Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Govt Drag Over 100 Road Median Traders Go Court

Lagos State Government don drag more dan 100 pipo go court within di last one year for selling on road medians and breaking environmental laws. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn dis one on Wednesday as e supervise operation to flush out illegal traders from di Okokomaiko to Orile road median. According to di government, di operation na to clear di road once and for all so work fit continue for Lagos Rail Mass Transit project, and […]

todayJuly 2, 2026 14

obodo oyinbo

Portugal Enter Emergency Mode As Heatwave Worsen

Portugal weather agency, wey dem dey call IPMA, don put  Lisbon and Setubal regions for red alert on Thursday because of dangerous heatwave wey dey spread across di kontri, while Leiria and Coimbra go join di alert on Friday. IPMA tok say temperature fit reach 44 degrees Celsius for some northern areas, while Evora and three oda inland regions don already enter orange alert on Wednesday as Europe dey battle one of di worst heatwaves in recent years. Di agency […]

todayJuly 2, 2026 18

OBODO NAIJA

Obasanjo Warn Say Make Nigeria No Allow Civil War Again

Former President Olusegun Obasanjo don warn say plenty of di things wey cause Nigeria Civil War for 1967 still dey ground, and everybody must join hand make dat kind wahala no happen again. Obasanjo tok dis one on Wednesday as e receive book, research materials, videos and interviews about di Asaba Massacre from Chief Chuck Nduka-Eze for di Olusegun Obasanjo Presidential Library, Abeokuta. E praise Nduka-Eze for keeping di history alive, say if people know wetin happen before, dem go […]

todayJuly 2, 2026 21

Lagos

RESIDENTS CRY OUT AFTER FLOOD CHOP THEM

Residents for Gbagada area dey lament serious hardship as persistent flood don scatter dia house and market and people no fit comot go hustle. Many families don raise alarm say dem no dey safe again, especially wen rain start, because dem dey fear for di lives of dia children. Di people don beg government to come fix di bad roads and clear all di blocked drainage channels so dat water go fit pass well.  

todayJuly 2, 2026 14

Lagos

NPA Set Up Task Force To Fight Port Traffic For Lagos

Di Nigerian Ports Authority (NPA) don launch join bodi task force to tackle di traffic for Lagos port access roads. NPA tok say dem take dis step after Managing Director, Dr. Abubakar Dantsoho, hold meeting with security agencies, truck operators, freight forwarders and Lagos State Government officials to find lasting solution to di problem. According to NPA General Manager for Corporate and Strategic Communications, Ikechukwu Onyemekara, illegal checkpoints, double work by some security agencies and other operational problems na dey […]

todayJuly 2, 2026 18

Sports

Belgium Shock Senegal with Late Comeback, Knock Senegal Comot 3-2

Nor be small drama, as Belgium complete one big comeback after beating Senegal 3-2 for extra time inside World Cup last-32 match wey happen for Seattle on Wednesday. Senegal bin dey lead 2-0 through Habib Diarra and Ismaila Sarr, but Romelu Lukaku and Youri Tielemans score late goals for di last four minutes to force extra time. For di 125th minute, VAR confirm penalty after Lamine Camara foul Tielemans, and di Belgian midfielder coolly score di winning goal to send […]

todayJuly 2, 2026 34 2

Economics

FG Promise To Tighten Security For Niger Delta To Push Oil Production Up

By : Jolayemi Olajide Di Federal Gornment don tuk am again say dem dey ready to wire security for Niger Delta so that Nigeria fit start to drill more crude oil. Di Minister of Defence, Christopher Musa, tuk dis one after one closed-door meeting with big stakeholders inside di oil and gas sector for Port Harcourt Barracks, Rivers State. Musa tell journalists say things like sea piracy and armed robbery don really go down for di region, but di Armed […]

todayJuly 1, 2026 21

OBODO NAIJA

NDC  Upload Peter Obi Name As Dia Presidential Candidate for 2027

By : Jolayemi Olajide Unto election 2027 waka, say di breeze don blow reach di Nigeria Democratic Congress (NDC),  like dis,  dem  don successfully upload di papers of dia presidential candidate,  Peter Obi, enter di INEC portal. Di National Leader of di party, Sen. Seriake Dickson, break di news for im 'X' handle and explain say everything dey waka uniform with di INEC timetable. Dickson tuk say di name of di vice-presidential candidate go land on top di portal as […]

todayJuly 1, 2026 9

obodo oyinbo

Cholera Kpai 120 pipo for Sudan

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin say one wicked  cholera outbreak don scarra  Sudan,   kpai  120 pipo, and dem sti dey suspect  1,102  cases. The World Health Organization (WHO) tuk say di three years war between the Sudan army and the RSF fighter group don scatter the country healthcare system kpata-kpata. Dis na di third time wey cholera heavy wave dey hit Sudan back-to-back inside three years, just two months after dem think say the last one don […]

todayJuly 1, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds