Blog masonry

Background

Lagos

FG Go Lock Lagos-Calabar Road In 2 Weeks

By: Ayobami Dada Federal Controller of Works for Lagos State, Olufemi Dare, yarn on Monday say di Federal Government fit close di Lagos section of Lagos-Calabar Coastal Highway within two weeks if drivers and oda road users no obey safety rules. Dare tok dis was as e go for inspection of di highway for Lagos on Monday, following order from Works Minister David Umahi because of safety problems, vandalism and illegal activities for di road. He say government dey give […]

todaySeptember 22, 2026 14

OBODO NAIJA

NSCDC Bust Illegal Juice Factory For Badagry, Gbab Two Women

Operatives of di Nigeria Security and Civil Defence Corps, NSCDC, don raid illegal juice factory for Aradagun area of Badagry, Lagos, and arrest two women. Di factory wey dem dey produce drink wey dem call Barkas Juice, dey Talabi Onilegbale Street, Aradagun, Olorunda LCDA, and NSCDC operatives discover am on September 19, 2026, around 9pm. Di two women, aged 48 and 50, bin dey di factory when NSCDC operatives from Badagry Divisional Headquarters arrest dem, as di Corps allege say […]

todaySeptember 22, 2026 15

Lagos

Lagos Goment Warns Say Adulterated Palm Oil Full Market

By: Mariam Ajayi Lagos State Gornment don warn pipo say contaminated palm oil dey enter markets across di state, as LASCOPA urge consumers make dem dey careful. Dr Nurah Oseni from Auchi Polytechnic explain for Lagos State Food Safety Conference say some sellers dey use harmful dyes, recycled cooking oil and other adulterants to change di colour and quality of palm oil. Oseni advise consumers say make dem no depend only on colour to judge palm oil, as she call […]

todaySeptember 21, 2026 22

OBODO NAIJA

Niger Gornment Wan Lift Curfew For Minna

By: Mariam Ajayi Niger State Gorment don lift di curfew wey dem impose for Minna, after days of tension and unrest over di death of 37 pipu wey dey NSCDC custody. Na Gofnor Umaru Bago announce di decision on Sunday, September 20, during a three-day prayer for di victims. Di curfew bin come after protests and destruction of property following di deaths, while touchlighting sti dey go on to find out exactly how di 37 pipu kpai for custody. Bago sti […]

todaySeptember 21, 2026 13

Sports

BBC Sport Rate Premier League Teams After Five Games

By: Mariam Ajayi Premier League don enter im first international break for 2026/27 season after teams don play five matches with different performances. Brighton get rating of nine out of ten after dem score 16 goals for five matches, while Brentford get eight out of ten and remain unbeaten. Arsenal get seven out of ten, while Aston Villa, Bournemouth and Chelsea get six out of ten as dem still get plenty work to do before league resume.

todaySeptember 21, 2026 16

OBODO NAIJA

We Don Handle Election Problems Before Election Day

By: Mariam Ajayi INEC Chairman tok say any administrative or field palava wey show before election day, di Commission don already tackle am from di beginning. E make di statement as e dey explain how INEC prepare to make sure say di election process run smoothly. According to am, di Commission no wait make di problems become bigger before dem take action.

todaySeptember 21, 2026 21

obodo oyinbo

Trump Threatens Iran Say Economy Fit Destroy

By: Mariam Ajayi US Presido Donald Trump don warn Iran say if dem no reach agreement with America, e fit  wipe Iran out or make dia economy rot. Trump give di warning during Fox News interview on Sunday, as tension dey rise ahead of United Nations General Assembly for New York dis week. Meanwhider, Iran military don warn say any fresh US attack go bring painful retaliation across Middle East, with American positions and any regional country wey support di […]

todaySeptember 21, 2026 22

Sports

Valverde Injure After Madrid Derby Loss

By: Mariam Ajayi Real Madrid don suffer serious blow after dem lose 2-1 to Atlético Madrid for LaLiga on Sunday. Di club confirm say dia captain, Fede Valverde, injure im ankle after Atlético player Kang-In Lee tackle am hard during di match. Referee no give any punishment for di tackle, as Valverde injury now add to Real Madrid worries after di derby defeat.

todaySeptember 21, 2026 17

OBODO NAIJA

Naija Go Put National Interest First for UN Meeting

By: Mariam Ajayi Vice Presido  Kashim Shettima don reach New York to represent Presido Bola Tinubu and lead Naija delegation for di 81st United Nations General Assembly. Shettima say Naija go follow dia national interest and support multilateralism as e dey meet world leaders for di UN meeting. E also say Naija go push for reforms wey go make global institutions more fair, representative and responsive to today economic and population realities.

todaySeptember 21, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds