Blog masonry

Background

Sports

Mourinho Back England To Win 2026 World Cup

By: Yusuf Abuh Real Madrid coach Jose Mourinho drop micro soft word  say England get strong chance to win the 2026 FIFA World Cup. Mourinho tell Beast Mode On Podcast say e believe England get the quality to carry the World Cup trophy. England start dia campaign with 4-2 win over Croatia before dem play 0-0 draw with Ghana for Group L. Dem go play Panama for dia final group match as dem dey push to qualify for di knockout […]

todayJune 26, 2026 30

Sports

Ecuador Surprise Germany 2-1

By: Yusuf Abuh Unto world cup updates, Ecuador  shock Germany 2-1 for dia last Group E match on Thursday to qualify for World Cup last 32. Germany naim score first through Leroy Sane, but Nilson Angulo equalise before Gonzalo Plata score di winning goal with 13 minutes remaining. Di victory give Ecuador four points, enough to enter di knockout stage as one of di best third-place teams. Ivory Coast too qualify from di group after dem beat Curacao and end […]

todayJune 26, 2026 11

obodo oyinbo

Venezuela Earthquake Kpai 188 Pipo As Of Thursday

By: Yusuf Abuh Death toll from di strong earthquake wey shake Venezuela don rise reach 188 people, while 971 pipo don sustain injury, according to government officials. Dem say about 30 aftershocks don hapun since di two big earthquakes of 7.2 and 7.5 magnitude hit di country on Wednesday. Di disaster make plenty buildings for Caracas collapse and force authorities to close di main airport as rescue workers still dey search for survivors.

todayJune 26, 2026 12

OBODO NAIJA

Shettima Order NEMA To Prepare For Flood

By: Yusuf Abuh Vice-Presido, Kashim Shettima don direct National Emergency Management Agency, NEMA, and other gornment agencies make dem start work for  flooding now, make e nor con spoil something later. Di senior man vice presido give dis order on Thursday during meeting with di emergency task force pipo for Aso Villa, Abuja. Dis one follow National Economic Council approval of N83.2 billion on June 18 to support plans wey go reduce flood impact. Shettima say, agencies gat make every […]

todayJune 26, 2026 12

OBODO NAIJA

President Tinubu Give Oyo Hope

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don assure pipo for Oyo State say, make dem nor too worry demselves say goment go rescue di pikins and dia teachers wey kidnappers carry from three primary schools for Oriire Local Government Area. Baba Seyi tok dis one for Ibadan for wia im go run one or two parrol. Im say security agencies dey use every possible way, including support from outside Nigeria, to free di victims. Tinubu come advise South-West […]

todayJune 26, 2026 6

OBODO NAIJA

Femi Falana Advice FG To Give Naija Youth Work

By: Yusuf Abuh Human rights lawyer, Femi Falana, don drop beta bombshell say creating state police alone nor go fit solve Naija insecurity problem. According to di senior man lawyer, say, di tin nor go shake scale since poverty and unemployment strong. Falana yarn dis one for TV sit down tuk on Thursday, say plenty young pipo dey enta crime because of lack of work and no social support. You know di tuks na, say, na idle mind na bi […]

todayJune 26, 2026 8

Lagos

LASEMA Konfam 8 Death For Alakija Building Collapse

By: Yusuf Abuh Rescue work still dey continue afta one three-storey building collapse for Alakija area of Lagos State on Thursday, where at least eight people don die. Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) tok say dem rescue 26 people alive from di collapse for Old Ojo Road, near Alakija Bus Stop, Satellite Town. Permanent Secretary of LASEMA, Dr. Olufemi Oke sef don konfam di collapse and say, many emergency agencies dey di area to rescue pipo. Dat as of […]

todayJune 26, 2026 15

Sports

Osimhen Tell Galatasaray Make Dem Sign Arokodare As Backup Striker

Super Eagles seniorman striker, Victor Osimhen like dis don  reportedly tell Galatasaray make dem sign Tolu Arokodare as backup striker ahead of 2026/27 season. Report say Galatasaray fit lose Argentine striker Mauro Icardi , so dem dey look for replacement for attack. Turkish journalist Burak Eren talk say Osimhen recommend Arokodare to di club, as both players get close relationship and Arokodare dey see Osimhen as role model.

todayJune 25, 2026 11

OBODO NAIJA

Two Pipo Kpai as Building Collapse for Port Harcourt

Residents for Odili Road, Port Harcourt, Rivers State, nor be small tin hapun yesterday, dem enter panic after one three-storey building collapse and trap some people under di rubble. Acting Permanent Seco for Rivers State Ministry of Health, Dr. Vincent Wachukwu, tok say emergency responders, ambulances and medical personnel quickly move go di scene after dem hear about di incident. E still konfam say two people wey get serious injuries don rescue from di debris and carry go Rivers State […]

todayJune 25, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds