Blog masonry

Background

Lagos

FG, Lagos Join Forces To Fight Flood, Improve Water Supply

By: Yusuf Abuh Federal Gornment and Lagos State Gornment don renew dia collabo doings, dis time around say na  flooding dem wan rascal, to  improve water management and strengthen sanitation services for residents. Minister of Water Resources and Sanitation, Prof. Joseph Utsev, naim sorosoke dis mata as im ma go visit Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, for Lagos on Thursday, where e promise more federal support for flood control and water reforms. Utsev say Lagos flooding dey hapun because of di […]

todayAugust 7, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Deny US Weapon Shortage, Threaten Leakers with Jail

By: Esther Daniel US Presido Donald Trump on Thursday deny reports say America weapon stock don finish after military operations linked to Iran, insist say di kountry still get plenty munitions and factories dey produce more. Trump, for im Truth Social post, say fresh weapons dey continue arrive as needed and defence companies dey expand production across di United States. Di US Presido accuse people wey leak di reports of spreading false and treasonous information about America military strength. Trump […]

todayAugust 6, 2026 16 2

Politics

Tinubu Order EFCC Make Dem Unfreeze Osun Gornment Account

By: Esther Daniel Oga presido Bola Tinubu on Thursday direct EFCC make dem immediately return to court and cancel di order wey freeze Osun State Gornment account, after di action cause public criticism ahead of di August 15 gofnorship election. Tinubu, through im spokesman Bayo Onanuga, say although EFCC get power to do investigations, di timing of di account freeze embarrass am because people fit see am as political interference. Di Presido explain say since im assume office, im don […]

todayAugust 6, 2026 13

south west

 Police Catch Woman Over N42m Visa Scam Wahala

By: Jolayemi Olajide   Ondo State Police don grab one 33-year-old woman, Adejoke Ayomide, over alleged visa scam wey make over 90 people lose N42.3 million. Police yarn say dem arrest di woman on Wednesday after victims report di matter through law firm wey represent dem and demand justice. According to police, di suspect dey pose as travel agent, promising people visa to Spain, Portugal and France but allegedly collect dia money without delivering. Di command say investigation still dey […]

todayAugust 6, 2026 11

Sport Yarns

Shooting Stars Striker Ayodele Set to Dump NPFL for Egypt Move

By: Jolayemi Olajide   Shooting Stars striker Ismail Ayodele dey close to leaving di Nigeria Premier Football League side after Egyptian club Modern Sports SC reach agreement to sign am. Reports say di player don agree personal terms with di Egyptian team and e go travel go Northern Africa to complete di final stages of di contract. Ayodele, wey play regularly for di Oluyole Warriors last season, score four goals for di club before di proposed move. Di transfer move […]

todayAugust 6, 2026 14

Sport Yarns

El-Kanemi Chairman Tell Players Make Dem Serious for New Season

By: Jolayemi Olajide El-Kanemi Warriors chairman, Alhaji Waziri Isa Mai Qatar, don charge players make dem show commitment and discipline as dem prepare for di 2026-27 football season. Waziri give dis advice during im address to di team, urging players make dem obey instructions from newly appointed coach, Emmanuel King. Di chairman say di new tactician get knowledge wey go help di players improve as dem prepare for Nigeria National League campaign and CAF Confederation Cup. El-Kanemi Warriors go represent […]

todayAugust 6, 2026 13

OBODO NAIJA

Oga Presido Military Salary Increase Scatter Political Space

By: Jolayemi Olajide   Oga Presido Bola Tinubu approval of new salary package for Nigerian Armed Forces don cause mixed reactions from opposition parties as dem argue over di reason behind di move. Social Democratic Party and New Nigeria People’s Party welcome di salary increase during interviews for Abuja on Tuesday, saying better pay go improve soldiers welfare and strengthen national security. But Labour Party and Obidient Movement question di timing of di announcement, saying Nigerians need consider di administration’s […]

todayAugust 6, 2026 8

Sport Yarns

Real Madrid Splash €140m to Sign Yan Diomande

By : Jolayemi Olajide Real Madrid don complete di signing of 19-year-old Ivory Coast winger Yan Diomande from German club RB Leipzig in deal wey fit reach €140 million, making am one of di most expensive young players ever. Di transfer report on Thursday say Diomande sign seven-year contract after several top European clubs show interest in signing di talented winger. Some major European teams bin dey chase di player but talks no work out after his former club reject […]

todayAugust 6, 2026 11

Lifestyle

Kemi Adeosun Husband Don Die for Lagos

By: Jolayemi Olajide   Anthony Adeosun, husband of former Finance Minister Kemi Adeosun, don die at di age of 62 after e pass away on Wednesday for Lagos State. Di Adeosun family announce di sad news on Thursday through statement wey Reverend C. A. Adeosun release on behalf of di family. According to di statement, Anthony Adeosun die on August 5, 2026, but di family no talk wetin cause im death or how e take happen. Di announcement don attract […]

todayAugust 6, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds