Blog horizontal

Background

OBODO NAIJA

INEC Warns Of AI Disinformation Ahead 2027 Election

INEC Warns AI-Generated Fake News Fit Undermine Nigeria’s 2027 General Elections INEC Chairman, Professor Joash Amupitan, give di warning on Wednesday for Abuja, during di 13th Annual International Conference of communication scholars and professionals. Amupitan, through INEC National Commissioner Sani Adam, say di commission dey audit im electoral technology systems and dey plan mock presidential election to test readiness for di 2027 polls. INEC say di measures important to identify […]

todaySeptember 3, 2026 12

OBODO NAIJA

Federal Workers Demand N300k Minimum Wage

By: Mariam Ajayi Na Federal Workers Forum write Presido Tinubu and National Assembly, ask make dem increase minimum wage from N70,000 to N300,000. Di group say N70,000 no fit meet workers’ needs because cost of living don high. Dem also want Level 17 officers to earn up to N1.5 million, while urging government to pay outstanding consequential adjustments. Di workers say dem need urgent action to prevent hunger and hardship.

todaySeptember 3, 2026 15

Lagos

Pensioners Protest Lagos Security Men Tear-Gas Dem

By: Mariam Ajayi Civil society groups don condemn Lagos Gornment over alleged tear-gassing of pensioners. Di elderly pensioners protest for Lagos Assembly, demanding payment of their outstanding pensions and gratuities. CSOs don call for investigation and accountability over di incident. Dem say e dey worrying say security operatives dey disrupt peaceful protests, especially when elderly people dey involved.  

todaySeptember 3, 2026 12

Lagos

Lagos Get 10 Private Hospitals For Every One Public Hospital

By: Mariam Ajayi Lagos Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, don reveal say private health facilities for Lagos outnumber public hospitals 10 to one. E say public hospitals still dey handle about 40 per cent of patient visits, putting serious pressure on dia facilities. Abayomi say dis pressure dey help informal health providers spread across di state. E say new task force go strengthen monitoring and protect patients for both public […]

todaySeptember 3, 2026 7

Lagos

Nigeria Start New TV Audience Measurement System for Lagos

Nigeria don start new system to measure how people dey watch television for Lagos, using special People Meters wey go record di channels and programmes viewers dey watch. Di initiative na joint project of NBC and ARCON, wey appoint First Media Entertainment Integrated Limited, FMEIL, in partnership with First Media Entertainment Integrated Limited to run di system and select panelists. Di FMEIL/GARB chairman, Rotimi Pedro, say di project don dey […]

todaySeptember 2, 2026 13

obodo oyinbo

Trump Want Make Dem Change Strait Of Hormuz Name

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don suggest make dem change di name of Strait of Hormuz to “Trump Strait.” Trump make di suggestion for im Truth Social page, saying America now dey control di waterway. He ask whether dem suppose rename di Strait of Hormuz after am, calling di proposed name “Trump Strait.” Trump even joke say, just like America, di new name go make di place “hotter” […]

todaySeptember 2, 2026 17

Sports

Aubameyang Tuk Say Gabon Football Palava Pass Him

By: Kofoworola Olayinka Gabon football don enter serious wahala after di country crash out of AFCON group stage following three straight defeats, with Ivory Coast giving dem di final blow. Gabon Presido Brice Clotaire Oligui Nguema describe di poor performance as a blow to di country’s national identity. Gorment later sack di coaching crew, suspend di national team and sideline veterans Pierre-Emerick Aubameyang and Bruno Ecuele Manga. Di decision spark […]

todaySeptember 2, 2026 13

Sports

Femi Azeez Join Brighton On Four-Year Deal

By: Kofoworola Olayinka Nigerian winger Femi Azeez don move from Millwall join Premier League side Brighton & Hove Albion on four-year contract. The 25-year-old winger impressed last season for Millwall, where e score 15 goals and provide 13 assists in 77 appearances. Azeez performance also earn am place for PFA and EFL Championship Teams of the Season. Brighton complete the deal after both clubs submit deal sheet before transfer deadline, […]

todaySeptember 2, 2026 22

obodo oyinbo

Germany Shut Russian Consulate Over Drone Palava

By: Mariam Ajayi German gofment don order make Russian Consulate General for Bonn close, following wetin dem describe as Russian “hybrid attack” involving drones around Leipzig Airport. Germany Foreign Minister Johann Wadephul announce di move alongside Interior Minister Alexander Dobrindt on Tuesday. Wadephul accuse Russia of trying to destabilise and intimidate Germany and other European countries through disinformation, threats, sabotage and aggression. He say Russia dey use disinformation, threats, sabotage […]

todaySeptember 2, 2026 7

Sports

PSG Reject Man City Bid For Super Falcons Star Echegini

By: Mariam Ajayi Paris Saint-Germain don reject several offers from Manchester City for Super Falcons midfielder Jennifer Echegini, as di French club no wan sell di Nigerian star. PSG see Echegini as important player, despite say na only one year remain for her contract. Di 25-year-old midfielder join PSG two years ago after one season with Juventus and she play key role for Nigeria WAFCON triumph. Echegini score di winning […]

todaySeptember 2, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds