Blog masonry

Background

National

APC Govos, Presidency Ginger Bodi For Grassroot Issues

By: Esther Ayoola All Progressives Congress Governors forum don go put bodi for grassroot doings to push di Renewed Hope Agenda of President Bola Ahmed Tinubu, say time don reach for dia reform to show workings. Untop di yarnings for di PGF Renewed Hope Ambassadors Summit 2026, Vice President Kashim Shettima ni carry di mata dey yarn, say time don pass wey dem go dey tell pipo to manage di pain, dis na time to show workings, particularly with di […]

todayFebruary 25, 2026 2

National

Obi, ADC Drag APC Say Dem Use Hunger Finish Nigerians

By: Esther Ayoola Di 2023 labour parti presidential candidate, Peter Obi once again don drag di All Progressives Congress gornment afta gunmen, wey be suspected political thugs, attack some African Democratic Congress chieftains for house of John Odigie-Oyegun for Benin City, Edo State. Say, di attack hapun shortly afta di party leaders come back from ADC secretariat wia dem formally welcome Olumide Akpata join di party. Obi fry mouth untop di incident and dat, di APC gorment wan kill Naija […]

todayFebruary 25, 2026 3

National

FG Knock US Congress, Say No Be Religious Persecution for Naija

By: Esther Ayoola Wi Federal Gornment once again don react to US Congress tuk about alleged attack on Christians, say nobody dey support any kind religious persecution for Naija. On Monday, US House Committees on Appropriations and Foreign Affairs submit report to White House, recommend sanction over wetin dem call persecution of Christians for Naija. Reacting, Minister of Information, Mohammed Idris, say Naija never get any gornment policy wey target Christians, and say di wahala na from terrorism, banditry and […]

todayFebruary 25, 2026 3

obodo oyinbo

Drone Attack Hit Kordofan Market, Sudan, Kpaing Plenty Civilians

By: Esther Ayoola Say di story dey worwor everyday for Sudan, dat drone attack don kpai plenty civilians for south-central Kordofan, Sudan. According to report from UN and humanitarian pipo, Fighting between Sudan army and Rapid Support Forces (RSF), don reach another level, as pipo dey kpai, kapi every day. UN officials say, drone hit market, hospital, aid convoy, and house, wey civilian bin dey hide. Dem warn say, di war dey worse by di day, and peace effort from […]

todayFebruary 25, 2026 2

obodo oyinbo

Oyinbo Jaguda Break “No-Contact Order,” Stab Pipo To Death For Washington

By: Esther Ayoola Say one jaguda boy enter area for Washington state, U.S. stab, stab pipo anyhow, and dat nobody sabi wetin im dey think cause dis serious damage to innocent pipo Pierce County Sheriff say four pipo kpai for one house for di Tuesday attack. Di Sheriff reveal dat, one police officer wey reach di scene at 9:33 ni shoot di 32-year-old suspect, and di man kpai on di spot. Dem also report say one person wey suppose survive, […]

todayFebruary 25, 2026 7

obodo oyinbo

Japan To Arrange Station Missile For Island Near Taiwan Based On China Tension

By: Esther Ayoola Report don land say, Japan wan position surface-to-air missile for one small island wey near Taiwan by March 2031. Japan defence minister, Sanae Takaichi, explain, say Na di first time Japan dey share where dem go put missile for Yonaguni island since 2022. While China dey claim Taiwan as dia own and report say, dem wan use force to “reunify” am. Tension don dey rise like two days old soaked garri between Tokyo and Beijing since Japanese […]

todayFebruary 25, 2026 4

Sports

Mbappe To Miss Benfica Game Due To Knee Problem

By: Esther Ayoola Real Madrid striker Kylian Mbappe nor go play against Benfica for today Champions League match say im get knee wunjury. According to report im don dey manage di pain since but for tonight waka for Santiago Bernabeu against Benfica, say im go rest. Madrid get 1-0 advantage from di first leg for Lisbon wey Vinicius Junior suffer racial abuse. Even with im knee problem, Mbappe still dey lead UCL scoring chat with 13 goals dis season.

todayFebruary 25, 2026 3

Sports

UCL: Sorloth Hat-Trick, Lookman Assist, Atletico Hammer Brugge 4-1

By: Esther Ayoola Super eagles striker Ademola Lookman shine wetin nor good as e come from bench hellep Atletico Madrid win Club Brugge 4-1. Alexander Sorloth ni lead di attack, score three correct goals wey make Atletico qualify for di UCL Round of 16. Di match start shakily as Brugge player, Hugo Vetlesen, nearly score, but David Hancko block am. As Atletico settle down, Na so, Jan Oblak pass long ball, Sorloth run to di ball, shoot, and Simon Mignolet […]

todayFebruary 25, 2026

Sports

Naija Sport Senior Man, Egbe Cry For Help Say NPFL Dey Crumble

By: Esther Ayoola Oga CEO of Sports Facilities Construction Limited, Ebi Egbe, don raise alarm say NPFL need emergency help. Say di league dey go ground every day following recent ranking by IFFHS say, di Naija league don fall enter 91st for world ranking. Reacting to di post for X, Egbe say na because say, football ground don kpafuka finish, no good pitch, ni make we nor dey see good football. Egbe use di opportunate take charge gornment to declare […]

todayFebruary 25, 2026 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app