Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Fire for Fire for Lebanon as Israel Strike Towns, Hezbollah Fire Rocket Back

By : Jolayemi Olajide Israeli air strike don continue for southern Lebanon on Wednesday, despite talk say US and Iran go soon sign agreement to end war tension. Local report talk say drone attacks for Tyre wunjure some pipo, while another strike hit Bint Jbeil area for Nabatieh. Earlier too, air raid still land for Kfar Tebnit and nearby towns, as shelling and bombing continue for different parts of the region. Meanwhile, Hezbollah fighters fire about 10 rockets back at […]

todayJune 17, 2026 13

OBODO NAIJA

Minority Lawmakers Drag Tinubu Gorment Over Insecurity, Hardship

By : Jolayemi Olajide Nor be small fire for wi house of representative today, wia  minority caucus drop bars say, President Bola Tinubu nor dey try at all,  dat   insecurity wan finish di giant of Africa. Dem yarn dis one for National Assembly for Abuja, according to  Minority Leader Fred Agbedi,  Nigeria don enter one of im worst period since 1999 democracy, say dis one, na demonstration of craze . Agbedi say gornment just dey  focus on 2027 election mata […]

todayJune 17, 2026 9

south west

Ogun Police Burst Criminal Network, Arrest 6 Suspects, Recover Guns

By : Jolayemi Olajide Ogun State Police Command don arrest six suspects, recover guns, bullets, generators and mobile phones for different operations for Abeokuta, Wasimi and Ibafo. According to di command tuk, tuk, Oluseyi Babaseyi, dat, na dia  Violent Crime Response Unit, SWAT and Ibafo Division naim run di parrol. The suspects wey dem arrest include Afisu Awesu, Bala Aminu, Moruf Sodiq (Okiki), Mumuni Amodu (Stone), Abayomi John (Ibafo) and Adeboye Ojesina. For di raid, police recover pump-action gun, locally […]

todayJune 17, 2026 10

obodo oyinbo

Norway’s Crown Princess Undergoes Lung Transplant

Norway Crown Princess, Mette-Marit, don get successful lung transplant surgery afta she suffer from one kind sickness wey dey make person find breeze block. Oslo University Hospital talk say di 52-year-old princess go still remain for hospital for several weeks make doctors for fit check am well, as di practice dey go for anybody wey just do transplant. Di princess don dey battle with dis lung problem wey dey scratch and scar person lung tissue since 2018. But her condition […]

todayJune 17, 2026 9

Sports

Ekong Confess Say E Still Dey Miss Super Eagles

Former Super Eagles captain William Troost-Ekong don tuk say e still dey miss life with di national team even afta he retire from international football for December 2025. Di 32-year-old defender wey serve Nigeria for about 10 years tuk dis one for podcast roundtable wey him join with players like Ola Aina, Alex Iwobi, Joe Aribo and Calvin Bassey. Ekong tuk say E no regret im decision to retire, but e no easy for am dey watch di team from […]

todayJune 17, 2026 8

OBODO NAIJA

Senate Clear Customs Over ₦62bn

Senate Committee on Public Accounts don clear Nigeria Customs Service over allegation say dem no remit ₦62.2 billion enter Federation Account as stated for 2019 Audit Report. Di committee, wey senators lead di touch lighting, take decision after dem hold session with Customs Comptroller-General, Bashir Adeniyi, over 77 audit queries for 2019 and 2020 reports. Dem say dem still go set up ad hoc reconciliation panel to review remaining 76 queries and verify the matter before final decision.

todayJune 17, 2026 9

National

Labour Unions Para for N70k Minimum Wage

Nigerian labour unions don tell Federal Government say N70,000 minimum wage no reach anywia again because food, transport, and house rent don cost gan. Inside one meeting for Geneva, di unions tuk say dem no go gree make gornment tax dis money or put more load for poor workers body. As di two-year review time dey reach for July 2026, labor leaders dey plan to start tuk sharply with gornment make delay no enter di mata. Dem make am clear […]

todayJune 17, 2026 12

Lagos

NGO Beg Lagos Assembly Make Dem Protect Justice

One human rights group, Centre for Human and Socio-Economic Rights (CHSR), don write petition go Lagos State House of Assembly, dey ask Speaker Mudashiru Obasa and lawmakers make dem protect di ongoing murder trial wey involve Ajiran community killings for Eti-Osa LGA. Di  group presido, Comrade Alex Omotehinse, say dem dey worry about attempts wey fit influence public thinking and spoil justice for di case. Omotehinse explain say, police before, for briefing wey happen for Lagos State Police Command HQ, […]

todayJune 17, 2026 9

Lagos

Police Explain Wetin kpai DCP Khan Salihu

Lagos State Police Command don clear air say story wey bin dey fly say late DCP Khan Salihu dem kidnap before im kpai na fat lie from di pit of hell. Police tuk tuk, SP Abimbola Adebisi, explain for statement, say di officer just complain say e no dey well, dem rush am go hospital, naim doctor konfam say e don kpai. Police tuk say di report na fake news wey go lead pipo to beta koto, and e no […]

todayJune 17, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds