Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Gorment, Private Sector Collabo To Boost AI Use For Nigeria

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don decide to join hand with private sector to hellep fast-track Artificial intelligence, AI, use for di obodo Nigeria. Dem say di way technologia dey waka wawawa, say, if gorment nor dey careful, say person go lose control. Commissioner for Energy and Mineral Resources, Biodun Ogunleye, yan dis one for corner coner tuks for di 2026 tecnologia conference wey dem title “AI in Action Now”, say gornment go create beta environment and use partnership […]

todayJanuary 27, 2026 14

Lagos

Lagos Gorment Set To Hammer Drainage Spoilers For Lekki Area

By: Esther Ayoola Lagos State goment don cut chain, say dem go change am for any kain person wey go block drainage and break environmental law for Lekki, just to hellep protect di area from flooding. Environment Commissioner Tokunbo Wahab yarn dis one as e dey inspect drainage work and flood areas for Ogombo, Ikate, Mobil Road and other nearby communities. Wahab say dem get correct informate, say, some pipo wan tamper with major drainage System 46, and dey warn […]

todayJanuary 27, 2026 24

National

Soun, Alaafin Comot Bodi For Oyo State 50 Years Anniversary

By: Esther Ayoola Two big traditional rulers for Oyo State, Soun of Ogbomoso, Oba Olaoye Ghandi and Alaafin of Oyo Oba Akeem Owoade, ni comot bodi for Governor Seyi Makinde celebration of Oyo state at 50 on Monday. Plenty important pipo like family members of former govos, traditional and religious leaders, gornment oga dem and political big men gather for International Conference Centre, Ibadan, to mark di celebration. Oyo State wey dem create on February 3, 1976 from old Western […]

todayJanuary 27, 2026 14

National

Ilu-Abo Residents Block Highway Over Gunmen Killings, Abductions

By: Esther Ayoola Say Some Pipo from Ilu-Abo community for Akure North Local Gornment Area for Ondo State scata ground yesterday, dey protest say, di way pipo take dey kpai, kpai and jaguda boys kidnaping dia pipo don tire dem. According to report, Dem block Akure-Owo-Benin highway to make gornment hear wetin dey happen and say security nor dey shake bodi for di mata. One protester, wey name na Lawrence, say, di fear for di community nor be small, because […]

todayJanuary 27, 2026 22

National

President Tinubu Land Ankara For State Visit

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don land for Ankara, capital of Turkiye, for state visit. Im plane touch ground around 9:03pm, local time, and Turkish gornment pipo wey Minister of Education, Yusuf Tekin lead, ni welcome am for Airport. Nigerian embassy pipo for Turkiye, including Chargé d’Affaires Ambassador Zayyad Abdulsalam, join receive President Tinubu. Untop corner, corner yarnings with tori pipo, Yusuf  say Baba seyi  entering Türkiye  na for business

todayJanuary 27, 2026 15

National

APC Konfamate Dat Shettima Remain Tinubu Running Mate For 2027

By: Esther Ayoola Di All-Progressives Congress don clear mata say APC nor get plan to change Vice Presido Kashim Shettima as Bola Ahmed Tinubu running mate for 2027. Na APC publicity secretary, Felix Morka, tuk dis one for TV sit don tuk on Monday. According to Morka, law nor permit dem to start serious election mata for now but di yarnings of changing oga vice presido, na okpata yarnings.

todayJanuary 27, 2026 13

National

Abba Yusuf Explain Why Im Rejoin APC For Kano

By: Esther Ayoola Kano State Govo, Abba Yusuf, don officially return back to All Progressives Congress (APC) on Monday for Coronation Hall inside Kano state gornment House. Big party leaders like former APC National Chairman and former-Kano State govo, Abdullahi Ganduje, Deputy Senate Presido, Barau Jibrin, and Minister Yusuf Ata receive am alongside otherleaders. Governor Yusuf tuk say, im decision na because, e wan work more closely with Federal Gornment under President Bola Tinubu.

todayJanuary 27, 2026 14

National

Court To Decide Minister Wike Fate Today

By: Esther Ayoola National Industrial Court for Abuja don fix today (Tuesday) to give ruling for one case wey FCT Minister, Nyesom Wike, and FCT Administration carry go court against leaders of Joint Union Action Committee (JUAC). Justice E.D. Subilim hear argument from both sides before e adjourn di mata for last sitting. Wike and FCTA dey ask court, make e stop JUAC Chairman Rifkatu Iortyer and Secretary Abdullahi Umar from any strike, picketing or lockout. Di strike wey start […]

todayJanuary 27, 2026 20

National

CDS Insist Army Must Dey People-Centred, Protect Civilians

By: Esther Ayoola Di Chief of Defence Staff, Gen. Olufemi Oluyede, don repeat tuk say Nigerian Armed Forces go dey people-centred, ethical, and accountable. Im yan dis one for Human Security and Gender Advisers Course wey hold for Abuja through Maj.-Gen Ibrahim Lassa. Gen. Oluyede tuk say, security wahala dey complex, with terrorism, communal fight, transnational crime and humanitarian issues wey dey affect ordinary people everyday. According to Oluyede, di force, dey focus on human security, protect lives, respect human […]

todayJanuary 27, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds