Blog masonry

Background

Sports

Mbappé Score Brace As France Beat Senegal

Unto world cup update, France don go show Senegal pepper, wining dem 3-1 for Group I World Cup match wey hapun for New York/New Jersey Stadium on Tuesday. Kylian Mbappé score two goals, including correct long-range strike for 96th minute, take make hin total World Cup goals reach 14 and also become France highest goal scorer with 58 goals. Bradley Barcola con add another goal for France, while Senegal manage score late consolation goal through Ibrahim Mbaye.

todayJune 17, 2026 10

obodo oyinbo

President Trump Promise To End Ukraine War

US Presido, Donald Trump don drop micro soft word after G7 summit wey  hapun for Evian-les-Bains, France say Russia suppose enter peace deal with Ukraine to end di war. Trump tuk for im truth social,  say e don meet President Volodymyr Zelenskyy and other G7 leaders, and e go try do wetin e fit do to stop di war for Ukraine. Trump dey insist say peace nor be wetin dem suppose use play and Russia must nor suppose make di […]

todayJune 17, 2026 8

OBODO NAIJA

Federal Gornment Need To Fix Nigeria To Avoid Xenophobic

Chairmo of Inter-Party Advisory Council, IPAC and National Chairmo of Allied People’s Movement, APM, Yusuf Dantalle, don clear FG, why dem need learn from di xenophobic attacks for South Africa, say na sign say Nigeria gat build build dia own country. Im yarn dis one for TV sit down tuk on Tuesday,. Dantalle say Nigeria suppose be example to oda African countries, if not say, dem never sti knw demselevs, say di behaviour dey bring see finish.

todayJune 17, 2026 10

OBODO NAIJA

Abuja Court of Appeal Vex, Stop INEC Plan

Di Court of Appeal for Abuja don stop di judgement wey say make INEC cancel African Democratic Congress (ADC) and four other political parties. Di three-judge panel wey Justice A. B. Mohammed lead vex well-well  for Justice Peter Lifu of di Federal High Court, say dem nor understand why im go suspend di case. Di appellate court say, wetin Justice Lifu do na pure 'judicial rascality' and e show say im na Otondo, as im nor follow di 1999 Constitution. […]

todayJune 17, 2026 12

Lagos

Apapa Customs Seize 1.81 Tonnes Of Loud Weed, Expired Drugs Worth ₦12.7bn

Apapa Area Command of Nigeria Customs Service don do jet li block 1.81 tonnes of Cannabis Sativa, wey dem also dey call Canadian Loud nor be only dat, plus expired drugs of about ₦12.7 billion, naim dem for Apapa Port, Lagos. Customs tuk, tuk, Isah Sulaiman, tuk say the gbabing hapun dis week, and dem officially announce am on Tuesday. Comptroller Emmanuel Oshoba, wey be Area Controller, naim explain di operation say na based senior man sabi doings with beta […]

todayJune 17, 2026 12

Sports

Serena, Venus Go Team Up For Wimbledon Doubles

Tennis legend, Serena Williams go play for Wimbledon again for di first time since 2022 after organisers give am wildcard to play women doubles with her sister Venus on Tuesday. Serena make di announcement after she win her first doubles match for Queen's Club last week alongside Victoria Mboko, four years after she stop professional tennis. Di 44-year-old say she come back because she wan play in front of her two small daughters and enjoy di game again. Di sisters […]

todayJune 16, 2026 7

Sports

Reno Omokri Reply Davido

Ambassador to Mexico, Reno Omokri, don fire back at Afrobeats star, Davido, afta di singer rain insult on am sake of comments wey Reno make about im performance for im World Cup concert. Di whole wahala start as Davido perform for di FIFA World Cup countdown concert for Los Angeles. For di show, e wear one jacket wey write di names of over 40 school children and teachers wey kidnappers carry for Oyo State, plus di message “Bring Them Home.” […]

todayJune 16, 2026 12

obodo oyinbo

Ukraine Drone Blast Moscow Refinery

Nor be small lin, like Russia and Ukraine na dia oil business dem take dey play, One big oil refinery for Moscow don go catch serious fire on Tuesday as Ukrainian drones hammer di city. Moscow Mayor naim dey konfamate is mata, say over 60 drones naim jam di capital, and one of dem come scata for  Gazprom refinery wey dey Kapotnya area. Ukraine tok say na payback be dis, as Russia bin first release heavy missiles fire give dem […]

todayJune 16, 2026 11

OBODO NAIJA

State Police No Go Take Food from dia table – IGP

Inspector-General of Police, Olatunji Rilwan Disu, don assure officers and men of Nigeria Police Force say plan to create state police no go scata or replace federal police. Im yarn dis one during im working visit to Jigawa State Police Command, According to Disu, federal police go still dey carry out dia constitutional duty of maintaining law and order across di country.

todayJune 16, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds