Blog masonry

Background

obodo oyinbo

UN Cry Out As Ebola kpai over 3,200 Pipo for DR Congo

By: Mariam Ajayi Dis Ebola virus nor get same for eyes oh, see di way e dey rush  DR Congo, you go sorry for dem. Infact United Nations dey  scream, help oh help for DR Congo, say na over 3,200 pipo don kpeme, and like dis health workers dey sweat like person chrismas Goat, e nor easy. According to UN tok-tok person, Stephane Dujarric, To pull di handbrake on dis badness, WHO and DRC gornment don raise hands beg world […]

todaySeptember 9, 2026 11

Lagos

APC Gather Religious Leaders Fire Prayers for Baba Presido

By: Mariam Ajayi Election don reach everybody mind dey shakebalabala, nor be small prayer wey di All Progressives Progress  Congress fire yesterday Onikan stadium for Lagos, say any opposition wey Say Bola  Tinubu  and Kadri Obafemi Hamzat nor go win di 2027 election, say make dem comot body joor. Senior mehn Pastors, Imams, and traditional worshippers naim put body for di mata. Gofnor Babajide Sanwo-Olu, party chairmo Cornelius Ojelabi, plus representatives of di Oba of Lagos all storm di stadium […]

todaySeptember 9, 2026 12

OBODO NAIJA

Peter Obi Carry Perper Body Ginger Give Federal Gornment

By: Mariam Ajayi Peter Obi don call on federal gornment to save thousands of Nigerians wey terrorists don drive comot dia villages. Obi drop dis fire call for X after e storm Mangu IDP camp inside Plateau State, an u know di badness wey sup for  Yelwata inside Benue State on Tuesday, wey boy block am. Supporters con dey ask, wetin dey give dis man mind, di former Anmabra state govo, say di koko na to save di more than […]

todaySeptember 9, 2026 10

Politics

Ladi Adebutu Become Gbademu of Owu Kingdom

By: Ayobami Dada Ogun PDP gofnorship candidate, Ladi Adebutu, don become Gbademu of Owu Kingdom, as e promise say e go use the traditional title push development for Owu, Egba and Ogun State. Dem install Adebutu on Tuesday for Olowu palace for Abeokuta, with traditional rulers, politicians, family members and other big people present for di ceremony. Adebutu thank Olowu of Owu Kingdom, Oba Saka Matemilola, say the honour no be ordinary title but call to serve and help develop […]

todaySeptember 8, 2026 13

Sports

No Naija Player, Coach Make Ballon d’Or Nominee List

By: Ayobami Dada No Naija player, coach or team make the Ballon d’Or nominee list wey dem release on Tuesday. Last year, Super Falcons goalkeeper Chiamaka Nnadozie make the Women’s Yachine Trophy shortlist, while Falcons coach Justine Madugu also enter nomination for Women’s Team Coach of the Year. Dis one come after Falcons win their record-extending 10th WAFCON title for Morocco, but Naija senior men and women teams no qualify for FIFA World Cup. For men’s Ballon d’Or, Victor Osimhen […]

todaySeptember 8, 2026 16

Politics

Obi Explain Why E Go Benue After Thugs Attack Him Convoy

By: Ayobami Dada NDC presidential candidate, Peter Obi, don tok say e go Benue no be for campaign, but to visit people wey recent killings affect and show dem sympathy. Obi tok dis after suspected thugs block and attack hin convoy as e dey enter Benue. E say, “I dey Benue today no be for campaign. I just wan go where people lose their lives, condole with dem and show solidarity.” Obi say wetin happun show how Nigerian politics don […]

todaySeptember 8, 2026 12

Business

Dangote Refinery IPO Go Start September 14, Nigerians Fit Buy Share for N5,250

By: Ayobami Dada Dangote tok for Lagos on Monday say di refinery put 4.1 billion shares for sale at N525 per share, and dem dey target 10 million Nigerians. Aliko Dangote tok say Dangote Refinery IPO go start September 14, 2026, and person fit start with just N5,250 to buy 10 shares. He say people fit buy di shares online through BVN, so ordinary Nigerians fit become part-owners of di 700,000-barrel-per-day refinery.

todaySeptember 8, 2026 12

OBODO NAIJA

Nigerians for UK Vex Over Manchester Passport Delay

By: Ayobami Dada Nigerians wey go collect passport for Manchester, UK, don vex as dem wait for hours without anybody attending to dem on Tuesday. One Nigerian, Oluomo of Derby, tok say people wey reach di centre since 9 a.m. still dey wait by 11:30 a.m., even after dem travel far and comot work. Oluomo say di whole thing no make sense, and e call for better arrangement so Nigerians no go waste dia time and money.

todaySeptember 8, 2026 11

Lagos

Lagos Upgrade Five Police Divisions for Domestic Violence Cases

By: Ayobami Dada Lagos State Gornment don upgrade five police divisions for Isheri, Idimu, Meiran, Ijesha and Iju into Family Support Units to improve response to domestic and sexual violence cases. Di DSVA and Lagos Police Command carry out di upgrade, while 24 officers receive special training from September 3 to 4, 2026, for LCCI Centre, Alausa, on how to investigate and handle SGBV cases.

todaySeptember 8, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds