Blog horizontal

Background

National

NASS Cut Break Short To Shift 2027 Presidential Election Date

By: Esther Ayoola National Assembly say dem wan cut short dia break and resume plenary on Tuesday, February 17, 2026, by 11am, dat important tuks dey to tuk for di 2027 election matas. Say, like dis Clerk to di National Assembly, Kamoru Ogunlana, don wire bulk SMS to all  senators and House of Representatives members make dem adjust dia timetable because of  di meeting on Tuesday. Konfam news Sources inside […]

todayFebruary 16, 2026 6

National

VP Shettima Arrange Bodi With FG Team To Visit Kano Fire Victims

By: Esther Ayoola Vice President Kashim Shettima go lead one Federal Gornment team go Kano afta fire burn Singa Market last weekend. Say, Di team dey go show di President sympathy to traders wey lose billions of naira for di fire. Among di team na Naija House Speaker, Tajudeen Abbas, Deputy Senate Presido, Barau Jibrin, Kawu Ismaila, and Abubakar Kabir Bichi wey be Chairman of House Committee on Appropriations.

todayFebruary 16, 2026 3

National

Peter Obi Call Nigerians To Join Hand To Rescue Naija

By: Esther Ayoola Di labour Parti presidential candidate for di 2023 elections, Peter Obi,  don put wait, dey  call on Nigerians like dis, to hellep join hand to rescue di country from many years of bad governance. Di former Anambra State govo, tuk dis tuk for Uyo during di OBIDIENT Conference as dem declare African Democratic Congress, say, na “Operation Rescue Nigeria”. Obi beg say, make everybody forget dia differences […]

todayFebruary 16, 2026 4

National

Oyo APC Make Move To Select Party Leaders Ahead Of Parti Congress

By: Esther Ayoola Stakeholders of All Progressives Congress for Oyo State don joinbodi agree say dem go use hand select dia new executive members for ward and local gornment levels wey go run party affairs for next four years. For statement wey State Publicity Secretary, Adewale Sadare, release for Ibadan on Sunday, e say dem go follow di guideline wey national leadership drop for di parti congress. Dem don fix […]

todayFebruary 16, 2026 4

National

OAU First Ladies Hail Oluremi Tinubu For Girl-Child Support

By: Esther Ayoola Naija First lady, Oluremi Tinubu don receive honour from Organization of African First Ladies for Development say, she ma try for girl-child education, hygiene, and health for mothers and childrensis for Naija. Dem give am di recognition for di 29th and 30th General Assembly for Addis Ababa, where dem also praise her effort to reduce mama and pikin death rate. In her acceptance, Di First Lady wey […]

todayFebruary 16, 2026 3

Lagos

Lagos Gorment Plan Move To Return Monthly Sanitation

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don announce say monthly sanitation exercise fit return to di state cause say di way di state tey dey smell nor be small. Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, tuk dis one afta im inspect Lagos Island on Sunday untop di dirty mata. Wahab tell tori pipo say, di gornment dey do everytin within dia power to bring back di exercise […]

todayFebruary 16, 2026 4

Uncategorized

Israeli Airstrike Kpai 12 Pipo – Gaza Civil Defence Yarn

By: Rilwan Agbomeji Israeli strike don kpai at least 12 pipo since early morning on Sunday, according to Gaza Civil Defence, as military official talk say dem respond to ceasefire violation. Even though US-brokered truce wey enter second phase last month still dey on paper, fight never stop for Gaza, as Israel and Hamas dey blame each oda for breaking agreement. Rescue team talk say one airstrike hit tent wey […]

todayFebruary 15, 2026 7

Sports

Barca Burst On Top Referee Magomago Afta 4-0 Beating

By: Rilwan Agbomeji Spanish champions Barcelona don write official complaint give Royal Spanish Football Federation over wetin dem call inconsistent refereeing. Di wahala start afta referee cancel one goal wey dem score for dia 4-0 Copa del Rey defeat against Atlético Madrid on Thursday. Barca send letter go both RFEF and di referees committee, Comité Técnico de Árbitros, demand more transparency and better standard. Dem talk say different decisions dey […]

todayFebruary 15, 2026 9

OBODO NAIJA

3 Pipo Kpai, Plenty Odas Wunjure As Ebonyi Mining Pit Collapse

By: Rilwan Agbomeji For Enyim Agalegu community, Ikwo LGA, Ebonyi State, one mining pit don collapse, kpai at least three pipo and wunjure many odas. National Chairman of Enyim Agalegu Edukwu Opeke Union, Oboke Chukwuma Collins, talk say im receive distress call around 4 p.m. on Saturday and rush go di scene. Im join community pipo help rescue, dey remove earth wey don trap miners. Di pit na one wey […]

todayFebruary 15, 2026 6

OBODO NAIJA

Fubara Impeachment Wahala – ALDRAP Storm Rivers High Court

By: Rilwan Agbomeji Association of Legislative Drafting and Advocacy Practitioners (ALDRAP) don carry serious marras go Rivers State High Court, beg make dem sharply stop Rivers State House of Assembly from continuing di impeachment wey dem start against Govnor Sim Fubara. For di suit wey dem file on February 10 with number RHC/427/CS/2026 through lawyer S. O. Abang, dem drag plenty big names join including di Attorney-General, Speaker Martins Amaehule, […]

todayFebruary 15, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app