Blog masonry

Background

National

Nigeria Joinbodi With Tech Giants To Take Down Terror Social Media Accounts

By: Rilwan Agbomeji Nigeria gorment talk say security agencies dey work with social media big companies to shut down terrorist and criminal networks online. Director-General of National Counter Terrorism Centre, Maj-Gen. Adamu Laka, yarn dis during end-of-year briefing for Abuja. E talk say platforms like TikTok and Facebook don dey used to promote bad operations and raise fund for terrorists.

todayDecember 24, 2025 13

National

Senate Pass Tinubu ₦58.47trn 2026 Budget For Second Reading

By: Rilwan Agbomeji Na big step wey Senate don take pass President Bola Tinubu ₦58.47 trillion 2026 budget for second reading. Senate Leader, Opeyemi Bamidele, talk say di budget go help consolidate reforms, stabilize economy, and boost public finances. Say like dis like, di bill don waka go Appropriations Committee make dem check am well before final approval.  

todayDecember 24, 2025 7

Lagos

Lagos Police Deploy 5,000 Officers, Say Make Dem Tackle Jaguda Boys

By: Rilwan Agbomeji As Lagos dey prepare for chrismas and new year di State Police Comand say dem dey tighten security across di state including di water ways. Say like dis dem don deploy 5000 security officers to make sure say residents and di state dey safe. Na for inside strategic management meeting wey dem do, Police Commissioner,  Moshood Jimoh share di updates say dem don ready dia rake, an fork, dem nor go leave any stone unturn for di […]

todayDecember 24, 2025 6

foreign

Lionel Messi Sister Enter Hospital Afta Car Crash

By: Rilwan Agbomeji No be small thing ooo say Argentine superstar, Lionel Messi sister, Maria, get motor crash and like dis like dis, dem don dey drag her mata inside hospital for Miami. Report say all of a sudden she lose control, jam wall as at di time wey pipo rush reach there, she don already pass out Later aproko pipo report say she break her heel, wrist and get burns wey hard to treat.  

todayDecember 23, 2025 10

foreign

Russia Attack Ukraine, Kill 1 Pikin And 3 Others

By: Rilwan Agbomeji  At least three people don kpai, including one four-year-old pikin, as Russia launch new attacks for Zhytomyr region and other parts of Ukraine. According to Ukraine Energy Ministry, Plenty pipo wunjure as Russia target energy facilities across di country. Emergency power cuts don start for some areas, including Kyiv and nearby regions, to manage di gbege.

todayDecember 23, 2025 5

National

US Open Door Launch Immigration Plan

By: Rilwan Agbomeji US Department of Homeland Security don announce new plan wey go pay $3,000 to migrants wey waka go by themselves. Any undocumented migrant wey register through CBP Home app before end of year go fit collect di cash plus free flight back home. DHS talk say dem go still forgive any fines or penalties wey migrants dey owe for not comot earlier. Di programme get limited-time offer wey dey run for holiday season to encourage self-deportation.

todayDecember 23, 2025 7

Sports

Troost-Ekong Collect National Honour Certificate From Presido Tinubu

By: Rilwan Agbomeji  Retired Super Eagles captain William Troost-Ekong don receive national honour certificate from Presido, Bola Ahmad Tinubu on Monday. Troost-Ekong announce di receipt for X on Tuesday, say e dey proud for im and im family. Di award na Member of di Order of di Federal Republic (MFR), wey Tinubu giv am for official ceremony. E thank President Tinubu for di honour, call am big recognition for im football career.  

todayDecember 23, 2025 10

National

Six Rivers Reps Kawasaki Go APC

By: Rilwan Agbomeji Based on di gbege wey dey inside di People’s Democratic Party, anoda set of PDP law makers precisely from Rivers State don buy waka enter di All Progressives Congress. Dis announcement follow di law makers sitting on Tuesday for Abuja. Di law makers include Solomon Bob, Victor Obuzor, Dumnamene Dekor, Cyril Hart, Blessing Amadi and Felix Nwaeke. According to source from di National Assembly, all six of dem be loyalist to Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike.

todayDecember 23, 2025 5

obodo oyinbo

Russia, US Tuk Peace But Embassy Palava Still Remain

By: Esther Ayoola Russia and America diplomats don meet to tuk about some wahala wey dey spoil dia relationship, but Russia say big big issues never settle yet. According to report, Dem tuk say di meeting na about embassy problem, and another round go happen early next year. Russia also tuk say dis discussion no get anything to do with di Ukraine war.

todayDecember 23, 2025 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app