Blog masonry

Background

Lagos

Spark From Salon Roast Things For Ikorodu And Surulere

By: Mariam Ajayi Lagos State emergency oga, Dr Olufemi Oke, don dey cry say e no fit sleep as fire don burn traders’ money and property to dust for Ikorodu and Surulere. Di first kasala happun  for early mormor Monday for Adamo Bus Stop inside Ikorodu, as bad wire spark fire inside one hair-salon wire go touch neighboring shops, burn di shop. Before di traders fit run come save ordinary comb or attachment, fire don chop three whole shops clean, […]

todaySeptember 15, 2026 14

Education

Must Read: How School Pressure Fit Affect Students

Behind some of di best results na students wey dey fight battles nobody know about. By Kofoworola Olayinka Around 2:00a.m, Oyinkansola close her textbook, just dey look ceiling. For almost thirty minutes, she don dey read di same page, but di words wey dey in front of her eyes no longer dey enter her head, her examination timetable dey hang for wall, three days remain for her hardest paper, and for her mind, three days no dey enough. Her phone […]

todaySeptember 14, 2026 64 152 2

Politics

Obasanjo Tok Say Nigeria Help End Apartheid for South Africa

By: Kofoworola Olayinka Former Presido Olusegun Obasanjo don say South Africa for struggle to end apartheid without Nigeria strong support during di gbas gbos against white minority rule. Obasanjo tok am while speaking on Naija role in di anti-apartheid struggle, saying Naija oppose di system because dem believe say no Black person suppose dey treated like inferior human being. E say  make Naija join hands with other African leaders to fight apartheid and push for equal rights for Black South […]

todaySeptember 14, 2026 15

Politics

NDC Vex Over Attack on Members for Enugu

By: Kofoworola Olayinka NDC don condemn alleged attack on dia members during one peaceful meeting for Obuoffia Ward, Enugu, saying di incident happen as dem dey gather for political activities. Di party accuse APC of being worried by dia growing support, but NDC no provide evidence to back di allegation or show who carry out di attack. NDC say di alleged attack no go stop dem from mobilising supporters across di country, as dem vow to continue dia political activities. […]

todaySeptember 14, 2026 14

Politics

Police Chief Say 2027 Election Go Secure

By: Kofoworola Olayinka Naija Police Chief, Olatunji Disu, don assure Nigerians say police go make sure everybody vote safely during di 2027 election, despite kidnapping, terrorism and election violence wey still dey worry pipu across di country. Disu tok am during one sit-down interview, saying police dey train officers well-well to handle election security and make sure voters fit cast dia votes without fear. E also say pipu for northern areas wey violence don affect go still get chance to […]

todaySeptember 14, 2026 9

Business

Dangote Refinery IPO Open as 4.1bn Shares Go for N525 Each

By: Kofoworola Olayinka Dangote Industries oga, Aliko Dangote, don officially open di Dangote Refinery IPO on Monday, September 14, 2026, for NGX trading floor inside Lagos, making am di first refinery wey go public for Nigeria stock market in 66 years. Dangote sound di closing gong to mark di start of di offer, as investors fit buy di 4.1 billion new ordinary shares wey dem price at N525 each. Investors fit subscribe for minimum 10 shares worth N5,250, while di […]

todaySeptember 14, 2026 16

Sports

Yamal Say Him and Mbappe Be World Best, Deserve Ballon d’Or

By: Kofoworola Olayinka Barcelona winger Lamine Yamal don tok say na him and Kylian Mbappe be di two best players for world, as e claim say e deserve to win di 2026 Ballon d’Or after one big season with Barcelona and Spain. Yamal talk am for Movistar Plus interview on Sunday, saying di trophies wey e win with Barcelona and Spain this year make am believe say e deserve di award. Di 19-year-old help Barcelona retain La Liga before e […]

todaySeptember 14, 2026 22

obodo oyinbo

China Rejects Claim Say Dem Give Iran US Base Images

By: Kofoworola Olayinka China don reject reports say Chinese entities supply Iran with satellite images of US military base in Jordan before and after Iranian missile strike wey kpai three American soldiers on July 17. Chinese Foreign Ministry spokesperson Guo Jiakun reject di claim on Monday, saying Beijing oppose wetin e call groundless accusations without evidence during regular briefing. Di reports wey Wall Street Journal publish say US officials no identify di Chinese entities involved and dem no directly accuse […]

todaySeptember 14, 2026 11

metro

NDLEA Kram 44kg Colorado, Arrest Seven Suspects for Lagos

By: Kofoworola Olayinka NDLEA operatives don intercept two UK consignments of Colorado weighing 44.45kg at Murtala Muhammed International Airport, Lagos, and arrest suspects linked to di drugs on Wednesday, September 9, 2026. Di agency say dem first seize 32.20kg of di synthetic cannabis hidden inside luggage from di UK, while dem arrest real estate agent Abideen Jide Salami after e show up with collection code wey dia UK-based brother send am. NDLEA also track another UK consignment containing 12.25kg of […]

todaySeptember 14, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds