Blog masonry

Background

National

Bayelsa Deputy Gov Collapse, Dem Rush Am Go Hospital

By: Rilwan Agbomeji Bayelsa Deputy Governor, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, slump for Government House Yenagoa and dem rush am go hospital sharp sharp. Reports wey land troway say di incident happen Thursday afternoon and di matter serious. Sources add say dem carry am go Federal Medical Centre Yenagoa for sharp treatment, but hospital officials never yarn anything. Di Deputy Governor media person, Doubara Atasi, confirm say di thing happen but e no gree talk anything before e end call.

todayDecember 11, 2025 17

foreign

Jaguda Boy Use Hand Touch Bristol Museum ,Thief 600 Artefacts

By: Alice Iduh BristolĀ  for inside United kingdom dey shake say, some Jaguda boys enter dia museum thief about 600 of dia precious artefacts wey dey show link between Britain and former British Empire don vanish. Police talk say dem comot am for museum since September 25. Avon and Somerset police don release CCTV wey show four men wey police dey find, dem dey outside di building wey hold di collection.

todayDecember 11, 2025 24

Lagos

Lagos Police Clear Inspector Weh Dem Beat For Oshodi Say Im Nor Thief

By: Alice Iduh Lagos State Police don clear tori wey dey go viral, say one inspector wey area boys beat for Oshodi inside video dat im thief, nor thief anytin. Na for inside statement on Thursday by police tuk tuk, SP Abimbola Adebisi,Police talk say na lie, say di officer dey do im official work wen di wahala hapun. Adebesi yarn mata dat,di inspector dey Lagos State Taskforce, and e dey stop illegal parking for Brown Street, Oshodi. And dat […]

todayDecember 11, 2025 49

Lagos

Lai Mohammed Drop Bombshell Say No Massacre Happen For Lekki, Na Fake News

By: Alice Iduh What a bombshell, Former Minister of Information, Lai Mohammed, donĀ  come out clear mataĀ  say no bodiĀ  die for Lekki Toll Gate during EndSARS, and dat di massacre na fake. E talk say na fake news and social media wahala dey spread di story. Mohammed yarn say one big wahala wey e face na to fight misinformation, and e still dey promote im new book.

todayDecember 11, 2025 33

Sports

Victor Osimhen Collobi Turkey Sportsman Of The Year Award

By: Alice Iduh Galatasaray striker Victor osimhen based on betterlicoius doings don win sportsman of di year award for turkey for 2025 gq türkiye men of di year awards. Di nigerian forward help galatasaray win plenty matches last season as e score 37 goals and give 7 assists across all competitions. Osimhen wey dey 26 years old, don still dey fire this season with 11 goals in 14 games.

todayDecember 11, 2025 44

obodo oyinbo

Venezuelan opposition Leader Maria Machado return After years of hiding

By: Alice Iduh Venezuelan opposition leader Maria Corina Machado don show face last lastĀ  for Oslo on Thursday after nearly one year wey she dey hide, as she win Nobel Peace Prize. Di Nobel Institute talk say Machado do ā€œeverything in her power to come to the ceremony,ā€ say her journeyĀ  deyĀ Ā  dangerous,ā€ but she reach too late to collect the prize. Machado herself tori pipo say, she dey goĀ  back the formal sef which is to take her place […]

todayDecember 11, 2025 40

south west

Governor Adeleke explain say im sti love PDP

By: Alice Iduh Osun State Governor, Ademola Adeleke,Ā  don reacts to tuk say imĀ  abandon Pipos democratic partyĀ  after im use dem climb, now don run goĀ  Accord Party. Ontop yanings for tv sit down tuk, the govo say im nor abandon any parti, say in fact,Ā  im still love PDP, but wahala inside the party push am to find better platform for him 2026 re-election. Adeleke say he try settle the PDP crisis, but instead of tins to settle […]

todayDecember 11, 2025 49

Lagos

Area Boys Brutalise Lagos Police Officer Say Im Go Thief

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Police Command don begin touchlight marras afta one viral video burst online, show how area boysĀ  dey manhandle one uniformed police officer over allegation say im go thief. Di clip, wey circulate on Wednesday, capture di officer as blood dey pour from im mouth as angry area pipo surround am like say dem get am for mind before. Shege promax just dey whaooo whaooo for di man face and im dey beg for im […]

todayDecember 11, 2025 52 1

National

President Tinubu Set Up Committee To Pay Contractors Gbese

By: Alice Iduh Wi oga presido bola tinubu donĀ Ā  konfam oneĀ  ministerial committeeĀ  wey go helpĀ  settle di over n4 trillion debt wey gornment dey owe more thanĀ  2,000 contractors for di obodo nigeria. PresidoĀ  adviser on media and publicity, bayo onanuga,Ā  ni share diĀ  update after federal executive council meeting for abuja. According to onanuga, contractors don dey shout, our moni eh, oh our money and dey protest wi nor go gree we nor go greeĀ  for months because […]

todayDecember 11, 2025 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds