Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Remi Tinubu Hail Fathers for Abuja

Wi First Lady, Senator Oluremi Tinubu, don salutate all fathers of di land and around di world for dia sacrifices. She put dis one for statement for Abuja, as di world dey mark fathers day, yesterday. Our mummy drop advice oh, Say make all mama and pikins, for di obodo Nigeria, make dem buy barbecue fish for our fathers, dat dose men dey try, as dem take dey chest plenty billings steady, steady. She still hail father-figures (nor be di […]

todayJune 22, 2026 12

south west

INEC Declare Oyebanji Winner For Ekiti

Independent National Electoral Commission, INEC, don declare All Progressives Congress, APC, candidate Biodun Oyebanji as winner of di 2026 Ekiti State gofnorship election. Di Returning Officer, Professor Adenike Oladiji, naim announce di result early Sunday morning, say Oyebanji gather 319,224 votes to win di election. She add say PDP candidate Oluwole Oluyeden naim carry second with 40,543 votes while ADP candidate Dare Bejide get 12,872 votes. And like dis, Oyebanji don thank APC leaders for dia support and dat dis […]

todayJune 22, 2026 10

Lagos

LASTMA Rescue 353 Accident Victims

Lagos State Traffic Management Authority, LASTMA, don rescue 353 people wey involve for road accident and emergency cases across Lagos from January reach May 2026. LASTMA General Manager, Olalekan Bakare, naim tok dis one as e dey review di work of di agency Rescue and Emergency Response Unit. According to statement wey tuk, tuk person, Adebayo Taofiq release on Sunday, among di people wey dem rescue na 207 adult men, 137 adult women and nine male pikin. Di agency say […]

todayJune 22, 2026 12

obodo oyinbo

US And Iran Finally Drink Water Keep Cup

After months of heavy fight, di United States and di Islamic Republic of Iran don finally sign one peace deal on June 17, 2026, for G7 dinner for Versailles, di deal talk say make everybody stop di war sharp sharp, and e give them 60 days to sit down for Geneva, Switzerland, to design permanent peace agreement. Dis deal, wey dem dey call Memorandum of Understanding carry 14 points inside belle, as di deal wan stop any gragra first, them […]

todayJune 19, 2026 12

obodo oyinbo

Middle East Peace Deal Dey Shake, Israel Resume Heavy Fight

Fresh tension don rise again for Middle East as Israel and Hezbollah exchange heavy attacks for Lebanon on Friday. According to report, di new peace deal between Iran and di United States dey shake. Tuks wey America and Iran suppose hold for Switzerland, dem don postpone am dafter Iran chief negotiator talk say dem no go shift from dia position and dat dem ready oh to take action. Di peace agreement wey President Donald Trump and Iranian President Masoud Pezeshkian […]

todayJune 19, 2026 15

Local

NANS and FUOYE VC Hold Heavy Talk

Presido of Nigeria association of Nigerian Student, Akinteye Babatunde, don cut chain oh , say why di Vice-Chancellor of Federal University Oye-Ekiti (FUOYE), Prof. Abayomi Fasina, go suspend di school SUG Presido, James Adio. Babatunde tell pipo on Friday say di student body kick completely against how di school take suspend and push di SUG leader for corner. Di Vice-Chancellor come explain wetin cause di suspension, say Oga SUG presido go migrimor and di video con leak. Prof Fasina promise […]

todayJune 19, 2026 15

Lagos

How Lagos State Police Go Gbag Fake Kidnap Victims

Lagos State Police Command don do small ji mike gbab 26 fine-boys and fine-girls from other countries including some camerounians wey con fake dia kidnap. According to di police, na one 22-year-old Cameroonian woman carry report go police station say dem kidnap am, afta she travel come Nigeria to see one 39-year-old Chadian man wey she dey date for internet. But as police start to dig di dig, ehn, dem come see say di babe lie big lie from di […]

todayJune 19, 2026 21

Lagos

Lagos LG Chair Promise to Back Farmers

Alimosho Local Gornment Chairmo, Akinpelu Johnson, don spread joy wetin nor good, dat make farmers wey dey im council nor too worry body oh, say dem ma get support dem. Johnson yarn dis one on Friday for di council secretariat during meeting with All Farmers Association of Nigeria, AFAN, and other agriculture stakeholders for Alimosho, Lagos. According to di Alimosho council chair, farmers get beta role for economic growth, food supply and  development, so dem deserve more empowerment.

todayJune 19, 2026 11

Entertainment

Delta Gofnor aide flame Omoni Oboli hot over Alexx Ekubo movie!

By : Jolayemi Olajide Wahala don burst for Nollywood, Omo! One of Delta Governor’s aide, Ossai Ovie, naim carry just carry fire go meet Omoni Oboli. Di reason? Say, Di filmmaker drop her film, 'The First Lady', just few days after dem bury Alexx Ekubo. Even as Omoni talk say she go give all di profit to di family, Ossai no gree. E call the move "pure disrespect," saying she dey try "cash out" from the man death while di […]

todayJune 19, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds