Blog masonry

Background

Politics

APM Rake Say Osun Election na sign Tinubu Nor get level for 2027

By: Kofoworola Olayinka Allied People Movement, APM, say di outcome of di Osun gofnorship election show say President Bola Tinubu no get easy road ahead for di 2027 presidential election. APM National Publicity Secretary, Yusuf Abubakar, say Nigerians no go support any political party wey fail to perform, whether di party strong or not. Di party say APC leadership and its national support for Bola Oyebamiji during di Osun election no stop Gofnor Ademola Adeleke from winning di poll. Adeleke […]

todayAugust 17, 2026 13

Lagos

How NDLEA kramp Businessman With 1.55kg Cocaine For Lagos Airport

By: Kofoworola Olayinka NDLEA don kramp 48-year-old businessman, Nwankwo Onyebuchi, with tins, 1.55 kilogram cocaine hide am inside di bag, wan bin fly from Lagos airport. NDLEA, Femi Babafemi na im yarn dis mata say dem arrest di man for departure hall of Terminal II. Babafemi say Onyebuchi, wey dey do marble business for Lagos, as im enter airport, na dem suspect am, dem search con see exabits

todayAugust 17, 2026 12

Local

FG To Put 3,700 New Network Towers For Rural Areas

By: Kofoworola Olayinka Federal Gornment don start plan to build 3,700 telecom tower for villages across Nigeria. Communication Minister Bosun Tijani yarn this on Sunday for Ogboghoro Community, Delta State. He say di project go help bring better network to hard-to-reach riverine areas and connect more Nigerian to internet. Tijani say President Bola Tinubu approve di plan as part of gornment effort to build a $1 trillion economy.

todayAugust 17, 2026 13

Business

Sanwo-Olu Begs Youths To Embrace Technology, Integrity In Business

By: Kofoworola Olayinka Lagos State Gofnor Babajide Sanwo-Olu on Tuesday urge young Nigerian to combine technology with integrity, as he speak through Commissioner for Finance Abayomi Oluyomi at a CIBN event for Lagos. Sanwo-Olu say young innovator, fintech entrepreneur and remote worker dey contribute to Nigeria economy, but warn say technology without discipline and integrity fit damage trust for financial sector. Di gofnor say Lagos State Employment Trust Fund don give over N15 billion loan to more than 20,000 small […]

todayAugust 17, 2026 13

International

Russia Demands US, Turkey Explain Weapons To Ukraine

By: Kofoworola Olayinka   Russia on Tuesday demand explanation from United States and Turkey over possible weapon shipment to Ukraine, after US Congress documents reveal rocket, cluster munition and ATACMS missile   Foreign Ministry spokeswoman Maria Zakharova say Moscow wan know who arrange di shipment, how dem go transport am and when e go reach Ukraine.   She accuse US and Turkey of bias, warning say more weapon no go change Russia military operation but fit worsen relation between di […]

todayAugust 17, 2026 15

Business

Nigeria-China Trade Hits $18bn, Aquatic Deal Unlocks Chinese Market.

By: Kofoworola Olayinka Minister of State for Industry, Trade and Investment John Uwajumogu say Nigeria-China trade don reach $18 billion for first half of 2026, up from $28 billion recorded for di whole of 2025, as both countries deepen business relations. Uwajumogu urge Nigerian exporters and businesses to take advantage of new access to di Chinese market through implementation of di aquatic products protocol. Chinese Ambassador Yu Dunhai say Nigerian exports to China rise by 80 per cent for di […]

todayAugust 17, 2026 16

Uncategorized

Why Adeleke Beat APC Again For Osun

By: Kofoworola Olayinka   Gorfnor Ademola Adeleke win Osun gofnorship election on Sunday with 511,067 vote against APC candidate Bola Oyebamiji’s 444,815 vote, as di result show say APC lose di state for di second time in four years. Di victory come after APC internal division, Adeleke regular salary payment and support from former deputy gorfnor Iyiola Omisore and music star Davido reportedly boost his campaign across di state. INEC and security agencies also receive commendation for conducting di election, […]

todayAugust 17, 2026 14

Politics

2027: Accord, AAC, SDP Candidates Unite Against Tinubu

By: Kofoworola Olayinka Accord, AAC and SDP presidential candidates on Sunday agree for Port Harcourt to work together against President Bola Tinubu ahead of di 2027 election. Gbenga Olawepo-Hashim, Omoyele Sowore and Adewole Adebayo say dem wan form a common opposition force to strengthen democracy and challenge political power. Di candidates say dem go mobilise youths, workers, women and other Nigerians, while dem dey plan how to structure di agreement and choose dia joint presidential candidate. Dem also call for […]

todayAugust 17, 2026 10

south west

Adeleke Collobi Second Term, Beat APC Candidate Oyebamiji by 66,252 Votes

By Ebi Oboko Gofnor Ademola Adeleke don win Osun State gofnorship election again after e collect 511,067 votes for Saturday election. Di Returning Officer, Professor Joshua Ogunwole, announce di result for INEC Collation Centre for Osogbo early Sunday morning. Adeleke, wey contest under Accord Party, beat im closest challenger, APC candidate Bola Oyebamiji, wey get 444,815 votes. With di result, Adeleke get winning margin of 66,252 votes ahead of Oyebamiji. ADC candidate Najeem Salaam come third with 17,180 votes. Adeleke […]

todayAugust 16, 2026 64 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds