Blog masonry

Background

National

Imo Police Burst 2 Kidnappers, Nab 12

By: Rilwan Agbomeji Imo police don scatter 2 kidnappers, lock 12 for ceil, recover one dead body, dangerous weapons and 12 phones for Obudi/Mgbala Road and Umuezeruokam Forest. DSP Okoye yarn say DPO squad run down geng wey dey use white mini bus, while CP Danjuma promise say dem no go gree for kidnappers again. Meanwhile, police don para, reject all talk say dem dey do human rights wahala for Anti-Kidnapping Unit (AKU), wey dem dey call Tiger Base.” CP […]

todayDecember 5, 2025 14

Sports

Amorim Vex Say Man Utd Just Dey Waste Chances

By: Rilwan Agbomeji Manchester United boss Ruben Amorim don para after im players waste plenty chances as dem throway 1-0 lead take draw 1-1 with struggling West Ham for Premier League on Thursday. Amorim, wey dey fight to drag United comot from 8th position, blame im boys say dem no get killer instinct as dem don repeat di same wahala against Tottenham, Nottingham Forest, and even lose 1-0 to 10-man Everton for Old Trafford. Di match bin dey under United […]

todayDecember 5, 2025 8

Lagos

NDLEA Fire Up Youth Summit To Fight Drug Wahala

By: Esther Ayoola Lagos don start anoda  fight against drug wahala as the State Interministerial Drug Abuse Control Committee join body with NDLEA begin two-day youth summit for Agege on Thursday. The event wey happen for Oba Sanni Komolafe Youth Centre pack students, teachers, health experts and youth leaders under one theme: Drug/Substance Abuse and You: Wetin Every Young Person Suppose Know. Olawale Poluyi, wey deliver keynote on top Lagos Health Ministry matter, hail the students for show face well-well […]

todayDecember 5, 2025 6

Business

Lagos Go Double ICT Power, Target Global Tech Hub by 2030

By: Esther Ayoola Lagos Commissioner for Innovation, Science and Technology, Olatunbosun Alake, don announce say by 2030, the state wan double 100% increase ICT contribution to Lagos economy, and dem no dey slow down. Alake drop this bombshell on Thursday for Art of Technology Lagos 7.0 wey carry the theme Future Technologies and Sustainable Lagos. E yarn say Lagos go boost invention and scientific research by 50%, make the state the number one place to solve its own wahala through […]

todayDecember 5, 2025 9

Entertainment

Waje Land Abuja, Shake Gov Wives Conference With Strong Talk

By: Esther Ayoola Nigerian singer and humanitarian Waje scarra area for inside the 6th Nigerian Governors’ Conference, where big madams, policymakers, and development partners gather discuss women, health, education, youth and social welfare wahala. Waje, wey don always fight for women rights and youths, join the conversation on how influencers fit shape society and push better change. She yarn say policies nor dey enough, na the everyday behavior wey people show online and offline dey decide the kind society we […]

todayDecember 5, 2025 5

Entertainment

Wizkid and Asake Don Join Hands for EP “REAL (Vol. 1)” This December

By: Esther Ayoola Tori don land for music fans! Wizkid and Asake don announce say dem dey drop collabo drop EP “REAL (Vol. 1)” this December, and fans don dey ginger for di collabo. The two both of announce for the x handle, even show small snippet of tthe track “Jogodo” during Apple Music 1 appearance with DJ Tunez, give people taste of wetin dey come. Asake yan say their bond no just dey music, e deep and “real,” show […]

todayDecember 5, 2025 27

Niger Delta

Apc Cross River Wahala: National Body Block Eba Removal

By: Alice Iduh Progessives Congress wahala for Cross River don scatter reach national level as di party National Working Committee don All overturn di move wey State EXCO make to remove dia chairman, Alphonsus Ogar Eba. National Legal Adviser, Murtala Aliyu, send letter wey summon Eba make e come Abuja on Monday, December 8, to answer di vote of no confidence wey dem pass for am. Di summons land as majority of SEC members talk say di System no want […]

todayDecember 5, 2025 19

Niger Delta

Jimoh Ibrahim Nomination Don Shake Ondo South Seat

By: Alice Iduh Ondo South don enter political heat  period as Senator Jimoh Ibrahim, wey Presdo Bola Tinubu nominate as non-career ambassador, fit soon leave im Senate seat. Di senator, wey also chair Senate Committee on Inter-Parliamentary Worldwide, fit land posting for UN, UNESCO or African Union, and na dis gist don make contenders begin waka underground to grab di seat. Even though Ibrahim still dey hold im position till Senate confirm am and he resign, heavyweights for di district […]

todayDecember 5, 2025 13

south west

Adeleke Dey Block PDP Governorship Pick — Sani

By: Alice Iduh DI Peoples’ Democratic Party chieftain Umar Sani don accuse Osun State Govo, Ademola Adeleke, say na him dey block PDP from choosing who go run for govo as election dey near. Sani talk on Friday say Adeleke dey chase im own political interest and no send PDP matter, even talk say di govo dey use PDP inside wahala take hold ground because of signature wey Independent National Electronic Commission go recognise. Adeleke shock everybody as he resign […]

todayDecember 5, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app