Blog horizontal

Background

National

Senator Leader: New Tax Laws No Be To Worry Nigerians

By: Rilwan Agbomeji Senator Opeyemi Bamidele, wey be Leader of di Senate, don clear Nigerians to coolelecoolele say di new tax laws no be to make life hard for Nigerians. Bamidele yarn dis one for statement wey dem release for Abuja on Wednesday, as many people dey talk and complain about di new tax. Im talk say di law na for help people, boost di country money matter, and make […]

todayDecember 31, 2025 10

Uncategorized

Lagos CP Make Correct Move, Promote 35 Senior Police Officers

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Police Commissioner, CP Olohundare Jimoh, unto betterlicious doings don promote 35 senior officers to help make security for di state. Thirty superintendents don become chief superintendents of police (CSP), while five DSPs don become SPs Tuk tuk of di Lagos state police command, SP Abimbola Adebisi, clear tori pipo say, say di promotion show how di Inspector-general of police dey reward hard work and […]

todayDecember 31, 2025 12

National

NNPCL Show Report Card Of ₦502bn Profit For November

By: Rilwan Agbomeji Di Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPCL, say dem ma make ₦502 billion profit afta tax for November 2025, even though crude oil production drop small for di month. Figures from NNPCL Monthly Financial and Operations Report show say di company generate ₦4.36 trillion revenue, as beta gas output, full pipeline operation and steady fuel supply help balance di challenges for upstream production. Di report say crude […]

todayDecember 31, 2025 8

foreign

How Many Kontri Trump Bomb For 2025?

By: Rilwan Agbomeji US Presido Donald Trump don confirm say America strike one docking facility for Venezuela dis week. Trump yarn dis one for Florida as e meet Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu, say di attack na di first US military action for Venezuelan land for 2025. According to Trump, di place na where boats wey dem believe dey carry drugs dey load, and di strike cause big explosion for […]

todayDecember 31, 2025 8

National

Dem Promise Me ₦100,000 Make I Bomb Worshippers – Suspect

By: Rilwan Agbomeji One suspected Boko Haram suicide bomber, Ibrahim Mohammed, wey troops of Operation HADIM KAI catch with local hunters for Yobe, don yarn how dem recruit and send am go attack. Ibrahim talk say dem pay am ₦100,000 to carry out suicide bombing wey target worshippers for Maiduguri. Di guy admit say na im join di December 24 bomb attack for Gamboru Market Mosque. According to am, na […]

todayDecember 31, 2025 9

foreign

Putin Give First 2026 New Year Speech

By: Rilwan Agbomeji Russian Presido, Vladimir Putin, don knack hand for chest say Russia must win di war for Ukraine and call on im pipo make dem support soldiers. Im sukili dis one put for im New Year’s Eve speech for Kamchatka, di first region wey enter 2026 Im encourage im soldiers and and call on Russians to show support

todayDecember 31, 2025 11

National

Peter Obi Officially Japa To ADC For 2027 Elections

By: Rilwan Agbomeji Peter Obi, wey be Labour Party presidential candidate for 2023, don officially dump LP join African Democratic Congress, ADC. Obi yarn dis tori for Enugu on Wednesday, December 31, 2025, as coalition parties dey line up ahead of 2027 election. Di former Anambra State governor tuk say na Naija mata push am take change party. According to am, im move na how e wan take transform and […]

todayDecember 31, 2025 3

National

How House Of Rep Wan Protect Pikins From Jaguda Mama

By: Esther Ayoola House of Representatives don propose constitutional amendment to protect unborn pikin if im mama dey pregnant and dem sentence her to death, di move come after House Committee on Constitution Review, wey Deputy Speaker Benjamin Kalu dey lead, adopt di bill on Monday in Abuja. Di proposed change go add new subsection (1A) to Section 33(1) of 1999 Constitution, wey tuk say pregnant woman wey dey convicted […]

todayDecember 31, 2025 7

Sports

Michelle Alozie Hail FIFPro World XI Nomination As Big Honour

By: Esther Ayoola Super Falcons defender, Michelle Alozie, don troway salutation to her Nigerian teammates say her nomination for FIFPro World XI na big recognition of her hard work with Nigeria national team. According to sport aproko pipo, dem include Alozie among di 26 players wey make di 2025 FIFPro World XI nomination list for October. FIFPro World XI na di only global football award wey professional footballers themselves dey […]

todayDecember 31, 2025 4 2

obodo oyinbo

Mali, Burkina Faso Block Americans From Dia Country

By: Esther Ayoola Mali and Burkina Faso don place travel restriction on American citizens after di US put dem for no-entry list. Both countries’ foreign ministries tuk say di action na “equivalent measures,” as response to President Donald Trump decision to expand US travel ban reach almost 40 countries dis month. Di US list include Syria, Palestinian Authority passport holders, and some African countries like Niger, Sierra Leone and South […]

todayDecember 31, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app