Ayoola Federal Gornment don drop new national housing plan wey go focus on land reform, urban renewal and public–private partnership to tackle Naija housing wahala. Housing Minister Ahmed Dangiwa yarn dis one for Ilorin during di 14th National Council on Lands, Housing and Urban Development meeting. According to am, Nigeria housing problem na based say everybody dey rush come city, population increase nor be here, and high cost […]

todayJanuary 19, 2026 6

National

Oyo Police Start Bush-Combing After Gunmen Kpai Police Officer

By: Esther Ayoola Police for Oyo State don start bush-combing operation to find kidnappers wey carry one Indian expatriate and oda criminals for di state. Police tuk, tuk, Olayinka Alayande, yarn dis one on Monday, say crime don dey reach critical stage for  Oyo State. E say police dey review dia security plans to stop kidnapping and other bad activities for all 33 local governments. News carry say, gunmen kill […]

todayJanuary 19, 2026 3

Lagos

Sanwo-Olu Sign ₦4.4 Trillion 2026 Budget For Lagos

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don on Monday sign ₦4.4 trillion 2026 budget into law for di state. E run di parrol for Conference Room, Lagos House, Alausa Secretariat, Ikeja. Oga Govo say di budget, wey dem call “Budget of Shared Prosperity,” go help improve life for people and support development across Lagos. U sabi says, Di Lagos State House of Assembly bin pass di bill earlier […]

todayJanuary 19, 2026 5

National

FG Open 2026 Scholar For Petroleum Postgraduate Students

By: Esther Ayoola Federal Gornment don start to dey collect applications for 2026 Petroleum Technology Development Fund (PTDF) Scholarship, wey go send Nigerian postgraduate students go UK, Germany, France, and Malaysia. Office of di Special Adviser to the President on Social Media, Dada Olusegun, ni post for X on Monday. According to di post, Scholarship dey for MSc and PhD students wey dey study oil and gas-related courses. Beneficiaries go […]

todayJanuary 19, 2026 3

obodo oyinbo

Gun Battle For Syria Afta Army and SDF Sign Ceasefire

By: Esther Ayoola Syria army and Kurdish-led Syrian Democratic Forces, SDF, do small gun battle today, just one day afta dem sign ceasefire to stop weeks of serious fighting wey don chase plenty people commot for dia houses. President Ahmed al-Sharaa say e go meet SDF oga, Mazloum Abdi, on Monday afta bad weather stop am from come meeting before. Even with ceasefire, tension never calm as shooting still dey […]

todayJanuary 19, 2026 9 15

Sports

FIFA Show New Trophy For First Women Club Champions Cup

By: Esther Ayoola FIFA Women’s club Champions Cup don take another big step as dem don finally unveil di new trophy for the competition. Say Dis trophy, say di winner of di FIFA first-ever global women club football tournament ni go lift. According to message wey FIFA post for dia X handle on Monday, di trophy unveiling happen for London. Dem show am give school pikins from one school near […]

todayJanuary 19, 2026 8

Sports

FIFA Presido Tuk Why AFCON Final Nor Sweet Am

By: Esther Ayoola FIFA Presido, Gianni Infantino don condemn some Senegal players, say why dem go waka comot from pitch on Sunday during AFCON final afta Morocco get penalty. Infantino tell sport reporter, say di behaviour of some supporters, players, and technical staff no make sense at sense and dat e nor show sportmanshi. U sabi say, Di incident happen as Senegal protest di referee decision, but Infantino  dey say, […]

todayJanuary 19, 2026 5

obodo oyinbo

Spain Train Crash Kpai At Least 39 As Rescue Continue

By: Esther Ayoola Say nor be small askident for spain, day Plenty pipo from Huelva, Cartaya, Lepe, and Aljaraque  ni dey miss ontop di mata dat on train crash. Jose Manuel Moreno wey dey in charge of Citizen Security for Huelva even tuk say, im never sti sabi how many pipo don kapi but according to report say at 39 Konfam dead so far as recue dey continue on Monday. […]

todayJanuary 19, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app