Blog horizontal

Background

Lagos

Sanwo-Olu Appoint Dr Hassan Sanuth As Di New LAWMA Oga

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu, don appoint Dr Hassan Sanuth as new Managing Director of LAWMA, as reports say e don tell di former oga, Dr Muyiwa Gbadegesin, make e comot from seat because of di dirty wey gather for different parts of Lagos. Di matter follow complains  about plenty dirty wey dey block road, residential areas and gutters and canals, even after gornment don give order to clear dem, […]

todayOctober 20, 2026 11

OBODO NAIJA

Breaking News: DSS Drag Five Suspects Go Court On Top 20 NYSC Members Kidnap

Di Department of State Services, DSS, don gbab five suspects wey dem accuse say dem get hand for di kidnapping of 20 prospective NYSC members for Imo State. Security operatives arrest di five suspects for intelligence-led operations wey dem carry out between October 10 and 14 for Rivers and Abia States. Di case concern di abduction of 20 prospective corps members, while details of wetin happen and di suspects’ roles […]

todayOctober 20, 2026 11

Sports

Ronaldo Collobi 30 Days Ban

Football superstar, Cristiano Ronaldo, don collect 30 days suspension plus €255 fine from Portugal Football Federation over im waka comot from Portugal national team camp. Di federation tok on Monday say di punishment dey okay and e don accept say Ronaldo admit wetin dem accuse am of doing for formal statement wey e submit on Friday. Di federation explain say Ronaldo confession and clean disciplinary record help reduce di punishment, […]

todayOctober 20, 2026 9

OBODO NAIJA

Peter Obi Mourn Former Delta Govo, Uduaghan

Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, Peter Obi, don mourn former Delta State Govo, Dr Emmanuel Eweta Uduaghan, wey kpai, as e describe am as elder brother wey dem get good working relationship. Obi tok say e dey deeply sad over di death of di former Govo, as e remember how Uduaghan treat am like im younger brother anytime wey dem meet. E also remember how dem work together when […]

todayOctober 20, 2026 10

Sports

Lookman, Nwachukwu, Osimhen Wan Scatter Europe Dis Week

Ademola Lookman and Christian Nwachukwu dey enter Champions League action today as Nigerian players return to de biggest club competition for Europe. Lookman’s Atletico Madrid go play against Stuttgart for Germany by 8pm Nigerian time, while Nwachukwu’s Sabah host Borussia Dortmund for Baku by 5:45pm. Victor Osimhen go take de spotlight on Wednesday for im own match, but LASK winger Moses Usor still dey doubt to play. Sabah dey find […]

todayOctober 20, 2026 9

obodo oyinbo

Drone Attack For Sudan Kpai 100 Pipu

More than 100 pipu naim don kpai since Sunday as drone attacks hit Sudan capital, Khartoum, and two areas for di west wey paramilitary forces control. Say di wickedest of dem all hapun Sunday evening near market for Al-Dibab town, West Kordofan State, wey Rapid Support Forces, RSF, control, dem don dey gbege di  Sudan military since April 2023. According by one resident, Ahmed Abakar Wadi,  wey help bury di […]

todayOctober 20, 2026 13

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Say E No Regret Fuel Subsidy Removal

Wi oga Presido Bola Tinubu don drop in mouth odour again scata table, say hin nor get any regret say e remove fuel subsidy, and Nigeria no go ever go back to am again. E say any attempt to bring fuel subsidy back to like asking biblical Moses make e turn back go Egypt. Tinubu porporly dis one for Abuja during one evening meeting with di city boys movement to […]

todayOctober 20, 2026 9

Lagos

Lagos APC Members Ready To Put Body For Tinubu and Hamzat

National Chairmo of APC, Prof. Nentawe Yilwatda, Lagos party Chairmo, Cornelius Ojelabi, and baba Govo, Babajide Sanwo-Olu don tell all Lagos APC members make dem deliver di state for Presido Bola Tinubu for 2027. Dem make dis strong call on Monday for Eko Hotel and Suites inside Lagos during one special one-day retreat for party leaders and senior members of de PBAT-KOH Campaign Council. Di party leaders drag di matter […]

todayOctober 20, 2026 9

Lagos

Lagos Taskforce Gbab Former Member For Oshodi

Lagos State Taskforce don arrest one dismissed officer, Yahaya Salami, wey dem also dey call Adams, for impersonation and extortion around Oshodi Bus Stop. Dem catch Salami on Saturday after im try drag with Taskforce officers wey call am for questioning. Dis arrest dey come after one video go viral for social media showing how officers take forcibly hold di suspect down, which make people dey tok online. Inside statement […]

todayOctober 19, 2026 11 2

obodo oyinbo

America No Warn Us Before Russia Bomb Our Tins – Zelensky 

Presido Volodymyr Zelensky don tok say Ukraine allies no give dem any early warning before Russia launch ballistic missiles touch dem energy facilities for Kyiv region. Zelensky reveal say Russia fire 16 ballistic missiles and over 200 drones go different parts of di country overnight, which make loud explosions sound across di capital. Dis attack dey come just one week after Ukraine tok say US no give dem heads-up for […]

todayOctober 19, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds