Blog horizontal

Background

Lagos

Court Nab Man Wey Try Export Cocaine, Igbo From Lagos

By: Rilwan Agbomeji Federal High Court for Lagos don order make dem dump one man, Uche Ezeh for Ikoyi Correctional Centre afta e confess say e try export 4.40kg cocaine and 11.50kg cannabis. Judge talk say e go siddon till December 12, 2025, until dem open di full gist, check all di facts, and drop final judgment for im head. NDLEA drag am for four-count charge, FHC/L/30/2025, and arraign am […]

todayDecember 4, 2025 12

Lagos

One Person Kpai As Jaguda Boiz Scatter Ground For Lagos

By: Rilwan Agbomeji At least one person don kpai afta heavy fight burst between suspected Aiye and Eiye cult members for Awoyaya, Ibeju-Lekki, Lagos. Di fight burst from Monday enter Tuesday, and before people know wetin dey sup, one guy wey dem sabi as Pelebe don kpai inside di cult gbege. Videos just dey show show bodi online how di wahala, take scatter pipo for Awoyaya . Di video show […]

todayDecember 4, 2025 7

Lagos

Temu Join Body With Dellyman To Run Deliveries Sharp-Sharp Across Naija

By: Rilwan Agbomeji Temu, di fast-growing global e-commerce giant, don link up with Lagos-based startup Dellyman to run deliveries across Naija, dey ready shake di whole market wella. Dis move follow afta Dellyman pilot run wey dem deliver over 1,300 packages with 95% success, show say dem fit handle heavy e-commerce gbege for anywhere for Obodo Naija. Since 2020, Dellyman don turn one of Naija most reliable same-day and last-mile […]

todayDecember 4, 2025 7

Sports

Why We Scatter Chelsea 3-1 – Leeds Oga Daniel Farke

By: Rilwan Agbomeji Leeds United oga, Daniel Farke yarn say dem jam Chelsea 3-1 Wednesday night because im players really carry fire put show, run dem blues all over for dia house, no gree give dem chance to breathe. Farke dey shine eye as Ao Tanaka, Jaka Bijol, and Dominic Calvert-Lewin burst goals wey scatter Chelsea defense, carry Leeds run riot for Elland Road. We dey mad hungry to carry […]

todayDecember 4, 2025 12

National

Suspects Don Yarn Reason Why They Kpai Ogun FRSC Officer And Her Pikin

By: Rilwan Agbomeji Osun State police command don kramp one jaguda boi, victor fajemirokun wey kpai im girl friend, wey be Federal Road Safety Corps officer, Lasisi Funmilayo and her pikin, Sewa Lasisi. According to reports, di police parade di forty years old business man alongside two babalawo wey dia name be, Gboyega Daramola and Sunday James, for Osun State Police HQ, Osogbo on Wednesday. Oga Victor open im mouth […]

todayDecember 4, 2025 6

National

Senate Wan Tag Kidnaping As Terror Work

By: Rilwan Agbomeji For Wednesday for Abuja, We Senate don run mata again katapot change for di 2022 Terrorism Act  say, moving forward, any jaguda  wey do kinaping, whether na money take support oh, or na u spiderman wey  give informate, or ur work na to hide victim, any how any how so far u dey involve say na death penarity now ooo. Di bill show bodi for di house […]

todayDecember 4, 2025 10

Business

Nigeria Don Become AFRIPERF Headquarters

By: Rilwan Agbomeji Di African Petroleum Regulators Forum don give Nigeria big promotion as dem pick di country as official headquarters, and elect NUPRC oga, Engr. Gbenga Komolafe, as di new Chairman. Di announcement land during dia first executive meeting wey dem hold online on December 2, 2025.Plus, NUPRC senior official Eyoanwan Ndiyo-Aiyetan don also climb go top as secretary of di Forum.

todayDecember 3, 2025 14

obodo oyinbo

Somalis No Suppose Dey US – Trump

By: Rilwan Agbomeji US President, Donald Trump don scatter ground for White House cabinet meeting for Tuesday as e burst out say e no want Somali immigrants for America at all, even rub insult on top Somalia head, yarn say di country “barely dey” and people for there just run up and down  dey kpai dia sef. Na dis same time US immigration officials dey cook one heavy raid wey […]

todayDecember 3, 2025 20

Sports

Make Fulham Forget Man City Beating — Iwobi

By: Rilwan Agbomeji Fulham winger, Alex Iwobi don fire up im boys afta dem loose 5-4 giv Manchester City for dia own house for Tuesday. Fulham Boys no come sell groundnut ooo as dem match City fire-for-fire, push dem sotay e remain small make dem thief one point comot Pep hand. Na Iwobi even light di fire as e tear net with one mad goal afta second half pass small, […]

todayDecember 3, 2025 9

Entertainment

2Baba Eye Comot Water As Marriage Gbege Grip Am For Neck

By: Rilwan Agbomeji Na wah oh! Nigerian music star, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba, don finally  open mouth talk wetin dey im mind for first time since di hot gbege with im wife, Natasha Osawaru burst everywhere for internet. For im IG tori on Wednesday, 2Baba tok say e need help, omo di message short but e carry weight wey hit body like trailer. E no finish there […]

todayDecember 3, 2025 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app