Blog masonry

Background

National

Atiku Reject Fake News, Say E Never Comot For Politics

By: Esther Ayoola Former Vice Presido Atiku Abubakar don raise alarm, say haters dey drag am wetin nor good which be say im don retire from politics For statement wey im media aide Paul Ibe drop for X on Monday, Atiku say di rumor wey dey spread for social media say im comot politics, say na big lie Di senior man say im mout di African Democratic Congress progress for di 2027. Atiku come make am clear say if im […]

todayMarch 30, 2026 3

National

NNPP to Join Hand With ADC For 2027 Election

By: Esther Ayoola Di New Naija Peoples Party (NNPP) don declare say dem go form collabo with African Democratic Congress (ADC) for 2027 presidential election. Dis na according to a statement by di NNPP National, tuk tuk person, Ladipo Johnson, on Monday. Johnson say even though Rabiu Kwankwaso, former NNPP 2023 presidential candidate, don leave di party join ADC, NNPP  go sti contest di  elections. Say however, for presidential level, say dem go joinbodi with di ADC.

todayMarch 30, 2026 4

National

Plateau Gorment Put 48-Hour Curfew For Jos North Following Jaguda Boys Attack

By: Esther Ayoola Plateau State Gornment don impose 48-hour curfew for Jos North LGA afta Sunday attack for Angwan Rukuba wey kpai plenty pipo and wunjure odas. Commissioner for Information, Rt. Hon. Joyce Lohya Ramnap naim announce am, say di curfew start from yesterday midnight March 29 and e go reach April 1, 2026. For reaction, Governor Caleb Manasseh Mutfwang condemn di attack as “barbaric and unprovoked” and assure say security agencies dey mobilised to restore peace and gbag di […]

todayMarch 30, 2026 6

obodo oyinbo

Russia Kick UK Diplomat Say Im Dey Spy On Russia

By: Esther Ayoola Russia don order British diplomat Albertus Gerhardus Janse Van Rensburg to leave Moscow afta dem accuse am say e dey do spy work According to FSB security service report on Monday, di 29-year-old embassy secretary dey accused of “subversive intelligence activities wey fit threaten Russia security,”. Russian foreign ministry tuk say dem don call Britain charge d’affaires come warn dem wella dat if dem do dem wetin UK do, dem nor go like am. Britain embassy never […]

todayMarch 30, 2026 4

Sports

Tristan Xerri Chop 3-Match Ban Afta E Rub Nose Blood For Oda Player Face

By: Esther Ayoola North Melbourne player Tristan Xerri don collect three-match ban afta e use im nose blood rub Andy McGrath face for match wey dem play on Saturday. Di incident hapun afta Xerri score goal, come get small fight with McGrath before e wipe di blood, something wey officials call “disgraceful behaviour.” For tribunal, Xerri tuk say dem insult am call am “weak c-word,” naim make e lose im temper do wetin e do. But e sti accept say […]

todayMarch 30, 2026 3

Sports

Spurs Set Eye For Roberto De Zerbi After Igor Tudor Sack

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don begin chase for Roberto De Zerbi to become dia new coach afta dem sack Igor Tudor. Tudor stay for only 44 days before bad results push di club close to relegation zone for Premier League. Reports say De Zerbi, wey don leave Olympique de Marseille since February, don show interest to take di job immediately. Inside Tottenham Hotspur camp now, dem believe say e fit join to hellep stabilize di team before season finish.

todayMarch 30, 2026 5

Sports

Quadri Aruna Get Tough Opponents For 2026 ITTF World Cup In Macao

By: Esther Ayoola Say Quadri Aruna gat play strong match and gat ready for 2026 ITTF World Cup wey go shelle for Macao, China from March 30 reach April 5. Dis year tournament get special meaning as International Table Tennis Federation dey celebrate 100 years, with 48 men and 48 women dey compete for Evans and Hammarlund Cups. Aruna sti be di only African wey don reach World Cup quarterfinal since 2014 for Düsseldorf, Germany, dat time, e win ITTF […]

todayMarch 30, 2026 8

Sports

Tottenham Hotspur Sack Igor Tudor Afta 7 Games

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don comot dia coachie Igor Tudor afta di both of dem agree to terminate im contract Asap. Tudor manage dem only for seven matches, lose five, wey make Spurs dey struggle and just one point above relegation zone for Premier League. Dem also don drop out from Champions League race as results no dey favor dem at all. Club tuk say na mutual agreement, but e hapun afta dem lose 3-0 to Nottingham Forest and […]

todayMarch 30, 2026 4

Sports

CAF Increase Africa Cup Of Nations To 28 Teams

By: Esther Ayoola CAF Presido, Patrice Motsepe, say like dis now, say dem wan increase di Africa Cup of Nations teams from 24 to 28 wey go dey play di AFCON. E tuk dis one for press conference on Sunday afta CAF executive committee meeting for Africa, say di change na to turn Africa football to  world-class football. Motsepe nor explain how di tournament go fit take di extra four teams or when di new format go start. Before now, […]

todayMarch 30, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app