Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Gorment Set Compass To Rascal Ebola

Lagos Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, don shake table drop micro soft word say Lagos State get strong doings in place to package Ebola. Im tuk dis one during Invest Lagos 3.0 event on Tuesday. According to am, even as COVID-19 loud reach for 2020, say e dey choir practice for Ebola mata, but dat, Lagos don package tools for di Ebola.

todayJune 10, 2026 20

Lagos

Lagos-Apapa Expressway Askident Kpai Minibus Driver

One commercial driver don lose im life for serious askident wey happen for Lagos-Apapa Expressway. Di gboza crash, involve commercial tuke tuke motor and Toyota Tundra. According to Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tuk tuk person, Adebayo Taofiq, di driver wunjure wetin nor gud and im kpai for di spot because of di heavy impact. Authorities don begin investigate to know wetin cause di askident.

todayJune 10, 2026 18

Sport Yarns

Man United Don Finalize Busy Pre-Season Play With AC Milan For Poland

By : Jolayemi Olajide Manchester United don announce on Tuesday say dem go finish dia tight pre-season preparation against AC Milan for Wroclaw inside Poland. Di big match go hold on August 15 as coach Michael Carrick dey plan to build on top di beta third position wey di club carry last season before di new Premier League start. United go start di matches against Wrexham for Helsinki on July 18, before dem move go Norway go face Rosenborg di […]

todayJune 9, 2026 26

Entertainment

Comedian Bovi Say He Dey Happy When Pipo Divorce If Di Marriage Don Turn Into Suffer-Suffer

By : Jolayemi Olajide Popular Naija comedian, Bovi Ugboma, don open mouth yarn for sit down tuk say he dey happy when pipo divorce if di marriage don change to suffer-suffer. Bovi yarn inside the show say marriage no suppose be do-or-die marra and he go celebrate divorce because e mean say di couples fit breathe well now. Dis marra trend as Bovi change narrative on top how pipo dey see divorce for Nigeria, yarn say to comot for bad […]

todayJune 9, 2026 15

OBODO NAIJA

Military Jets Kill Eight Terrorists, Scatter Their Hideout For Borno State

By : Jolayemi Olajide Nigerian military jets don bomb terrorist hideout for Borno State on Sunday, June 7, where dem kill at least eight jaguda boys and destroy dia supply motor. The Air Component of Operation HADIN KAI wire this heavy attack for Cross Kauwa axis after security show where di boys dey gather. Surveillance aircraft first spot di jaguda boys where dem hide inside thick bush before di military command send aeroplane go wipe dem out. Di gorment carry […]

todayJune 9, 2026 17

OBODO NAIJA

Peter Obi Dey Ask Govt To Show Wentin Dem Use Almost 200 Trillion Naira Debt Do

By : Jolayemi Olajide Peter Obi don challenge Federal Government on Tuesday make dem open eye tell Nigerians wetin dem use all di money wey dem borrow do as country gbese dey load near 200 trillion naira. Di NDC presidential candidate drop dis tuk for em X handle where he complain say Nigeria gbese don jump up with pass 100 trillion naira within just three years. Obi yarn say di way President Bola Tinubu govt dey pack debt gbese country […]

todayJune 9, 2026 20

Lagos

Lekki LCDA Go Put Security For Public Schools

By : Jolayemi Olajide Lekki LCDA Chairman, Rasaki Bamidele Kasali, don announce plan to station security personnel for public schools across the council area to protect pupils, students, teachers and school property. Kasali make the announcement after meeting with grassroots security groups, including Forest Guards, Olokun Boys, Vigilante members, NSCDC and Neighbourhood Watch operatives, as e share the update for him X page. According to am, the meeting focus on how to tighten security for Lekki communities and improve the […]

todayJune 9, 2026 14

Lagos

FCCPC Seal Property Company Office Over Land Wahala

By : Jolayemi Olajide FCCPC don seal the office of one real estate company over allegation say the company fail to give customers land plots for Lagos despite full payment and several warnings from the commission. Southwest Zonal Coordinator of FCCPC, Dr. Olubunmi Otti, lead the enforcement team with security officers to carry out the action, saying the operation follow powers wey the law give the commission. According to Otti, FCCPC begin investigate the real estate company after one consumer […]

todayJune 9, 2026 18

obodo oyinbo

Ebola protest turn violence for Kenya

By : Olajide Jolayemi Kenyan police fire teargas and arrest several protesters during a heated protest against an Ebola isolation centre wey America dey build for Nanyuki town, near Laikipia Air Base. Di protesters, including local residents, carry fake coffin and wear protective gear to block di area, saying dem no want anything wey fit bring Ebola enter Kenya. According to security sources and eyewitnesses, di clash turn violent as protesters throw stones while police try disperse dem, especially around […]

todayJune 9, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds