Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Makinde Fire Back at 2027 Doubters, Say Nigerians Go Decide

By: Ayobami Dada APM presidential candidate Seyi Makinde on Monday for Abuja say nobody fit write off millions of Nigerians wey go vote for 2027 election, as he launch “Reset Nigeria” campaign. Makinde say im no dey support return to fuel subsidy, but want Nigerians to benefit more from di crude oil wey Nigeria produce through cheaper supply to local refineries.

todaySeptember 8, 2026 20

obodo oyinbo

Cape Verde Bus Crash Kill 25, Mostly Children

By: Ayobami Dada Cape Verde don begin two days national mourning after bus crash for Fogo Island kill 25 people, mostly children and teenagers, on Saturday night. Di bus wey carry 32 people dey return São Filipe when e veer off road enter deep ravine, killing di driver and 24 others. Families and residents gather across Fogo Island on Sunday to bury di victims and pay dia final respect.

todaySeptember 8, 2026 10

OBODO NAIJA

NAFDAC Boss Blame “Wetin I Fit Gain?” Mentality for Naija Wahala

By: Ayobami Dada NAFDAC DG Mojisola Adeyeye on Monday say some Nigerians no dey like to serve dia country, as she respond to calls for her removal during engagement with journalists. Adeyeye say she spend 34 years for America, including 30 years as professor, before she retire and return Nigeria to lead NAFDAC because she want serve di country.  

todaySeptember 8, 2026 12

Lagos

Lagos Charge Over 100 Suspects for Oshodi

By: Ayobami Dada Lagos State Gornment take over 100 suspects for Special Offences Mobile Court, Bolade, Oshodi, on Friday, September 4, 2026, over alleged public peace breach and unlawful use of government property. State lawyer Oluwabusola Omotunde tell di court say security operatives arrest dem between 2 a.m. and 4 a.m. for Victoria Island, Lekki and Ajah corridor because of di alleged offences.

todaySeptember 8, 2026 13

Sports

Falconets Chop 2-0 First Breakfast For World Cup

By: Yusuf Abuh Falconets don chop first breakfast for FIFA U-20 Women’s World Cup as defending champions Spain show dem pepper 2-0 inside Poland on Monday. Di Spanish girls hold ball like say dem own am, come open score line for 13th minute through Marisa Garcia to put Nigeria for tight corner for ArcelorMittal Park. Coach Moses Aduku girls try dia best to equalize di score, but Spain solid defense turn to iron gate wey di Nigerian strikers no fit […]

todaySeptember 8, 2026 16

obodo oyinbo

Qatar Cry Out Say Iran And US Dey Spoil Business For Dem

By: Yusuf Abuh Oya oh, Middle East dey boil like dis, pepper bodi everywia as  Qatar Foreign Ministry spokesperson, Majed Al-Ansari, dey cry give US make dem calm down for di Strait of Hormuz, say oil business dey suffer. According by di oyinbo wey dem speak news statement, “industrial catastrophe naim dey hapun for di strait of Hormuz. Kpler data show say na only about 10 cargo ships dey manage cross di waterway daily for di last 10 days and […]

todaySeptember 8, 2026 13

OBODO NAIJA

Obi Hail Seyi Makinde Say E Get Doings To Be President

By: Yusuf Abuh Political shocky shocky naim hapun for Abuja on Monday, dis NDC presidential candidate, Peter Obi, whether messi, abi Maradona confusion gadinma, unto say nobody dey see di next move coming. On Monday na so di presidential candiate enter di inauguration of Allied Peoples Movement, APM presidential candidate, Seyi Makinde, campaign office, say di Oyo state qualify to be presido. Na so everybody shout Shuuuiiii, what do mean, na di aim drop di bumbshell say Opposition politics nor […]

todaySeptember 8, 2026 11

Lagos

Lagos Police Vex, Gbab 4 Suspects Wey Kpai Abroad Returnee

By: Yusuf Abuh Lagos police command dey vex oh, like dis dem arrest four suspent base on Lagos island jungle justice. Lagos Police Command don lock four suspects inside cell after jungle justice beating wey dem take kpai kpai one abroad-returnee, Basit Kolade. Lagos Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi, naim dey sorosoke di ogbonge update say dis wahala badness hapun along Freeman Street as Basit and e wife dey drive dia black Lexus Jeep, before one okada go hit dem […]

todaySeptember 8, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds