Blog masonry

Background

Lifestyle

Kemi Adeosun Husband Don Die for Lagos

By: Jolayemi Olajide   Anthony Adeosun, husband of former Finance Minister Kemi Adeosun, don die at di age of 62 after e pass away on Wednesday for Lagos State. Di Adeosun family announce di sad news on Thursday through statement wey Reverend C. A. Adeosun release on behalf of di family. According to di statement, Anthony Adeosun die on August 5, 2026, but di family no talk wetin cause im death or how e take happen. Di announcement don attract […]

todayAugust 6, 2026 12

OBODO NAIJA

NBA Fire EFCC, Say Dem No Get Power Freeze Osun Account

By: Jolayemi Olajide Nigerian Bar Association, NBA, don tell EFCC say dem no get legal power to just freeze Osun State Government allocation account without first follow court and constitutional process. EFCC bin write First Bank on Wednesday make dem block every withdrawal from di account as dem dey investigate alleged N11 billion fraud wey involve Ecology Fund, Intervention Fund and FAAC money. Di letter wey Assistant Commander Adenike Babalola sign on behalf of di Director of Investigation order di […]

todayAugust 6, 2026 11

Lagos

Lagos Open New Workshop To Boost LNSA Security Operations

  By : Jolayemi Olajide Lagos State don commission new Lagos State Neighbourhood Safety Agency (LNSA) Technical and Mechanical Workshop for Ijede, Ikorodu, to improve maintenance of patrol vehicles, motorcycles and security equipment. House Committee Chairman on Information Strategy and Security, Hon. Stephen Ogundipe, praise Governor Babajide Sanwo-Olu and LNSA General Manager, Prince Dr. Ifalade Oyekan, say di project go strengthen security operations and improve emergency response. Ogundipe tok say di workshop show say Lagos dey prepare seriously for community […]

todayAugust 6, 2026 13

Sports

Osimhen Transfer Move Hit Wall As Club Reject €75m Deal

By: Yusuf Abuh Victor Osimhen don reportedly miss chance to move to Spain after one top European club reject offer to sign di Nigerian striker for €75 million. Reports from Spanish football outlet Club Uria say Osimhen representatives take di offer go meet di club through intermediaries few days ago, but dem turn am down because of financial concerns. According to di report, Osimhen ready to take pay cut to make di deal happen, but di club decide say dem […]

todayAugust 6, 2026 15

obodo oyinbo

Russia Embassy Deny Say E Dey Recruit Colombian Fighters for Ukraine War

By: Yusuf Abuh Russia embassy for Colombia don deny allegation say e get hand for network wey dey recruit Colombian mercenaries to fight for Ukraine war. Di embassy tok dis one on Wednesday after Colombian news outlet Noticias Caracol publish investigation on Monday wey claim say Moscow dey use Colombians support dia war against Kyiv. According to di embassy, dem no get any connection with di recruiters wey di report mention and dem no even know how dem dey fund […]

todayAugust 6, 2026 10

OBODO NAIJA

Navy Burst Illegal Refinery, Recover 85,300 Litres of Stolen Crude

By: Yusuf Abuh Nigerian Navy don burst two illegal refinery sites and recover about 85,300 litres of suspected stolen crude oil as dem continue dia fight against crude oil theft for Rivers State. Navy Director of Information, Captain Abiodun Folorunsho, tok dis one on Thursday, say di operation happen for Ogba-Egbema-Ndoni axis under Operation Delta Sentinel. According to am, Navy officers discover and scatter di illegal refining sites plus one network wey criminals don reactivate, while dem recover di stolen […]

todayAugust 6, 2026 28

south west

Atiku Blast EFCC, Say Dem Dey Chook Hand for Osun Election

By: Yusuf Abuh Presidential candidate of African Democratic Congress, Atiku Abubakar, don accuse EFCC say dem dey attack democracy after dem freeze Osun State Gornment statutory allocation account few days before Saturday gofnorship election. Atiku tok dis one on Thursday for Abuja through statement wey im Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release, say di timing of di action no pure at all. According to am, no reason fit justify why EFCC go block Osun allocation on top […]

todayAugust 6, 2026 11

Lagos

Lagos Gornment Tell Residents For Lekki, Ikorodu, Ajegunle Make Dem Run From Flood Areas

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don tell people wey dey stay for Lekki, Ikorodu, Ajegunle and Isheri OPIC make dem quickly comot go higher ground as heavy rain fit cause anoda serious flood. Environment Commissioner Tokunbo Wahab yarn dis one for TV on Tuesday, say anybody wey dey flood-prone area no suppose wait until water carry property or put life for danger. Di warning follow heavy rainfall wey start Sunday night and continue reach Monday, wey flood plenty parts […]

todayAugust 6, 2026 10

Politics

Adeleke Beg Osun People Make Dem Reject APC for August 15 Guber Election

By: Esther Daniel Osun State Gofnor and Accord gofnorship candidate, Ademola Adeleke, don call on voters for Osun State on Thursday make dem reject APC for di August 15 gofnorship election, say na so dem go protect di progress wey im administration don make. Adeleke tok say APC make civil servants suffer during dia time for office by paying half salaries, and say many workers no fit feed dia families because of di policy. Di gofnor also defend im gornment […]

todayAugust 6, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds