Blog horizontal

Background

obodo oyinbo

Israeli Air Strike Kpai 13 for Southern Lebanon as Ceasefire Jam Rock

By : Jolayemi Olajide Israeli air strikes on Tuesday for southern Lebanon, don go kpai at least 13 pipo, as fighting between Israel and Hezbollah continue despite ceasefire attempt. Say  for Kfar Dounine, six pipo naim kpai and seven others wunjur after di strike hit one house and some areas. According to Lebanon state news agency, di attack happen as part of ongoing military exchanges. Later on Tuesday, two paramedics […]

todayMay 13, 2026 7

obodo oyinbo

Macron Konfam say  Hantavirus Dey Under Control for France  After di Outbreak

By : Jolayemi Olajide France Presido, Emmanuel Macron on Tuesday, for Nairobi, Kenya, don share update say,  French authorities dey handle  di hantavirus wey  spread for cruise ship wey dem call MV Hondius. According to Macron,  di French  gornment act fast by putting strict health protocols and emergency response measures in place after  di virus kpai, kpai three pipo. French health officials also konfam say one woman wey catch di […]

todayMay 13, 2026 8

Sport Yarns

Tinubu, CAF Boss Motsepe Meet for Kenya Summit to Discuss Nigerian Football

By : Jolayemi Olajide E belike beta dey come oh as Wi oga Presido Bola Tinubu and CAF Presido, Patrice Motsepe do small two aside for Nairobi Kenya, just after di Africa Forward Summit meeting on Tuesday. For di meeting, Nigeria Football Federation president Ibrahim Gusau, former NFF boss Amaju Pinnick and CAF acting secretary-general Samson Adamu also join Motsepe and Tinubu. According to Gusau, say dem discuss how dem […]

todayMay 13, 2026 11

Lagos

Governo Sanwo-Olu Hail LASU Say Dem Get Di Highest Registration For JAMB

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu don hail Lagos State University as di university with most application for Naija afta di school receive 84,426 applications for 2026 UTME. According to Joint Admissions and Matriculation Board figures, University of Lagos come second with 78,240 applicants, while Obafemi Awolowo University get 60,370 applications. University of Ibadan and University of Benin compete top five with 58,895 and 55,425 applicants respectively. Reacting […]

todayMay 13, 2026 12

Lagos

Obasa Enter Race For Agege Reps Seat As APC Primaries Near

By: Esther Ayoola Speaker of Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa don declare say e wan contest for Agege Federal Constituency seat for House of Reps. Obasa tuk dis one on Tuesday for Agege during stakeholders meeting wey hapun ahead of APC primaries for Lagos. Di sixth-term lawmaker press tuks say na party leaders for di constituency naim dey encourage am to enter di race for federal level. Dat […]

todayMay 13, 2026 11

Lagos

Lagos Set Eye On N4 Trillion Investment As “Invest In Lagos 3.0” Summit Kick Off

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment, say like dis, dem dey target about N4 trillion for local and foreign investment through di third edition of dia Invest in Lagos forum. Commissioner for Commerce, Cooperatives, Trade and Investment, Folashade Ambrose, naim tuk dis one for press briefing on Tuesday for Lagos. She say, di two-day summit go serve as major platform to attract investors, build partnerships and increase confidence for Lagos […]

todayMay 13, 2026 24

south west

Bandits Jaguda Storm Ogun Estate, Kidnap Three Family Members as Panic Hit Ijebu-Ode

By: Esther Ayoola Some Gunmen wey pipo suspect as bandits don go invade one residential estate for Ijebu-Ode area of Ogun State, carry three family members. Police tuk, tuk, Oluseyi Babaseyi, naim dey konfam dis incident to tori pipo on Tuesday. Reports tuk say about 15 armed men enter one Estate for Oke-Eri, enter di house, ransack am, before dem kidnap di victims. Di head of di family, Yesiru Badewa, […]

todayMay 13, 2026 9

National

Tinubu Call African Countries To Join Body To Grow Africa Economy

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don call for beta economic unity among African countries, say Africa, need policies wey go boost industrial growth Di Seniorman, Presido, tuk dis one on Tuesday for Nairobi, Kenya, during Africa Forward Summit wey hold for Kenyatta Convention Centre. Baba Seyi Scatta everywia, promising dat, Naija blue economy fit help push Africa development, normal, and dat di only tin be say […]

todayMay 13, 2026 7

National

Wike Clear Sabi Mehn And Womehn Why Dem Need Focus On Development

By: Esther Ayoola Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike don tell professional bodies, say make dem focus more on development, instead of always criticising gornment policies. Wike yarn dis one for Abuja as e receive members of the Body of Benchers led by chairmo, Albert Akpomudje, during courtesy visit for im Life Camp residence. According to am, true leadership no be by plenty media dragging, but di legacy projects and […]

todayMay 13, 2026 16

Sport Yarns

Team Nigeria Start Strong for Accra Athletics Grabbing  2 Medals for Opening Day

By : Jolayemi Olajide Team Naija dey represent wetin nor good for di  2026 African Senior Athletics Championship, for Accra, Ghana,  wining  two medals for opening day. Na for women discus event, Divine Oladipo wey dey do her first international outing for Nigeria carry silver medal. Another athlete, Obiageri Amaechi, also add to di success as she win bronze medal for di same event. Team Nigeria dey expect more medals […]

todayMay 13, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds