Blog masonry

Background

Lagos

Man Don Jailed 21 Months For Stealing N50 Million Under Fake Pretence

By: Esther Ayoola For stealing and collecting money under false pretence, Justice Rahman Oshodi of Lagos Special Offences Court for Ikeja don find Chukwudole Chinedu guilty and sentence am to 21 months plus 18 days. EFCC charge am say e collect N50 million from Ezeh Paul Chukwudi, dey tell am say e get $70,000 to sell at N720, wey no true. Chinedu bin face two counts wey concern obtaining money under false pretence and stealing.

todayDecember 2, 2025 6

Lagos

Six Lagos Real Estate Marketers Don Kidnapped For Ogun State

By: Esther Ayoola Some jaguda boys again don gbab six real estate marketers for Lagos, while dem dey go inspect their company land for Oyebola village, Obafemi-Owode Local Government Area, Ogun State. Tori people carry say the victims waka go the land for inspection before the attackers strike. Police Commissioner, Lanre Ogunlow sef, don confirmate the development give news wakawaka that the incident happen on Friday.  And that like this like this, police don dey torch light nearby bushes and […]

todayDecember 2, 2025 8

National

Oluremi Tinubu Don Share 10,000 Sanitary Pads Give Jigawa School Girls

By: Esther Ayoola Oga presido wife, Lolo Oluremi Tinubu, don share 10,000 sanitary pads give girl students for Jigawa State. Di gesture come at di time wey stakeholders and UNICEF dey shout make girls take care of themselves during menstruation. According to aproko, this move dey twin with Jigawa State Government ongoing support for women health, as dem dey join hand fight poverty for di region. As she dey talk for di distribution event wey happen for Government House, Dutse, […]

todayDecember 2, 2025 5

National

Tinubu Aide Abubakar Resigns on Health Grounds, President Accepts Letter

By: Esther Ayoola Minister of Defence, Mohammed Badaru, don resign from him post with immediate effect, say e no do again and that him no dey feel fine. E write letter give President Tinubu wey carry the resignation and e date am December 1. Special Adviser to the President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, yan this one to TV sidon talk on Monday. Presidential spokesman talk say Abubakar resign because of health reasons.

todayDecember 2, 2025 7

Entertainment

Kaka Igbokwe Confirms 2Baba’s London Arrest After Airport Clash With Wife

By: Esther Ayoola Former manager of music icon, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba and pikin of late legend Christy Essien-Igbokwe,, Kaka Igbokwe, don confirmate say di old trending video of 2Baba arrest for London after him quarrel with him pregnant wife, Natasha Osawaru, na true. Recall, 2Baba travel go United Kingdom with him pregnant wife for concert tour, but him no show for di October 2, 2025 performance wey dem schedule for am. As 2Baba no show, rumours […]

todayDecember 2, 2025 25

Entertainment

Reality TV Star Don Reveal How She Take Create Her Stage Name

By: Esther Ayoola Reality TV star and actress Roseline Afije, wey people sabi as Liquorose, don explain how she take get her unique stage name, and she talk say na her love for sapele water join with her real name inspire am. For one podcast wey she do with VJ Adams, Liquorose yarn say she choose the name back for December 2012, and since then e don turn her identity everywhere. She talk say she dey value her family life […]

todayDecember 2, 2025 14

National

Northern Govs Wan Lock Mining For 6 Months, Scatter Ground With ₦228bn Security Cash

Govos and Traditional Rulers for north don form geng enter meeting for Kaduna, order say make mining stop for at least six months, and dat illegal mining, na im dey cause all di katakata of security for di North. Di leaders dey para say dat pipo dey face serious gbege wit Jaguda boys and so don set up regional Security Trust Fund, wey every state and local gornment go drop ₦1bn monthly to rascal di Jaguda boys for North. For […]

todayDecember 2, 2025 11

Sports

We Go Block Osimhen Goal – Skriniar

Fenerbahce captain, Milan Skriniar don fire warning shot, talk say dem ready lock Victor Osimhen completely as di Istanbul derby go burst tonight for RAMS Park. Galatasaray dey top table with one point, and dis match don turn full-blown city war as both sides dey ginger for supremacy. On top post for X, Skriniar yarn say Osimhen and Icardi fit be hot strikers, but tonight, Fenerbahce dey come rugged, compact and angry to make sure Osimhen net no shake.

todayDecember 1, 2025 32

foreign

Cash Don Finish For Sudan, Pipo Dey Swap Goods, Run Credit

Sudan economy don kpafuka, money don vanish comot, everywhere don turn wahala zone, one euro wey before dey 450 pounds now dey sell 3,500 for black market, money don disappear everywhere. Banks don loot, cash don vanish, people don dey swap everything, chairs, hoes, cloth, even fridge, just to chop, buy fuel or run generator. Civil servant Ali for Dilling talk say e never see banknote for over nine months, and people dey pay motorcycle and tuk-tuk drivers with oil, […]

todayDecember 1, 2025 42

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app