Blog masonry

Background

National

Chief Of Army Staff Promise Say Army Go Do All E Fit Do To Stop Terrorist Wahala

By: Esther Ayoola Chief of Army Staff, Lt.-Gen. Waidi Shaibu, don drop update say Naija  Army go do everything wey human fit do to stop di plenty terrorist attacks for Niger State and other parts of di country. E tuk dis one dis week for Minna, Niger State, during di opening of di 2026 Doctrine and Training Conference for Army Doctrine and Training Command. According to am, di Army dey fully ready to carry out di order wey President Bola […]

todayJanuary 7, 2026 15

National

BREAKING: Court Giv Malami ₦500 Million Bail Con Sti Tell Am Make E Nor Travel

By: Esther Ayoola Justice Emeka Nwite of Federal High Court for Abuja don grant former Attorney General, Abubakar Malami, bail of ₦500 million with two sureties. Di make di judgement on Wednesday say di sureties must get landed property for Asokoro, Maitama or Gwarinpa, and dem go submit dia travel documents to di court. Court also order make Malami drop im international passport and no comot Nigeria without court permission. Both Malami and im sureties must submit recent passport photographs, […]

todayJanuary 7, 2026 14

Lagos

Lagos Court Jail Man 6 Months Say Im Sell Marijuana

By: Esther Ayoola A Federal High Court for Lagos don convict 35-year-old man, Deji Adesanya, dey sentence am to six months jail say im dey sell hard drugs, cannabis sativa, wey mehn dey call marijuana. Justice Akintayo Aluko give di sentence afta Adesanya confess by imself say im dey guilty for di one-count charge wey NDLEA carry come court. NDLEA tuk say dem catch am on November 22, 2025, for Safecourt Apartment, Ikate–Elegushi, Lagos with five kilogramof di drug. Di […]

todayJanuary 7, 2026 5

National

Police Confamate Release of Six Vigilantes Wey Army Arrest For Edo

By: Esther Ayoola Kwara State Police Command show workings confamate say dem don receive and later release six vigilante members wey Nigerian Army arrest earlier for Edo State. Police tuk say soldiers stop di vigilantes for Auchi–Ikpeshi Road for Akoko-Edo LGA for early December 2025 as dem dey travel inside motor wey belong to Ifelodun Local Government for Kwara State. According to police statement wey come out on Tuesday 6th Jan, 2026, di Army hand over di six men to […]

todayJanuary 7, 2026 10

National

Atiku No Go Step Down, Drag Tinubu

By: Esther Ayoola Former Vice Presido Atiku Abubakar don tuk say e no go step down for African Democratic Congress (ADC) presidential race. E still accuse President Bola Tinubu say dey try put hand for opposition matter. Atiku, through im media adviser Paul Ibe, call Nigerians make dem no allow All Progressives Congress (APC) scare or weaken opposition. Dis tuk come as people dey speculate say Atiku dey under pressure to make way for southern candidate to carry ADC flag […]

todayJanuary 7, 2026 18

National

NiMET Share Update Say Haze, Sun And Thunder Go Hit Nigeria This Week

By: Esther Ayoola Di Nigerian Meteorological Agency (NiMet) don yarn say from Wednesday reach Friday, plenty haze and sunshine go dey across Nigeria. NiMet tuk dis on Tuesday for Abuja. For north, sky go dey sunny and hazy every day, while for south, sky go dey sunny with small clouds. NIMet also tuk say small chances of thunderstorm and light rain fit happen for Bayelsa, Rivers, Akwa Ibom, and Cross River later for di day. Dem explain say dis kain […]

todayJanuary 7, 2026 4

National

FG Sukili N1.98tn For Electricity Subsidy

By: Esther Ayoola Based on wetin di Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) report tuk, di Federal Government don spend N1.98tn for electricity subsidy from October 2024 reach September 2025. For di fourth quarter of 2024, dem spend N471.69bn, first quarter of 2025 na N536.4bn, second quarter N514.35bn, and third quarter N458.75bn. NERC tuk say dis subsidy na because electricity tariffs never reach cost-reflective level, so gornment gatz cover di gap. Dem still warn say if tariffs no balance, government go […]

todayJanuary 7, 2026 4

Lagos

Lagos Taskforce Arrest 32 ‘Omotaku’ Weh Dey Block Roads

By: Esther Ayoola Lagos State Taskforce don arrest 32 street children wey dem dey call Omotaku, say dem dey cause wahala for area, dey block road across Island and Mainland, for areas like Apongbon, Fadeyi, Jibowu, Yaba, Lagos Island, Ojuelegba, and Surulere, According to Taskforce tuk, tuk yarnings on Tuesday, Raheem Gbadeyan, dem catch di children because dem dey stop trucks, tankers, and private cars anyhow, dey smoke hard drugs, and dey disturb people. Say, di operation hapun as part […]

todayJanuary 7, 2026 13

Lagos

Family Set Jan 14 Burial Date to Bury Three Broders Wey Kpai for the GNI Fire

By Ebi Oboko Unto updates for lagos fire accident marras, say three Omatu brothers wey kpai for di fire wey burn Great Nigeria Insurance House for Lagos Island, say dem go bury dem on January 14. Na As dem sister, Mimi Nonyerem, tuk dis week, dem go do service of songs on January 7, while burial go happen on January 14. U sabi say, Di fire start from fourth floor come spread reach sixth floor before e take over di […]

todayJanuary 7, 2026 10 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app