Blog masonry

Background

Sports

Lookman Ask Make Dem Transfer Am Go Athletico Madrid — Palladino

By: Rilwan Agbomeji Atalanta coach Raffaele Palladino don reveal say na Ademola Lookman ask make e comot di club go Atletico Madrid. Lookman complete permanent transfer to Diego Simeone side on di last day of winter transfer window. Atalanta collect €40 million as transfer fee for di Super eagles striker. Palladino talk say Lookman receive di offer towards di end of transfer session, say e want new environment, so di club gree to make am happy.

todayFebruary 5, 2026 22 1

Entertainment

Nollywood Actress, Aunty Ajara, Kpai Afta Short Illness

By: Rilwan Agbomeji Nollywood actress Ajara Lasisi, wey people sabi as Aunty Ajara, don kpai. Dem announce di sad news on Thursday as Nollywood director Tobi Oladele Teemony, wey dem dey call Tee Mony, share statement for Instagram. According to am, Aunty Ajara kpai overnight afta long time wey she dey battle serious illness with strong mind. Teemony talk say during her sickness, she receive plenty love, prayers, and financial support from kind-hearted people from different parts of di world. […]

todayFebruary 5, 2026 44

foreign

China Reject Nuclear Yarns As US–Russia Nuclear Treaty Don Expire

By: Rilwan Agbomeji China on Thursday don tuk say e no go join nuclear talks for now afta di US–Russia New Start treaty expire, wey don raise fear of global arms race. Campaign pipo warn say di treaty expiry wey stop limit on number of nuclear warheads fit push China to increase im own nuclear weapons. United States don insist say any new nuclear agreement must include China, but all international effort to convince Beijing never work so far. China […]

todayFebruary 5, 2026 26

National

FG Dey Face Heavy Backlash As Fear Dey Say Over 100 People Don Kpai

By: Rilwan Agbomeji More than 100 people bin fear say don kpai for Tuesday night afta deadly attack wey Islamic militants carry enter Woro and Nuku communities for Kaiama Local Government Area of Kwara State. Kwara State Govo, AbdulRahman AbdulRazaq, On Wednesday night  later confirm say 75 people kpai for di gbege as e address residents for palace of Emir of Kaiama, say di victims na local Muslims wey dem kill because dem refuse follow extremists wey dey preach strange […]

todayFebruary 5, 2026 17

Lagos

Lagos Go Close Apongbon Bridge For Six Weeks For Repairs

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govment, don join body with Federal Ministry of Works, don announce say dem go start repairs for failed asphalt parts of ramp and service lane wey connect Inner Marina to Apongbon Bridge, plus some parts of di bridge lanes. State Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, tuk say di work go start for service lane on Thursday, February 5, and e dey expect say e go finish on Thursday, March 19, 2026. E add say to […]

todayFebruary 5, 2026 18

Sports

Yamal Shine As Barca Beat Albacete 2-1 Reach Copa del Rey Semi-Final

By: Esther Ayoola Barcelona don reach Copa del Rey semi-final afta dem win 2-1 against Albacete on Tuesday. Lamine Yamal score first just before half-time, and Ronald Araujo add second early afta break. Araujo dey play him first game since im month-long mental health break. Albacete try fight back and Javi Moreno score near di end, but Barca still carry di win.

todayFebruary 4, 2026 20 1

Sports

Kai Havertz Last-Minute Goal Send Arsenal Go Carabao Cup Final

By: Esther Ayoola Arsenal don konfamat demself for Carabao Cup final afta dem beat Chelsea 1‑0 for Emirates Stadium on Tuesday night.   Di match no too get chance, but for last minute of six minutes added time, late goal from Kai Havertz ni wunjure Chelsea for ground.   Dis goal give Arsenal di 1‑0 win for di match and 4‑2 for aggregate, make Chelsea cry beta style.

todayFebruary 4, 2026 19 1

obodo oyinbo

Iran Presido Pezeshkian Konfam Dia Tuk Wit USA

By: Esther Ayoola Iran Presido, Masoud Pezeshkian on Tuesday say im don ready to start tuks wit United States, if only di tuk nor go bring problem to Iran. US Presido, Donald Trump, bin warn Iran say “bad things go hapun” if Iran nor strike Nuclear deal with dem. Arab official wey no give im name, say dem fit meet for Turkiye on Friday for di tuks, as Egypt, Qatar, Oman and Turkiye dey try hellep settle di mata. Pezeshkian […]

todayFebruary 4, 2026 18

obodo oyinbo

UN Beg Israel to Allow Sick Pipo Enter Egypt

By: Esther Ayoola U.N. boss, Antonio Guterres don beg Israel make dem allow humanitarian hellep enter Gaza. Say Plenty pio dey sick and dey wunjured for GAZA, dey wait opportunate to cross go Egypt for treatment. Based on say Isreal nor gree, say na Only small number, 16 pipo, waka go Egypt on Tuesday. Dis one sef far from di 50 pipo wey Israel agree say dem go allow go and come every day.

todayFebruary 4, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds