Blog masonry

Background

Politics

Osun APGA Candidate Comot for Race, Back APC Candidate

By: Esther Daniel Osun APGA gofnorship candidate, Adesina Adeyemi-Doro, don comot for di race and support APC candidate because e say na di best interest of Osun people. Adeyemi-Doro talk for One Tv show on Monday say e make di decision after serious thinking and consultation. E say e enter politics to serve people, no be just to get political office, and good leader suppose put people interest before personal ambition. Adeyemi-Doro say na why e choose to support APC […]

todayAugust 10, 2026 13

Sports

Three Barcelona Players Don Return to Training After World Cup Break

By: Esther Daniel Barcelona players Joan Garcia, Eric Garcia and Anthony Gordon don return to training for di first time after dia World Cup break, as dem begin preparation for di new season. Di three players, wey represent Spain and England for di World Cup, train for weekend alongside Gavi through gym work and ball exercises. Di rest of di Barcelona squad get rest after di triangular tournament for Udine, Italy, but dem go return for training on Monday for […]

todayAugust 10, 2026 15 4

Politics

Oyinlola Led Osun PDP Group Back Oyebamiji for Gofnor

By: Esther Daniel Former Osun Gofnor Olagunsoye Oyinlola led PDP faction don endorse APC gofnorship candidate Bola Oyebamiji for Saturday’s election, during meeting for Osogbo on Sunday, say dem want better leadership for di state. Oyinlola say dem decide to support Oyebamiji because dem no happy with Gofnor Ademola Adeleke’s gornment, especially over wetin dem describe as lack of inclusion. Oyinlola, togeda with other PDP leaders, say dem no dey leave PDP or join APC, but dem believe say supporting […]

todayAugust 10, 2026 12

obodo oyinbo

Ukraine Drone Attack Kill 12 People for Russia

By: Esther Daniel Ukrainian drone attack don kill at least 12 people and wunjure 39 others for Nizhnekamsk, Tatarstan, Russia, on Monday, as Kyiv target di energy-rich region more than 1,000 kilometres from Ukraine because of Russia’s war against Ukraine. Local officials say di attack hit near oil facility, while unverified videos show thick black smoke for di area, as both sides continue to increase long-range attacks. For Ukraine, local officials say Russian artillery attack kill five people for Bugaivka […]

todayAugust 10, 2026 13

Lagos

Oba Akiolu Beg Lagos Gorment To Empower kings

By: Yusuf Abuh Senior man, Oba of Lagos, Rilwan Akiolu, don wire beta SMS ehn, give Lagos State Gornment say make dem shine dia eyes and support traditional rulers for di obodo Lagos. Oba Akiolu make di call on Sunday inside im 23rd anniversary for di throne. Di monarch say while many traditional rulers and chiefs dey ensure say things dey go well, some bad ones don turn land grabbing, thief, thief pipo land up and down, say dem don […]

todayAugust 10, 2026 11

Lagos

How 23-Year-Old Law Student Dies After Alleged Fall From Hostel Rooftop

By: Yusuf Abuh Di Lagos State Police Command don Konfamate di death of one 23-year-old Nigerian Law School student, Faith Alayande, after she allegedly jump from di rooftop of one four-storey hostel for her school campus for Victoria Island. Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi konfam say dis mata sef reach dia office on Friday. She say di hostel head woman, report di case and explain say another student and one relative see note a wey Faith write, before dem begin […]

todayAugust 10, 2026 13

president Bola Tinubu

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Cut Chain For Religious Leaders Help Fight Terrorism And Kidnapping

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don cut chain dey ginger religious and spiritual leaders make dem preach dia preaching against jaguda boys, kidnapping, banditry and di use of religion to justify violence. Tinubu make di call on Sunday for Kano through di Secretary to di Government of di Federation, George Akume, during di Grand Maulud of Sheikh Ahmad Al-Tijani. Baba say religious leaders get important role to play for fighting violence, jaguda doings and di misuse of […]

todayAugust 10, 2026 10

obodo oyinbo

Netanyahu Rejects US Gaza Deal Say e Nor Make Brain

By: Yusuf Abuh Nor be small tin as Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu, wey be Donald Trump friend reject di US-backed Gaza peace deal. Netanyahu tell im cabinet on Sunday say Israel no go accept di 15-point document and di military no go withdraw from Gaza until Hamas truly stop dia any character wey dey cause war. He also say Israel go continue to stop any threat against Israeli soldiers and citizens despite pressure to accept di peace plan. According […]

todayAugust 10, 2026 12

Sports

Flying Eagles Crash Out from AFCON

By: Yusuf Abuh Nigeria Flying Eagles like deve collectors, don go collect 4-1 defeat from Burkina Faso Young Stallions for di final of di 2026 WAFU Zone B U-20 Championship for Ivory Coast on Sunday. Di loss mean say Nigeria no go qualify for di 2027 Africa U-20 Cup of Nations and di 2027 FIFA U-20 World Cup for Azerbaijan. Burkina Faso, wey don already beat Nigeria 2-0 for group stage, complete di double as dem join Ghana to represent […]

todayAugust 10, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds