Blog masonry

Background

Sport Yarns

Pochettino tell Messi Sorry, for im papa wey dey hospital

By : Jolayemi Olajide USMNT head coach, Mauricio Pochettino, don message Lionel Messi and im family, after dem rush Messi papa go hospital. Pochettino fry mouth say normal, messi papa, Jorge, receiving treatment for hospital na distraction, but encourage di senior man to stay focus dat im papa go dey alryt. Di former PSG boss, wey sabi Messi well-well, send im full support and best wishes to the family as dem dey face dis hard time.  

todayJune 19, 2026 8

Sports

Canada Wipe Qatar 6-0

For World Cup yesterday, Canada show serious strength as dem hammer Qatar 6–0, completely dominate di match from start to finish. Still yesterday, Bosnia and Herzegovina try but Switzerland overrun dem 4–1, especially for second half . Canada victory na clean attacking performance with plenty goals and no reply from Qatar, while Bosnia struggle to contain Swiss pressure all through di game.

todayJune 19, 2026 9

obodo oyinbo

Iran Leader Accept Peace Deal Wit US

Iran supreme leader, Ayatollah Mojtaba Khamenei, don finally konfamate  say im hand dey for peace deal wey US Presido Donald Trump sign to end Middle East war, even though say nor be every tin inside di deal dey give am joy. And dat joy is coming in di morning. Di agreement go also allow US lift blockade for Iran ports and open road for 60 days tuk, on matas like nuclear programme. However, di koko be say, non of dem […]

todayJune 19, 2026 12

Uncategorized

NEC Approve ₦83bn To Fight Flood Wahala

National Economic Council (NEC) don press naij purse for neck, approve over ₦83 billion under Anticipatory Action Trust Fund, AATF, to tackle flood wahala. Di approval hapun for meeting wey Vice President Kashim Shettima chiar for State House, Abuja on Thursday. Governor Bassey Otu of Cross River naim con fry mouth afta di meeting explain say dem first propose over ₦166 billion, but NEC finally approve ₦83.2 billion. Dat dis money go help di country prepare for di flooding across […]

todayJune 19, 2026 7

OBODO NAIJA

President Tinubu drop Promise Say Beta Life

Wi oga Presido Bola Tinubu don drop bombshell say im nor promise Nigerians any miracle oh but beta gornment policies and development projects. Baba Seyi dey yarn dis on through Senate Presido Godswill Akpabio during di commissioning of one new access road and bridge for Abuja on Thursday. Im nor understand why pipo dey drag gorment and dat im administration  focus na to build ogbonge projects wey go improve di lives of ordinary pipo.

todayJune 19, 2026 13

Lagos

How Sanwo-Olu buy more trucks

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don order immediate cleanup say dirty wan finish Lagos. Di senior man post dis one for facebook page, e nor go fit sit down an look dirty to con build office for di state, and say like dis, extra trucks and workers don already join LAWMA, LASEPA and Environment Ministry to clear dirty communities. According to am, Lagosian go soon dey see very clean Lagos street after di clean up.

todayJune 19, 2026 7

Sport Yarns

World Cup Gbege, Police Gbab Ivorian Star Elye Wahi Over Betting Scandal

By : Jolayemi Olajide Nor be small gbege, Ivory Coast striker, Elye Wahi, don enter world cup hot soup. According to report, French police arrest am just two weeks before di  2026 World Cup over alleged spot-fixing. Omo, the gist be say the 23-year-old allegedly collect yellow card on purpose during one Ligue 1 match between Nice and Metz back in May, all just to settle one dirty betting arrangement. Now,  Wahi dey battle di mata  while im mates dey […]

todayJune 18, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Sign Iran Peace deal for France with Macron Hailings

By : Jolayemi Olajide US President Donald Trump don blast people wey criticize the peace agreement wey e sign with Iran,  say wetin dem dey tuk nor make brain, dat like dis dem dey prepare to sign di deal  for Switzerland. Trump and Iran President Masoud Pezeshkian separately sign di agreement wey go end di Middle East war and reopen di Strait of Hormuz. Trump put im signature for di document during dinner with French President Emmanuel Macron for Versailles […]

todayJune 18, 2026 11

Politics

Kingibe Clear Air On Natasha Suspension Report

By : Jolayemi Olajide Somebody shout power, nor be small tin as  Senator wey dey represent FCT for Senate, Ireti Kingibe, drop micro soft word say she nor see di committee report wey lead to the suspension of Kogi Central Senator, Natasha Akpoti-Uduaghan. She yarn this one on Wednesday during interview for tv sit down tuk. According to am, she bin dey attend tax reform retreat when di Senate  consider the report, so she no get chance to read am. […]

todayJune 18, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds