By Ebi Oboko
Unto updates for lagos fire accident marras, say three Omatu brothers wey kpai for di fire wey burn Great Nigeria Insurance House for Lagos Island, say dem go bury dem on January 14.
Na As dem sister, Mimi Nonyerem, tuk dis week, dem go do service of songs on January 7, while burial go happen on January 14.
U sabi say, Di fire start from fourth floor come spread reach sixth floor before e take over di whole 25-storey building and nearby houses.
One part of di building wey be like seven floors later fall down, trap traders and market helpers.
Di Omatu family na one of di families wey di incident hit well-well, Di three brothers wey die na Steve (40), Casmir (39) and Collins (37).
Only, One of di broda, Camillus Omatu, manage escape alive.