Blog masonry

Background

Sports

Must Read: Di Reason Why Man United Comot For Carabao Cup

First Half As we enter di 10th minutes for Manchester United Carabao Cup match against Brighton, everything dey shine shine for United as Young winger,  Shea Lacey tear net with debut goal. Mason Mount follow am two minutes later with better volley wey bounce for ground before e touch net, and united dey lead 2-0, Old Trafford dey shake, and di night dey look like another step forward for Michael Carrick as him wan show more workings and doings on […]

todaySeptember 18, 2026 22

Politics

Atiku: High Food, Fuel Price Dey Make Life Hard for Families

By: Kofoworola Olayinka Former Vice-Presido Atiku Abubakar say high food, fuel and transport prices dey make am hard for plenty Naija families to afford good food, as he talk on Naija cost-of-living palava. Atiku say rising cases of child malnutrition na one of di major signs say many families dey struggle with di high cost of living across Naija. Di former Vice-Presido make di statement as food, fuel and transport costs continue to rise, making everyday needs more expensive for […]

todaySeptember 18, 2026 21

obodo oyinbo

Iran Guards Say Dem Attack Oil Tanker for Strait of Hormuz

By: Kofoworola Olayinka Iran Revolutionary Guards don tok say dem strike one oil tanker for Strait of Hormuz on Friday, according to Iranian state news agency IRNA. One British maritime agency too report say attack happun. Iran still dey control movement for the strategic Strait of Hormuz as United States continue to put pressure on Iranian ports during the ongoing Middle East war. The Islamic Republic say e want make ships pay to pass through the waterway. Iran also dey […]

todaySeptember 18, 2026 13 3

Politics

Toyin Abraham Says Politics No Be Her Mata

By: Kofoworola Olayinka Nollywood actress Toyin Abraham don reject the report say dem put her name for Lagos APC Campaign Council ahead of di 2027 election, saying she no dey involve for any campaign council. Abraham, wey dem reportedly list under Entertainment and Creative Economy Directorate, make di clarification for her Instagram Story and tell di public make dem disregard di report. Di actress say she dey stay away from politics, despite say she previously support Presido Bola Tinubu during di 2023 […]

todaySeptember 18, 2026 14

metro

Speedboat Sink for Ibaka, Police Rescue Two

By: Kofoworola Olayinka One speedboat don sink for Ibaka waterways, Mbo Local Gorment Area of Akwa Ibom State, on Thursday, September 18, 2026, as police rescue two pipu wey dey inside di boat. Di blue W23 speedboat, wey dem mark LET’S PRAY, dey travel from Oron go Cameroon with goods around 1:30 p.m. on Thursday, when di boat run into trouble for water. Akwa Ibom State Police tok-tok person, DSP Timfon John, say preliminary investigation show say di driver, wey […]

todaySeptember 18, 2026 11

Politics

Odii Promise To Fix Ebonyi Key Sectors

By: Kofoworola Olayinka PDP gofnorship candidate for Ebonyi State for di February 6, 2027 election, Dr Ifeanyi Odii, don promise say if e win, e go fix di state health, education and farming sectors. Odii tok say Ebonyi na pipu own, so pipu suppose get strong voice for how dem dey run di state, as e question why na only few pipu go dey decide wetin go happun to over five million Ebonyians. E make di promise during meeting with […]

todaySeptember 18, 2026 12

Sports

Osimhen Surprise Inclusion for Super Eagles AFCON Qualifiers

By: Mariam Ajayi Super Eagles head coach, Éric Chelle, don shock plenty football fans as e include injured Victor Osimhen for Naija squad wey go play 2027 AFCON qualifiers. Osimhen don dey out since September 4 after e pick groin injury during Galatasaray match. Even with the injury, Chelle still call am up as Super Eagles prepare to face Madagascar for Uyo on September 25 and Guinea-Bissau on September 29. E no mean say Osimhen don fully recover or must […]

todaySeptember 18, 2026 15 2

OBODO NAIJA

Police Beg Naija People Make Dem No Attack Policemen

By: Mariam Ajayi Cross River State Police Command don beg Nigerians make dem respect police officers wey dey do dem lawful duty. Police PPRO, ASP Sunday Eitokpah, tuk say police uniform na symbol of public authority, but pipo dey inside the uniform too. Dem dey risk dia lives every day to answer emergency calls, prevent crime, protect lives and property, and maintain peace. E warn say assault, block or resist policemen violently no good, as e fit weaken respect for […]

todaySeptember 18, 2026 18

OBODO NAIJA

RMAFC Reopen Oil Well Check Over 13% Benefit Mata

By: Mariam Ajayi RMAFC don reopen verification of disputed and newly drilled oil and gas wells across Naija, as oil producing states dey argue over 13 per cent benefit fund. RMAFC Chairman Mohammed Bello Shehu tuk say dem don drop di old report after states raise complaints, so new team go check well locations, maps and boundaries from 2017 reach now. Officials from RMAFC, NUPRC, National Boundary Commission and Surveyor-General office go inspect di wells and documents to make revenue […]

todaySeptember 18, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds