Blog masonry

Background

National

Iran Set Conditions For Opening Strait Of Hormuz, Demands US Action

By: Kofoworola Olayinka Iran top negotiator Mohammad Bagher Ghalibaf don say di country no go open di strategic Strait of Hormuz until United States meet dia demands. Ghalibaf talk on Tuesday say America must remove di naval blockade, lift oil sanctions and unfreeze Iran money wey dey abroad before di strait fit reopen. E say di demands dey inside di Iran-US truce wey dem a

todayAugust 19, 2026 14

crime& security

NDLEA Bust Cocaine Cartel, Arrest ‘KC Luxury’ As E Try Run From Nigeria

By: Kofoworola Olayinka NDLEA don bust one international cocaine cartel wey allegedly dey use Nigeria as road  to move illegal drugs go UK, Europe and Asia. According to report say dem  arrest di alleged Nigerian leader of di group, social media influencer Afolabi Kazeem Michael, aka KC Luxury. NDLEA Chairman, Brigadier General Mohamed Buba Marwa, yarn dis one for Lagos on Tuesday, Di agency say e arrest am as e dey try comot Nigeria, while dem seize 184.50 kilogramme of […]

todayAugust 19, 2026 11

OBODO NAIJA

Davido Hail Adeleke Re-election, Say Other Govos Fit Learn From Am

By: Kofoworola Olayinka Afrobeat singer Davido on Tuesday hail him uncle, Osun State Gofnor Ademola Adeleke, after e win di gofnorship election for second term, saying di victory na victory for di pipo. Davido talk dis one for press conference for Osun, where e say Adeleke work and performance suppose serve as example to other gofnor and public officials. Di singer also praise Osun voter for standing firm and protecting dia votes throughout di election process. Davido yarn di result […]

todayAugust 19, 2026 12

Sports

Dana White Tell Joshua And Fury to Behave Demsleves

Zuffa Boxing boss Dana White don raise doubt over Anthony Joshua and Tyson Fury fight, saying di heavyweight clash suppose don happen 10 years ago. White say although Joshua and Fury don sign contract to fight earlier dis year, say make dis boxers nor carry boxing fans play oh According to reports, Netflix want make di fight happen for New York on November 20, but Joshua and im promoter Eddie Hearn dey push for di fight to hold for United […]

todayAugust 18, 2026 10

obodo oyinbo

Ebola Outbreak Don Become DRC Deadliest Ever

World Health Organisation, WHO, say di Ebola Bundibugyo outbreak for Democratic Republic of Congo, DRC, don kill 2,325 people, making am di deadliest Ebola outbreak di country don ever record. WHO tuk dis one on Monday, saying di number don pass di 2,299 deaths wey dem record during di 2018 to 2020 outbreak. Di outbreak wey gornment declare on May 15 don record 4,945 confirmed cases, while 730 people still dey isolation or hospital and 1,040 don recover from di […]

todayAugust 18, 2026 14

OBODO NAIJA

Dele Momodu Say Tinubu Fail Beta Style For Osun Election

ADC chieftain, Dele Momodu, don describe Gorfnor Ademola Adeleke victory for di Osun gorfnorship election as sabi man doings say oga Presido Bola Tinubu, and di All Progressives Congress, APC nor get level. Im fry dis mata for TV sit down tuk on Monday, Momodu say di result suppose make APC guige dia guard, if not dem go cry. Momodu, wey support Adeleke before di election, talk say di contest na mainly between Adeleke and Tinubu influence, but e show […]

todayAugust 18, 2026 11

Lagos

Customs Hand Over 399 Seized Rifles To NSA

Nigeria Customs Service, NCS, don hand over more dan 399 seized rifles to di office of National Security Adviser, Nuhu Ribadu, as part of efforts to stop illegal arms movement for di country. Customs boss, Adewale Adeniyi, talk on Monday say di service don finish examination of di arms wey dem seize for Tincan Island Port, where dem find 399 fully assembled Jojef firearms plus plenty rifle parts. Adeniyi warn say criminal networks fit try use Nigeria borders, ports and […]

todayAugust 18, 2026 10

Entertainment

Must Read: Celebrity Break Up – Frank Edoho Story

Written by: Kofoworola Olayinka   Make we talk truth oooo, when celebrity love break, everybody go hear am. Celebrity breakup no dey ever dey quiet, once social media catch am like dis, di whole internet go turn microphone. For Naija entertainment, we don see plenty celebrity marriages wey start with love, glamour and beautiful pictures, but later end with breakfast and public drama. Make we give enter di mata wey sup between Frank Edoho and him second wife, Sandra Onyenucheya. […]

todayAugust 17, 2026 124 270

Sports

Rodri Go Wear Number 16 Jersey For Barcelona

Spain international and Manchester City midfielder, Rodri, go wear number 16 jersey for Barcelona after e ask Fermín López make e give am di number. Na Football transfer expert, Fabrizio Romano, reveal say Rodri don already discuss di matter with Fermín, wey go switch to number 7. Rodri dey set to join Barcelona from Manchester City and e go sign four-year contract wey go keep am for Camp Nou till June 2030.   Read similar stories:https://konfamfm.com/maresca-say-man-city-problem-no-be-only-because-rodri-no-play/

todayAugust 17, 2026 20 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds