Blog horizontal

Background

National

Ondo Gorment Campaign Against Political Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Ondo State Gornment don raise alarm, condemn as some pipo dey tear political campaign materials across di state. Senior Special Assistant to di Governor on Signage & Advertisement, Yomi Oyekan, tuk dis on Monday say some political actors dey destroy rival candidates materials on purpose. Di Ondo Gornment dey say na serious crime wey dey threaten democracy and fair competition, and dem get intelligence on those wey […]

todayMarch 30, 2026 2

National

Court Stop Turaki PDP Faction, Order Protection For Wike People

By: Esther Ayoola Di Federal High Court (FHC) for Abuja, on Monday, don ban di Kabiru Turaki-led PDP leaders from enter di party national secretariat. Justice Joyce Abdulmalik, wey deliver di judgment, tuk say like dis now di Wike-led faction of di party go get protection from police, DSS, and other security agents while dem dey access di secretariat. She also say di convention wey Turaki faction hold for Ibadan […]

todayMarch 30, 2026 3

Sports

Premier League Fans Vote Against VAR Say E Dey Spoil Football

By: Esther Ayoola Say like dis now, Plenty fans wey dey support Premier League clubs dey complain say VAR don spoil dia matchday enjoyment. Dis na according to one survey wey Football Supporters’ Association (FSA) do on Monday across England. Di survey, wey collect response from almost 8,000 fans from all 20 Premier League clubs, show say over 90% of dem believe VAR don make stadium experience worse. Say about […]

todayMarch 30, 2026 4

National

INEC Recognise Wike Camp, Publish New PDP Leaders For Website

By: Esther Ayoola Say like dis INEC don recognise di faction of PDP National Working Committee wey Nyesom Wike dey support, and dem show am for dia website on Monday for Abuja. According to di electoral body, dis move na to update Nigerians on di korrect leadership of Pipos Democratic Parti afta di party convention. Dem list Abdulrahman Mohammed as National Chairman and Samuel Anyanwu as National Secretary, plus oda […]

todayMarch 30, 2026 3 2

National

Atiku Reject Fake News, Say E Never Comot For Politics

By: Esther Ayoola Former Vice Presido Atiku Abubakar don raise alarm, say haters dey drag am wetin nor good which be say im don retire from politics For statement wey im media aide Paul Ibe drop for X on Monday, Atiku say di rumor wey dey spread for social media say im comot politics, say na big lie Di senior man say im mout di African Democratic Congress progress for […]

todayMarch 30, 2026 3

National

NNPP to Join Hand With ADC For 2027 Election

By: Esther Ayoola Di New Naija Peoples Party (NNPP) don declare say dem go form collabo with African Democratic Congress (ADC) for 2027 presidential election. Dis na according to a statement by di NNPP National, tuk tuk person, Ladipo Johnson, on Monday. Johnson say even though Rabiu Kwankwaso, former NNPP 2023 presidential candidate, don leave di party join ADC, NNPP  go sti contest di  elections. Say however, for presidential level, […]

todayMarch 30, 2026 4

National

Plateau Gorment Put 48-Hour Curfew For Jos North Following Jaguda Boys Attack

By: Esther Ayoola Plateau State Gornment don impose 48-hour curfew for Jos North LGA afta Sunday attack for Angwan Rukuba wey kpai plenty pipo and wunjure odas. Commissioner for Information, Rt. Hon. Joyce Lohya Ramnap naim announce am, say di curfew start from yesterday midnight March 29 and e go reach April 1, 2026. For reaction, Governor Caleb Manasseh Mutfwang condemn di attack as “barbaric and unprovoked” and assure say […]

todayMarch 30, 2026 5

obodo oyinbo

Russia Kick UK Diplomat Say Im Dey Spy On Russia

By: Esther Ayoola Russia don order British diplomat Albertus Gerhardus Janse Van Rensburg to leave Moscow afta dem accuse am say e dey do spy work According to FSB security service report on Monday, di 29-year-old embassy secretary dey accused of “subversive intelligence activities wey fit threaten Russia security,”. Russian foreign ministry tuk say dem don call Britain charge d’affaires come warn dem wella dat if dem do dem wetin […]

todayMarch 30, 2026 3

Sports

Tristan Xerri Chop 3-Match Ban Afta E Rub Nose Blood For Oda Player Face

By: Esther Ayoola North Melbourne player Tristan Xerri don collect three-match ban afta e use im nose blood rub Andy McGrath face for match wey dem play on Saturday. Di incident hapun afta Xerri score goal, come get small fight with McGrath before e wipe di blood, something wey officials call “disgraceful behaviour.” For tribunal, Xerri tuk say dem insult am call am “weak c-word,” naim make e lose im […]

todayMarch 30, 2026 2

Sports

Spurs Set Eye For Roberto De Zerbi After Igor Tudor Sack

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don begin chase for Roberto De Zerbi to become dia new coach afta dem sack Igor Tudor. Tudor stay for only 44 days before bad results push di club close to relegation zone for Premier League. Reports say De Zerbi, wey don leave Olympique de Marseille since February, don show interest to take di job immediately. Inside Tottenham Hotspur camp now, dem believe say e […]

todayMarch 30, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app