Blog masonry

Background

obodo oyinbo

U.S. Top Immigration Oga, Greg Bovino To Leave Minneapolis

By: Esther Ayoola Top U.S. immigration oga, Greg Bovino and some agents go leave Minneapolis afta federal officer shoot one U.S. citizen, Alex Pretti,  and say e cause serious gbege  for  di town. President Trump don send im “border oga” Tom Homan go manage immigration work for di city as people dey watch wetin go happen next. According to report, dis kain move fit mean say, White House wan reduce how dem go dey do heavy-handed immigration action.

todayJanuary 27, 2026 12

obodo oyinbo

Australia Cancel Israeli Influencer Visa say E Tuk Bad About Islam

By: Esther Ayoola Australia don cancel visa for one Israeli influencer, Sammy Yahood, wey dey spread hate against Islam. Untop post for X, Home Affairs Minister, Tony Burke don make am clear say, make nobodi come Australia con spread hatred. Wetin di influencer writer, say, Yahood write say Islam no dey tolerate non-believers, women, pikins, and gay people, ni be di probelm. Australia Gornment like dis don dey tighten hate crime law afta di Bondi Beach mass shooting wey kill […]

todayJanuary 27, 2026 13

Sports

Green Arrows Ready Bodi For Dia African Men Handball Final Group Game Against Egypt

By: Esther Ayoola Say, Na today Nigeria Green Arrows go jam defending champions Egypt for big Group I match for African Men Handball Championship. Winner go secure semi-final spot plus direct ticket go 2027 IHF Men’s World Championship. Egypt dey lead di group with two wins, 83 goals scored and 56 goals wey dem don concede, while Nigeria dey second with one win and one loss. Egypt na one of Africa handball giants, dem don reach semi-finals for World Championship […]

todayJanuary 27, 2026 7

Sports

Efe Ajagba Jim Bodi for Charles Martin Dis Valentine

By: Esther Ayoola Nigerian heavyweight, Efe Ajagba don dey do jim jim di bodi to face former IBF champion Charles Martin for Zuffa Boxing third Paramount+ show on February 14 for UFC Apex, Las Vegas. Di fight tuk don dey table since November 2023 when Top Rank plan am first, but e never hapun since den. Ajagba wey be 2016 Olympian, get record of 20-1-1 with 14 KOs, comot from Top Rank afta e nor gree fight Frank Sanchez because […]

todayJanuary 27, 2026 26

obodo oyinbo

Winter Storm Kill 11 People Across US

By: Esther Ayoola Say, one strong storm sweep across di United States kpai at least 11 people on Monday, as authorities warn residents make dem stay off road because of dangerous weather. Di storm wey dem dey call dump snow,  do wetin nor good and na so  freezing rain from Texas reach New England, spoil light and flight cancel across many states. New York City Mayor, Zohran Mamdani, tuk to reporters say five people kpai over di weekend, warn say […]

todayJanuary 26, 2026 18

Sports

Abia Govo Appoint New Coachie For Enyimba

By: Esther Ayoola Abia State Govo, Alex Otti, don approve make Enyimba International Football Club appoint new head coach. State Commissioner for Information, Okey Kanu, put for statement on Monday,  say di new coach na Coach Deutsch Detchoua Gustave Emmanuel go begin work immediately paper work complete. Enyimba FC na Nigeria most decorated football club and one of Abia State biggest sports pride for Africa. As two-time CAF Champions League winner and plenty-time league champion, Enyimba don long dey carry […]

todayJanuary 26, 2026 16

National

Soludo Shut Onitsha Market One Week Over Sit-at-Home

By: Esther Ayoola Anambra State Govo, Professor Chukwuma Soludo, for Onitsha on Monday don order im mehn to lose Onitsha Main Market for one week say traders no follow state gornment order to ignore Monday sit-at-home. Soludo give di directive during on-site visit to the market as e move with aides and other government officials. He warn say dem fit extend the closure if traders still refuse to comply, as security agencies don seal di market to enforce di order. […]

todayJanuary 26, 2026 23

Lagos

Police, PSC Extend Recruitment Say Mehn Nor Dey Turn Up

By: Esther Ayoola Di Police Service Commission (PSC) and Nigeria Police Force for Nigeria don extend dia recruitment programme of 50,000 police constables, say dem don add two weeks based on some states, including Lagos, dey record low application. PSC Head of Protocol and Public Affairs, Torty Kalu, tuk dis one on Monday, say extension dey follow receipt of over 400,000 applications nationwide and uneven participation across states. Di online application wey open on December 15, 2025, wey suppose close […]

todayJanuary 26, 2026 15

National

Governor Adeleke Drop Report Card, Say Former Govo Dey Block Progress

By: Esther Ayoola Osun state govo, Ademola Adeleke don show report card on why Osun state local gorment council never truly see beta change, wey dem desire, say na former gorment ni dey frustrate dem Di Govo yarn dis one for TV sit don tuk on Monday, giving report of di state of things for Osun ahead of di Osun state governorship election Im say All progressives’ councillors for di state even threaten for social media say dem go continue […]

todayJanuary 26, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds