Blog masonry

Background

National

First Lady Tell Nigerians To Protect Environment

By: Esther Ayoola First Lady, Senator Oluremi Tinubu, for Abuja on Monday, don wire wire message to every Nigerians, say  make wi try our best to protect our environment and keep everywhere clean. She tuk dis one  as dem di world dey mark International Day of Clean Energy 2026, with theme “Clean Energy for People and Planet.” Senator Oluremi explain say make everybody dey use renewable energy and sustainable technologies because na di only way to preserve environment and healthy […]

todayJanuary 26, 2026 16 1

National

Naija Health Workers Blame Gorment For Strike

By: Esther Ayoola Di Joint Health Sector Union (JOHESU) for Naija don tell Nigerians on Monday make dem hold Federal Gornment responsible ugly health wahala for di country on why health workers strike JOHESU explain say dia main demand, say na implementation of report on adjustment of Consolidated Health Salary Structure (CONHESS) to improve health workers’ pay. National Secretary, Martin Egbanubi, yarn for one Media sitdon tuk tuk say dem don already tell gorment wetin dem want and dat na […]

todayJanuary 26, 2026 12

obodo oyinbo

China, India Settle Dia Fight For Trade Tuks

By: Esther Ayoola China presido, Xi Jinping don declare dat  China and India na  good neighbours and friends wey suppose to run marras together. Oga Jinpoing dey uyan dis one, as di two of both of dem dey try  fix dia  relationship after plenty  Trump tariff  wahala wey hit dem. Xi send Republic Day greeting to Indian president Droupadi Murmu, say relationship between both countries don  dey get head small small again and e good for world peace and progress. […]

todayJanuary 26, 2026 12

Sports

Former Man United Midfilder Keane Says Carrick Nor Be Di Right Man For United

By: Esther Ayoola Former -Man United midfielder Roy Keane  say United don improve  but Micheal Carrick nor be di man for di job after im beat Arsenal 3-2 for Emirates. Ontop yanings for post match conference, Keane  say anybody fit win two games, and even if United win all dia matches till season end, e ma nor go still  give Carrick di job. E say United need bigger and better manager wey fit handle di club size and help dem […]

todayJanuary 26, 2026 13

Sports

Naija Athletes To Jim Bodi For Scotland Four Weeks Before Commonwealth Games

By: Esther Ayoola Naija athletes go camp for Scotland for four-weeks todo jim jim di body before 2026 Commonwealth Games For Glasgow. National Sports Commission Director-General, Bukola Olopade, ni dey konfamate dis infomate, say dem pick Aberdeen to make things easy and reduce wahala of travel. E say early arrival go hellep athletes adjust well and sabi how di conditions go be once di competition start. Team Naija go reach Aberdeen four weeks before di games for training, preparation, and […]

todayJanuary 26, 2026 16 9

obodo oyinbo

UN Convoy Don Reach Kobane, Bring Food And Fuel

By: Esther Ayoola Say United Nation, UN, Office for di Coordination of Humanitarian Affairs (OCHA) Don konfamat dat,  UN convoy don reach Kobane for north Syria to hellep save lives for wia Syrian army and the Kurdish-led Syrian Democratic Forces (SDF) bin fight as ceasefire tuk continues. Di humanitarian pipo say, dem bring 24 trucks wey get fuel, bread, and ready-to-eat food for pipo wey dey suffer because of di unrest for north Syria. U sabi say, Residents bin complain […]

todayJanuary 26, 2026 19 7

National

House, Minority Caucus Gbege Over Tax Law Report

By: Esther Ayoola Na beta gbege ni burst between House of Representatives and Minority Caucus over committee wey dem create to investigate changes for di  Nigeria tax laws. Chairmo of di Minority Caucus committee, Afam Ogene, warn say if dem dismiss di interim report, e go ginger anyhow doings  and weaken National Assembly. House deputy tuk, tuk, Philip Agbese, dey complain say, wetin dem dey report, say other event don over take am, afta some Certified True Copies of di […]

todayJanuary 26, 2026 18 38

National

PDP, ADC, LP Knock APC As Kano Govo Jump Party

By: Esther Ayoola Pipos Democratic Parti, Africa Democratic Congress and Labour Party, say, like dis, dey squeeze wetin nor good for dia face dat All Progressives Congress don finish Nigeria following di defection of Kano State Govo, Abba Yusuf. Di opposition parties tuk say di Kano state Govo move dey smell, and dat na moral failure, and norbi real politics be dat. Untop yarning with tori pipo on Sunday, Labour Party faction chairmo, Senator Nenadi Usman, warn, say make pipo […]

todayJanuary 26, 2026 15 42

National

President Tinubu Arrange Bags For Türkiye Business Movement

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu go Kawasaki from Abuja dis Monday, go for state visit for Türkiye to boost relations between Nigeria and Türkiye. Na oga presido tuk, tuk, Bayo Onanuga, tuk dis one on Sunday, say di visit na to discuss security, education, social development, innovation, and aviation matas. Dis visit dey follow Turkish Presido, Recep Tayyip Erdogan official visit to Nigeria for October 2021 wey don strengthen diplomatic joinbodi doings between di countries. During […]

todayJanuary 26, 2026 15 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds