Blog horizontal

Background

Lagos

Customs Gbab 20 Sacks Of Cannabis Worth ₦157.8M For Lagos Waterway

By: Rilwan Agbomeji Di Western Marine Command Ibafo Lagos don show working again oh, say  dem catch 20 sacks of Cannabis Indica wey worth ₦157.8 million for waterway. According to reports, Customs officers no gree make smugglers waka free, dat dem sabi di hiding place well well. Untop undate doings with tori pipo on Wednesday, Area Controller of Customs, Western Marine Command, Comptroller Patrick Ntadi , sha praise im team […]

todayJanuary 15, 2026 6

Lagos

TCN Call Lagos Govment Make Dem Join Hand Protect Power Infrastructure

By: Rilwan Agbomeji Di Transmission Company of Nigeria don wire call for stronger join bodi doings with Lagos State Govment to protect important power facilities as di city dey expand fast. Di call come from TCN Lagos Regional Transmission Manager, Mojeed Akintola, during a courtesy visit by di company management to Lagos State Planning and Environmental Monitoring Authority. Akintola talk say encroachment for transmission line right-of-way fit cause serious wahala […]

todayJanuary 15, 2026 7 1

Sports

Naija Fans Bash Ghana Referee Afta Eagles Lose Penarity

By: Rilwan Agbomeji Naija football fans don vex uptop wetin play for Morroco yesterday, dey accuse Ghanaian referee, Daniel Laryea, say im officiating wey favour Morocco for no make Super Eagles loss dia semi-final match on Wednesday night. Super Eagles lose 4–2 on penalties afta Chukwueze and Onyemaechi miss dia spot kicks, as di match end goalless afta extra time for Rabat. Fans tuk say refereeing no balance at all, […]

todayJanuary 15, 2026 25 13

Sports

FG Ginger Super Eagles Ahead Big AFCON Semi-Final Clash With Morocco

By: Esther Ayoola Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, ni go ginger wi Super Eagles, say make dem stay focused and confident as dem prepare to face Morocco for AFCON semi-final by 9pm. For statement wey e post for im X handle on Wednesday, di minister encourage di team and assure dem say Nigerians for home and abroad dey fully behind dem. Idris tuk say di whole country […]

todayJanuary 14, 2026 11 39 7

obodo oyinbo

Iran Go Fast Track Trials Afta Trump Threat

By: Esther Ayoola Iran gornment vow to fast-track trial for people wey dem arrest during big protests, Iranian Judiciary Chief Gholamhossein Mohseni Ejei tuk on Wednesday. Di promise come afta US President Donald Trump warn say dem go face “very strong action” if Iran go ahead with hangings. Rights groups say crackdown fit don kill thousands as protesters challenge Iran clerical leadership, but government insist dem don regain control. Ejei […]

todayJanuary 14, 2026 7

National

ASUU Cry Out Over Money Mismanagement For Naija

By: Esther Ayoola Di Academic Staff Union of Universities, ASUU, don open tuks on why Najia schools dey suffer, say na mismanagement of funds and weak governance for some universities across di country be di problem ASUU President, Professor Chris Pinuwa, tuk dis one for Abuja during di unveiling of di 2025 agreement between Federal Government and di union on Wednesday. Pinuwa warn say di problem dey affect accountability, stability […]

todayJanuary 14, 2026 10

south west

Victims Point Out Alleged Owo Church Attackers For Court

By: Esther Ayoola Say Two more prosecution witnesses don tuk wetin dia eyes see ri for court on Tuesday about the June 5, 2022 terrorist attack for St Francis Xavier Catholic Church for Owo, Ondo State, as Federal High Court for Abuja collect more exhibits from DSS. DSS dey prosecute five suspects wey include Idris Omeiza, Al Qasim Idris, Jamiu Abdulmalik, Abdulhaleem Idris and Momoh Otuho Abubakar over nine terrorism […]

todayJanuary 14, 2026 6

National

Ekpoma Experience Peace After Anti Kidnaping Protest

By: Esther Ayoola Edo State Commissioner for Education, Paddy Iyamu, say, everywhere don calm down for Ekpoma after di plenty wahala wey follow anti-kidnapping protest for di area. U sabi say, news bin report dat,  police arrest some Ambrose Alli University students during di protest. Na ontop TV sit don tuk, Iyamu yarn dis one on Wednesday dat indeed normalcy don return to Ekpoma

todayJanuary 14, 2026 6

Lagos

Lagos Gorment Explain How Hypertension Dey Kpai Lagosians

By: Esther Ayoola Nor be small tin oh, Data from Lagos State Ministry of Health dey show say, about six million residents dey live with hypertension, but most of dem no sabi say dem get di sickness. Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, tuk dis one yesterday for leadership tuk, tuk, wey Lagos State Primary Health Care Board organize with partners like Nigeria Health Watch. Di mata gather top gornment officials, […]

todayJanuary 14, 2026 8 1

obodo oyinbo

France Wan Open Emergency Mata House For Greenland February

By: Esther Ayoola Say, France wan open emergency mata house, wetin oyibo dey call consulate for Greenland on February 6, 2026. French Foreign Minister Jean-Noel Barrot tuk on Wednesday, say, di move na beta political move based on say Greenland dey strategic. Dis one dey come following US Presido, Donald Trump don bin yarn, dat im wan seize di island. Say infact, Denmark top diplomat dey meet US officials for […]

todayJanuary 14, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app