Blog masonry

Background

Sports

Atletico Madrid Reject Real Madrid €150m Bid For Julián Álvarez Deal

By: Esther Ayoola Real Madrid don reportedly offer €150 million to sign Argentine striker Julián Álvarez from city rivals Atlético Madrid. Dis na according to statement wey appear for dia website. Di club say di proposal come afta board meeting wey dem hold as dem dey look for top striker to strengthen dia attack. But Atlético Madrid quickly reject di offer, say Álvarez dey very important for dia project and dem no go sell am anyhow.

todayJune 10, 2026 15

Sports

Ebola Scare Shake Dr Congo World Cup Prep

By: Esther Ayoola Democratic Republic of Congo dey fall hand oh, losing 2–1 to Chile for friendly match wey dem play for France on Tuesday, put am for Ebola head Di match suppose hapun for southern Spain, but di mayornor gree based on Ebola concern, naim make dem con move go France, and now dem con lose World Health Organization don declare international health emergency over di Ebola outbreak wey start for northeastern DR Congo on May 15, and e […]

todayJune 10, 2026 17

National

Abure Point Finger To Obi, Otti Say Na Dem Scata Labour Party

By: Esther Ayoola Former Labour Party Chairman Julius Abure don accuse Peter Obi and Abia State Governor Alex Otti of causing di leadership crisis wey dey shake di party. Abure, wey tuk for TV sit down tuk on Tuesday, say Labour Party dey peaceful until Obi and Otti carry dia problem come, create caretaker committee for Umuahia. According to am, na dat decision scata di party stability and start di fight, fight for di fight today.

todayJune 10, 2026 15

National

SGF Akume Cast Atiku Say Im Join Leaders Weh Push Rotational Presidency

By: Esther Ayoola Secretary to Gornment of Federation (SGF), George Akume, don go cast wi former Vice Presido, Atiku Abubakar, say im na one of di leaders wey support, make dem dey rotate presidency for Naija like barbar chair afta dem cancel June 12, 1993 election. Akume yarn dis one for World Press Conference for Abuja as part of Democracy Day celebration. Im say di annulment of di election wey late MKO Abiola win make political leaders take hard decision […]

todayJune 10, 2026 15

National

Shettima Rake Say EFCC Make Foreign Investors Trust Naija More

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido, Kashim Shettima, nor be small tin oh, don rake full newspaper say, na di  strong work by EFCC make Naija name nor loud for money laundry mata. Shettima yarn dis one during di commissioning of EFCC new zonal office for Ado-Ekiti, Ekiti State. He also assure Nigerians say Federal Gornment go continue to strengthen anti-corruption agencies through beta infrastructure, staff welfare, training and operational independence.

todayJune 10, 2026 18

Lagos

Lagos Assembly Back Royal Family For Oko-Ado Land Mata, Push Make Dem Collect C Of O

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly on Tuesday don accept recommendation on petition wey concern land mata for Oko-Ado Village, Sangotedo. Dem dey ask, make gornment issue Certificate of Occupancy (C of O) give Igbaro Oteshade Royal Family. Na Chairmo of Judiciary and Public Petitions Committee, Oladipupo Ajomale, tuk dis tuk, say dem go check di land with Surveyor-General office and other agencies like Land Bureau and NTDA. E sti show say part of about 20 hectares don […]

todayJune 10, 2026 16

Sports

Serena Williams Return with Big Win for Queen’s Club Doubles

Senior woman, Serena Williams don make ogbonge winning return to tennis for Queen’s Club doubles on Tuesday. Di American legend wey don win 23 Grand Slam titles team up with Canada teenage Queen, Victoria Mboko, and dem beat Erin Routliffe and Nicole Melichar-Martinez 7-6 (7/2), 6-2 for first round. Mama Sere, Sere, wey shock plenty pipo last week unto say, seh tuk say, she wan return to playing, say she sha shake small for di match but sti get di […]

todayJune 10, 2026 19

obodo oyinbo

Trump Promise Iran Backyard Movement

Baba Presido of America, Donald Trump drop one or two on Tuesday say hand go touch Iran, say e nor get wetin person go tell am,  hand go touch Iran say dem get mind shoot down one US military helicopter wey dey patrol near Strait of Hormuz. Trump tuk for im truth social on Tuesday say, im hear report say di attack hapun for night, even as dem dey try find way to end di war. For Iran side, parliament […]

todayJune 10, 2026 19

OBODO NAIJA

President Tinubu Approve ₦10B Emergency Fund

Oga Presido Bola Tinubu don approve make dem set up Presidential Task Force to prepare Nigeria against Ebola virus and other health issues. Di Presido also order, make dem release ₦10 billion emergency fund sharply to help build wall of Jericho against di  disease. Dis na According to im tuk tuk person, Bayo Onanuga, say di money go hellep di NCDC, how dem dey respond to sickness. Dis task force, wey Chief of Staff, Femi Gbajabiamila go lead, come out […]

todayJune 10, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds