Blog masonry

Background

National

Court Stop NLC, TUC From Strike As FCT Government Go Court

By: Esther Ayoola Justice Emmanuel Subilim for National Industrial Court don stop NLC, TUC, and three oda groups from any strike or protest for now. Di order come afta FCT Minister, Nyesom Wike, and FCTA go court to block di mass protest wey dem plan for 3rd February. Court also tell security agencies make dem make sure say law and order no collapse. Recall, NLC and TUC tuk say make workers continue strike because dia lawyer, Femi Falana, don appeal […]

todayFebruary 3, 2026 16

obodo oyinbo

President Trump Slash India Tariff Go 18% From 50%

By: Esther Ayoola President Donald Trump don drop ogbonge update, say US go cut tariff wey dem dey charge Indian goods from 50% to 18% afta meeting with Prime Minister Narendra Modi. India come agree say, dem nor go dey buy Russian oil again and dem go dey buy oil from US and maybe Venezuela. According to Trump, dis waka with India go reduce trade barriers and India go dey buy plenty American things like energy, technology and farm goods.

todayFebruary 3, 2026 17

obodo oyinbo

Iran, US Set Tuk For Istanbul To Avoid War

By: Esther Ayoola Iran say dem dey hope for progress to start nuclear tuk wit US again. Some people dey tuk say di Iran president don order make dem revive di negotiations. Tehran dey look tori wey some countries for di area bring come and dat e don reduce tension wit Washington. Reuters Report, say US and Iran go meet for Istanbul on Friday, US envoy Steve Witkoff and Iran foreign minister Abbas Araghchi go dey di meeting.

todayFebruary 3, 2026 12

Sports

FIFA Presido Begin Waka To Stop Russia Football Ban

By: Esther Ayoola FIFA president Gianni Infantino don drop yarns say, time don reach to remove Russia from football ban. You sabi say, FIFA banned Russia since dem enter war with Ukraine for 2022. Infantino say, di ban nor hellep anybodi, say, instead e only bring more disappointment and hatred. Di FIFA president dey yarn dis one for TV sit don tuk say, make dem begin allow Russia players to play football for other country, say dat one sef go […]

todayFebruary 3, 2026 8

Sports

Team Nigeria, Uzbekistan Land Lagos For Davis Cup Showdown

By: Esther Ayoola Say like dis area dey hot for di Davis cup, dat, Team Nigeria don move dia training camp from National Stadium, Surulere go Lagos Lawn Tennis Club, wey go host dia Davis Cup World Group II match against Uzbekistan on February 7–8. Uzbekistan team sef don land Lagos on Sunday, dem do dia first on-court practice on Monday. Di Uzbek team carry three players plus four officials, and dia main player, Khumoyun Sultanov, wey just win ITF […]

todayFebruary 3, 2026 10

National

Kefas Hail Taraba Security Chiefs, Say Dia Face Show

By: Esther Ayoola Governor Agbu Kefas of Taraba State don praise the outgoing oga dem for security agencies for the good work wey dem do for the state, say their performance na correct one. Di govo tuk this one during one state dinner for Gornment House Banquet Hall for Jalingo, wey dem organize to honour security chiefs wey retire or transfer comot from the state. Im still reassure pipo say im gornment nor go relax for mata of insecurity whether […]

todayFebruary 2, 2026 17

National

Minister Of Information Press Yarnings On Tinubu Reforms

By: Esther Ayoola Wi Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, untop weekend motivation to Monday dey clear Nigerian youths, say, make dem  try use the opportunities wey dey from national reforms. Im  tuk dis one for di 2026 Convocation Lecture wey happen for 34th Convocation Ceremony of Federal University of Technology, Minna, Niger State. Idris say Nigeria na young country wey get plenty potential, and the future of the country dey depend on how well young people dem […]

todayFebruary 2, 2026 12

Sports

Ronaldo Put Bodi For Conner To Protest Lack Of Signing Of AL-Nassr

By: Esther Ayoola Reports say Cristiano Ronaldo no go feature for today league match, even though e dey fully fit. Planet Football report on Monday say di Portuguese star, wey dey play for Al-Nassr for Saudi Arabia, take dis decision for February 2026. Ronaldo, five-time Ballon d’Or winner and one of football greatest players, don get history of showing frustration when things for him club no dey go di way e expect.

todayFebruary 2, 2026 14

obodo oyinbo

Green Fuel Wahala Slow Down Airline Industry

By: Esther Ayoola Di airline industry green plan, say dey face serious problem as cleaner jet fuel price dey go up like say tomorrow nor dey . IATA boss Willie Walsh tuk for Changi Aviation Summit for Singapore say progress on sustainable aviation fuel still dey poor. According to am, SAF production for 2025 na only 1.9 million tonnes, wey be just 0.6 percent of total jet fuel wey airlines dey use. He still tuk say compulsory SAF rules don […]

todayFebruary 2, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds