Blog masonry

Background

Sport Yarns

Alex Iwobi Thank Nigerians Say im Wan Play Im 100th Game For Super Eagles

By : Jolayemi Olajide Super Eagles star midfielder, Alexander Iwobi, don send big thank you to all Nigerians for home and abroad for di heavy love and support as im prepare to play im 100th match for Nigeria against Portugal inside Leiria on Wednesday. Inside one sharp tuk on Monday, naim di playmaker take fry mouth tuk di tuk. Iwobi say im dey very proud to wear di green and white jersey and im nor get any single regret say […]

todayJune 8, 2026 20

OBODO NAIJA

 Atiku Salute Ngozi Okonjo-Iweala Based on Her Younger Brother Wey Kpai

By : Jolayemi Olajide Former Vice Presido, Atiku Abubakar don send im condolence message to di Director-General of di World Trade Organization (WTO), Dr. Ngozi Okonjo-Iweala, after her younger brother, Prince Ikechukwu Okonjo, kpai. Inside one post on top im X account on Monday, naim Atiku take salutate di former Nigeria finance minister and her entire family over di painful loss wey hit dem. Atiku describe di late Prince Ikechukwu as a respected member of di Umu Obi Obahai royal […]

todayJune 8, 2026 21

Lagos

Protesters Storm Lagos Assembly Demand For Ajiran Community Leader

By : Jolayemi Olajide Some Lagos pipo storm State House of Assembly on Monday to protest because police lock up one Ajiran community leader, Hammed Tajudeen Akanbi. Di protesters march from Ikeja Shopping Mall go give di Speaker petition, as dem dey shout make gornment release di man. Dis rally hapun after Akanbi lawyers cry out say di court dey do partial for the mata, so fresh investigation must start. Dem lock the leader put for jail because dem allege […]

todayJune 8, 2026 23

OBODO NAIJA

Senator Victor Umeh Tuk Why Lawmakers Dey Use Big Official Cars

By : Jolayemi Olajide Senator Victor Umeh wey dey represent Anambra Central don clear matas on why dem give National Assembly lawmakers big motors, say, dem need am to do dem legislative duties well. Umeh tuk dis tuk for one interview on Monday, say, pipo nor get any right to vex over the mata, sake of say di official motor na official work. When dem ask am if he collect im own motor, the Senator talk say nothing stop am […]

todayJune 8, 2026 27

Sport Yarns

Florentino Pérez Win Real Madrid Presidential election, Go Lead Till 2030

By : Jolayemi Olajide Florentino Pérez don collobi another win to rule Real Madrid  as dia presido  till 2030. For the election, he gather 21,741 votes (65%) while challenger Enrique Riquelme get 11,814 votes (35%). Na For  acceptance  victory speech, Pérez take clear every body im mind unto how e wan to move di club forward. Di  long-serving president say di election result show say, fans support im plan to protect Real Madrid identity and independence.

todayJune 8, 2026 21

obodo oyinbo

Heavy 7.8-Magnitude Earthquake Hit Philippines, Kpai 15 Pipo

By : Jolayemi Olajide Chai, heavy  problem for  southern Philippines on Monday, dat  one massive 7.8-magnitude earthquake shake the area. Dis na according to di United States Geological Survey, and USGS, wey konfam di mata, and  at least 15 pipo don kpai  near General Santos City. According to Philippine authorities, the earthquake hapun inside water for the southern part of the city. Based on dis,  Philippine gornment  don  order make  pipo wey dey live near the beach, run go higher […]

todayJune 8, 2026 21

OBODO NAIJA

Delta Police Burst jaguda boys, gbab Four Suspects Across Bayelsa And Imo 

By : Jolayemi Olajide Delta State Police Command don arrest four suspected jaguda boys wey bin con show dem self with one Beretta pistol, na so  police sieze di gun, for Effurun, Uvwie Local Government Area, as part of investigation into illegal firearm movement. Police Commissioner CP Yemi Oyeniyi, naim knack dis mata for  news tuk, tuk on Monday. Oga Oyeniyi  say, na beta intelligence and beta touch lighting naim di police  take gbab the  4 suspects for Bayelsa and […]

todayJune 8, 2026 19

OBODO NAIJA

Oyo Gornment Bulldoze House Wey Jaguda boys take  Hide Adelabu Sister 

By : Jolayemi Olajide Oyo State Gornment don pull down di building wey kidnappers use hide Olaide Adegoke John-Paul, sister to former Power Minister Bayo Adelabu, and her twin pikins. Di demolition happen on Monday, less than two days after police rescue di woman and her pikin dem from di kidnappers. Gornment tok say dem discover say na for di building di criminals keep the victims during dia captivity. Authorities say di action show say Oyo State no go tolerate […]

todayJune 8, 2026 22

Lagos

Lagos Police command clear mata, Say e nor get any jaguda boy wey dey plan attack Schools

By: Jolayemi Olajide Lagos State Police Command don assure residents saydem mout oh unto di aproko of bandits attacking or kidnaping school children for di state, despite threatening notice wey circulate on Monday. Di Command, through Police Commissioner CP Tijani Fatai, immediately order security to mout di affected areas, schools and other important places. Oga commissioner dey insist say Lagos dey safe and any bandit, kidnapper or anybody wey wan cause fear and panic for di state go face di […]

todayJune 8, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds