Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

 FG Tell Nigerians For South Africa Not To Fear, Say Dem Dey With Dem

Federal Gornment don assure Nigerians wey still dey South Africa say dem safe, even as fresh xenophobic protest don raise fear across di country. Another 269 Nigerians wey government evacuate don land Lagos from Johannesburg, while reports say gunmen kill one Nigerian businessman wey dem sabi as Big Joe for Mpumalanga. Thousands of South Africans march for different cities, dey demand make undocumented foreigners comot, as police deploy security to stop violence. Even though police say most of di protests […]

todayJuly 1, 2026 10

obodo oyinbo

Heatwave Kill Over 1,000 People For Spain

More than 1,000 pipo don kpai for Spain because of di recent heatwave wey roast Europe. Spain Carlos III Health Institute konfam dat at least 1,028 pipo naim don kpai from heat-related sickness during di extreme hot weather. Di death figure double di 407 deaths wey Spain record for June 2025, wey bin be di hottest June before. Weather agency Aemet also confirm say di first six months of 2026 na the hottest ever for Spain, with temperature averaging 1.6 […]

todayJuly 1, 2026 9

Sports

England check body say dem Nor Go Underrate DR Congo

Unto world cup update, England go face DR Congo on Wednesday for World Cup Round of 32 as dem dey fight to qualify for last 16. England coach Thomas Tuchel warn say make im players no underrate DR Congo, even though England na di favourites, inside dis competition big teams don see shege banza. England go depend on Jude Bellingham and Harry Kane to deliver, but defender Reece James no go play because of wunjury.

todayJuly 1, 2026 8

obodo oyinbo

China Wash Hand Comot From World Bank Loan

Di World Bank don konfamate say dem dey enter new phase for dia relationship with China, say China don dey wash hand comot for loan mata small, small. One World Bank official konfam how ogbonge development dey cry for China based on di ogbonge support wey dem get from di world bank. Di official add say di new relationship dey reflect how China economy and development dey grow vavava dan normal, say dem put all di money wey dem take […]

todayJuly 1, 2026 9

OBODO NAIJA

Fuel Sellers Say Dem Go Lock Pump If FG Control Price

Problem dem say e nor dey finish oh, dat Fuel marketers don sama beta warning give federal gorment say, if dem get two head, try am, control dia petrol pump price, dem go luck filling station. Oga tuk, tuk, IPMAN, di fuel sellers, Chinedu Ukadike, naim use im yamchop mouth tuk dis one, say dem nor go accept any policy wey go force dem sell fuel for fixed price. Di warning come after Minister of State for Petroleum Resources (Oil), […]

todayJuly 1, 2026 9

OBODO NAIJA

First Lady, Oluremi Launch Food Bank For Jigawa To Fight Hunger

Naija First Lady, Senator Oluremi Tinubu, aka, na awa mama be dis, don go show motherly love launch North-West National Community Food Bank for Hadejia inside Jigawa State to fight hunger and malnutrition. She talk say dis ogbonge program na to hellep take care of  small pikins, pregnant women, and mothers wey dey breastfeed for ijgawa Matagbon, the First Lady come beg all the state gornment-dem for the region make dem support di less privilege, say e dey very important. […]

todayJuly 1, 2026 7

Lagos

LASEPA Lock Club And Hotel For Lagos Over Heavy Noise

Environmental agency for Lagos State, LASEPA, don cut chain follow one nightclub and hotel, say dem one use obule dey blind neighbours ear. Small tin, obule, obule, obule, ahoo Di two places wey dem seal on Monday dey for Olowora and one Suites inside Alapere, Ketu. According to di statement wey di agency post for X on Tuesday, dem warn dem about niose population but di obule just dey enter head. Dis enforcement dey follow di order of di Commissioner […]

todayJuly 1, 2026 12

Sports

Mbappe And Olise Shine As France Brush Sweden

By: Yusuf Abuh France pull weight for World Cup as dem beat Sweden 3-0 on Tuesday to enter tdi round of 16 match where dem go face Paraguay. Kylian Mbappe score two goals inside di heavy match inside MetLife Stadium for New Jersey, and di first goal enter small time before half-time after France hit post two times. Michael Olise ball wetin nor good, for di match as na im give Bradley Barcola di correct pass to score the second […]

todayJuly 1, 2026 26 1

Uncategorized

Iran Give Condition As US and Qatar Jam For Doha

By: Yusuf Abuh Di Qatari Prime Minister and Foreign Minister, Sheikh Mohammed bin Abdulrahman bin Jassim Al Thani, don hold meeting with US senior men team, wey Steve Witkoff and Jared Kushner lead for Doha to touch light dis gbege for di middle east. Iran reps, sef dey inside Doha as we speak, but dem no get any plan to look eye-to-eye or hold face-to-face tuk with di US side. Di Speaker for Iran Parliament, Mohammad Bagher Ghalibaf, don repeat […]

todayJuly 1, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds