Blog masonry

Background

Sports

Everywhere Choke As 2026 FIFA World Cup Round of 16 Dey Near

As e be like dis, na only 10 countries don already secure dia place for 2026 FIFA World Cup Round of 16, as di battle for di trophy dey hot. Di latest teams wey qualify na USA, England and Belgium as dem beat dia opponents yesterday. Di other teams wey don book dia tickets to di last 16 na France, Brazil, Norway, Morocco, Paraguay, Canada and Mexico. And later dis evening Spain and Austria go later run matters by 8pm.

todayJuly 2, 2026 18

obodo oyinbo

Gaza Mark 1,000 Days Of War Wahala As Over 73,000 Pipo Kpai

Gaza officials don announce say di war don clock 1,000 days, as over 90 percent of di territory don suffer serious damage from di fighting. Di Gaza Gornment Media Office talk on Thursday say Israeli forces now control about 80 percent of Gaza land. According to di latest figures from Gaza, at least 73,066 Palestinians don die since di war begin for October 2023. As di war continue, international organizations dey raise fresh alarm over di collapse of hospitals, roads, […]

todayJuly 2, 2026 16

OBODO NAIJA

FG Announce Big NYSC Reform Say Adire Go Replace Khaki Uniform

Federal Gornment don announce say dem dey plan for major changes for NYSC programme, and one of dia plan na to replace di traditional khaki uniform with locally made Adire material to support Naija economy. Na Minister of Youth Development, Ayodele Olawande, announce dis one for TV siddon tuk on Thursday, He tuk say di reform go ensure say corpers go receive postings wey match dia course of study. E sti add say Federal Government go put corpers for areas […]

todayJuly 2, 2026 32

Lagos

LASEMA Yarn Say No Building Collapse For Alakija

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don officially clear bad air wey dey spread for social media say one building collapse for Alakija area. LASEMA Permanent Secretary, Dr. Olufemi Oke-Osanyintolu, konfamate dis for statement on Thursday say di report na lie and e dey mislead di public. Officials wey dem send to check di area after di news show face no find any evidence of any building collapse for dat location at all at all. Di agency come warn […]

todayJuly 2, 2026 13

Lagos

Gbadebo Rhodes-Vivour Dey Prepare For 2027 Lagos Governorship Race

Gbadebo Rhodes-Vivour of di African Democratic Congress (ADC) don clear say him 2027 Lagos governorship ambition no depend on Peter Obi or di Obidient movement. Di politician tok dis one for one siddon tuk on Thursday, as e emphasize say e don dey build strong structure for grassroots communities. Rhodes-Vivour explain say e don work hard to connect with Lagos residents wey dey face challenges like demolition, and e believe say dis effort don position am well for di coming […]

todayJuly 2, 2026 22

Sports

Pape Gueye Retire From International Football

Senegal midfielder, Pape Gueye, don announce say e no go play for Senegal national team again as long as head coach, Pape Thiaw, still dey in charge. Di 27-year-old make di announcement for social media after Senegal blow two-goal lead come lose 3-2 to Belgium after extra time for dia 2026 FIFA World Cup Round of 16 match. For di post wey e write for French, Gueye tok say e go later tok about how Senegal take crash out of […]

todayJuly 2, 2026 42

obodo oyinbo

13 Pipo Kpai, 86 Wunjure As Russia Use Missile and Drone Scatter Kyiv

According to Kyiv Mayor, Vitali Klitschko, at least 13 pipo don kpai, while 86 pipo carry wunjury after Russia missile and drone attack tear plenti houses inside Kyiv for early momo Thursday. Di attack happen just few hours after Ukraine Presido, Volodymyr Zelensky, warn say Russia dey prepare one massive attack. Media tuk tuk pesin wey dey for central and eastern Kyiv tuk say dem hear more than 12 loud explosions, as residents dey run enter metro stations to hide […]

todayJuly 2, 2026 20

OBODO NAIJA

Soldiers Burst Secret Gun Factory For Kebbi, Gbab Two Jaguda Boys

Soldiers under Operation FANSAN YAMMA don burst one secret gun factory for Kebbi State, recover five locally-made AK-47 rifles, and grab two suspected gun makers wey dey supply terrorists with weapons. Confirming di operation for inside statement on Thursday, di Media Information Officer of Operation FANSAN YAMMA, Lt. Col. Aliyu Danja, tok say di soldiers plan well well before di operation. According to di military, na correct intelligence make dem trace di hidden compound wey di suspects turn to workshop to […]

todayJuly 2, 2026 16

OBODO NAIJA

Schools Reopen For Oyo State As Teachers End One-Month Strike

Public schools for Oyo State don reopen today after di Nigeria Union of Teachers (NUT) announce on Wednesday say dem don suspend di one-month strike. As dem suspend di strike, NUT Presido, Titus Amba, say di decision come after di union hold talks with di government and also consider say plenty children don stay house for several weeks because of di kidnapping incident. Di union bin direct all public primary and secondary school teachers for di state to begin strike […]

todayJuly 2, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds