Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Iran Dey Fear To Admit Say Dem Want Peace Deal- Trump Yarn

Donald Trump talk on Wednesday for Republican lawmakers dinner for Washington DC say Iran dey secretly negotiate peace deal with di United States. Trump claim say even though Abbas Araghchi don earlier deny talks, Iranian officials still dey find way to make agreement. According to am, dem no dey admit am publicly because dem fear say their own people or even US fit harm dem. Di statement come as tension still dey between both countries, with talks aimed at reducing […]

todayMarch 26, 2026 6

OBODO NAIJA

Troops Gbab 98 Illegal Miners For FCT

Troops of 176 Guards Battalion arrest 98 people wey dey do illegal mining for Gwagwalada Area Council, FCT on March 23. Zagazola Makama post for X say di raid happen around 5:55 p.m. after intelligence show illegal mining dey go on for di area. Troops storm di site, catch di suspects without wahala, and recover vehicle, motorcycles, pumping machines, shovels, sledgehammers, and other mining tools. Di arrested miners don hand over to Guards Brigade Provost Group for further investigation and […]

todayMarch 26, 2026 8

OBODO NAIJA

How Women Form Vigilante Team For Plateau State

Some group of women based on gbege for area for Jos don form vigilante group as jaguda boys no allow dem drink water keep cup dey patrol streets for night. Di group oga, Blessing Ngozi Emmanuel, ni yan pipo dis update on Wednesday, on how e take dey do dem for di Jos. She press tuks on how both Christian and Muslim women take dey do collabo, sacrifice dia comfort to protect dia children and communities. According to her, di […]

todayMarch 26, 2026 10

Lagos

Tanker Driver Run Comot As E Kpai One Pesin For Lagos

One tanker driver don run comot after e motor jam one dispatch rider for Cele Bridge area along Apapa–Oshodi Expressway for Lagos on Wednesday. LASTMA tuktuk, Taofiq tok say di HOWO tanker wey carry diesel dey move when e jam di bike, crush di rider under di motor. Di impact strong well-well as di rider die sharpaly for di spot before help fit come. Authorities still dey find di driver wey run, as dem dey investigate wetin cause di crash […]

todayMarch 26, 2026 15

Lagos

NDLEA, Customs Join Hand Wella To Fight Drug Trafficking

Fight against drug trafficking don gain weight as National Drug Law Enforcement Agency and Nigeria Customs Service join bodi together for Kirikiri Lighter Terminal for Lagos on Wednesday. New NDLEA Tincan Strategic Commander, Solomon Gbadebo Omotosho, na im lead delegation go visit Customs command to strengthen cooperation. Acting Customs Area Controller, Bolaji Lukman Adigun, say di partnership go help secure ports better and balance enforcement with smooth trade. Dem say di move necessary because drug traffickers dey use Nigerian ports […]

todayMarch 26, 2026 10

Sports

Super Eagles World Cup Dream Finally End As Playoffs Start Today

Nigeria Super Eagles don finally miss out from di 2026 World Cup, say world cup playoff dey start today. Now teams dey prepare for play-off wey go start for Mexico today, where six countries dey fight for two spots. U sabi say DR Congo beat Nigeria 4-3 on penalties last November for African play-off final for Morocco. Even with dat loss, NFF still dey try appeal because dem claim DR Congo use ineligible players, however FIFA nor reason di mata.

todayMarch 26, 2026 4

obodo oyinbo

Make Una Stop Di War – Guterres Yarn

UN Secretary-General António Guterres don sama warning  say di war wey United States and Israel dey fight Iran don dey out of hand. Im yarn dis on Wednesday for New York, say e dey urge all sides make dem step back and try settle di mata wit diplomacy. Guterres explain say di conflict don spread pass wetin leaders bin expect, and e fit cause plenty suffering and economy wahala. E sti press tuk oh, say chance still dey to make […]

todayMarch 26, 2026 6

OBODO NAIJA

Navy, Police Join Hand, Vow To Rascal Insecurity

Nigeria Navy and Police don agree say dem go work closer together to fight security wahala wey dey grow for country. Na for one join bodi meeting  for Abuja, Police oga Olatunji Disu meet Navy boss Idi Abbas, yarn dis one Di Navy promise say dem go continue to support joint operations and even train Marine Police for dia facilities. Oga IGP thank di Navy for dia support, especially for maritime security and tough operations wey dem dey face.

todayMarch 26, 2026 6

OBODO NAIJA

ADC Tackle APC Over Security Wahala

African Democratic Congress don accuse di All Progressives Congress say  dem don make insecurity worse for country. ADC chairmo, David Mark and tuk, tuk Bolaji Abdullahi ni tuk dis one on Wednesday for NEC meeting wey  dey hold for Abuja. According to di two senior men  gornment never handle security mata wella, explaining how dem wan take parrol for 2027.

todayMarch 26, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app