Blog masonry

Background

Lagos

Akran Of Badagry, Oba De Wheno Menu-Toyi, Die For Age 89

By: Esther Ayoola Say nor be small badness sup for Badagry, dat De Akran of Badagry Kingdom, Oba De Wheno Menu-Toyi, don die for age 89 afta short sickness on Monday. Di respected king wey rule Badagry for almost 49 years na strong voice for Lagos State Council of Obas and Chiefs. Untop yanings with tori pipo, Lagos govo, Babajide Sanwo-Olu, tuk say im death na big loss to Badagry people, Lagos State and Nigeria because of di beta impact […]

todayJanuary 12, 2026 7 1029

National

Police Mehn Guide Kano State Gorment House

By: Esther Ayoola Say Security tie wrappa for Kano State Gornment House dat, oga govo,  Abba Yusuf dey make move to  defect go other party. Na so security mehn block di gate, combined security force  from di Nigeria Police Force and di Department of State Services (DSS) all of dem joinbodi for di location. According to report, if u must enter di gorment house, u must identify yaself, show ID card. Dis one sef dey follow speculation about a disagreement […]

todayJanuary 12, 2026 4

Lagos

Lagos Gorment Meet Doctors To End Strike

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment say dem ma dey do everytin within dia power to resolve issues wey dey behind di ongoing strike by di Joint Health Sector Unions (JOHESU) in di state. Di Permanent Secretary, Lagos State Primary Healthcare Board, Ibrahim Mustafa, yarn dis one for interview on Sunday. Mustafa say, gornment sabi say problem dey for di health sector and dat, dem ma dey dialogue to restore normal operations across public health facilities. Im explain oh […]

todayJanuary 12, 2026 3

National

FG And ASUU Fix Date For Deal Signing, January 14

By: Esther Ayoola Federal Gornment and Academic Staff Union of Universities (ASUU) say dem go meet for conner on Wednesday, January 14, 2026, sign new agreement to improve university education and maintain stability across di obodo Nigeria. Ministry of Education tuk dis for statement released on Sunday, saying di ceremony go hold for TETFund Conference Hall, Maitama, Abuja. Di event go dey presided by Minister of Education, Dr. Maruf Alausa, and Minister of State for Education, Prof. Suwaiba Ahmad, and […]

todayJanuary 12, 2026 5

obodo oyinbo

Iran Tell Us: We Ready To Tuk, But No Go Accept Intimidation

By: Esther Ayoola Iran tuk say dem still dey communicate with America through Switzerland, even as protest and violence dey spread for di country. Iran foreign ministry tuk say dem ready for dialogue but no go accept any one-sided tuk or foreign interference. Untop yaning for us, President Trump confamate say, Iran call am to negotiate nuclear matter, while e still dey threaten strong action. Meanwhile, gornment don shut internet, warn people make dem no protest, as other countries condemn […]

todayJanuary 12, 2026 5

Lagos

Chimamanda Lawyers Drag Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Solicitors wey dey represent Nigerian senior writer Chimamanda Adichie don write letter to Euracare Multi-Specialist Hospital, Lagos, over di death of her 21-month-old pikin, Nkanu Nnamdi, wey die on Wednesday, January 7, 2026. Di lawyers,  Prof Kemi Pinheiro (SAN), claim say di hospital, di anaesthesiologist, and attending medical staff breach di duty of care wey dem suppose give di pikin. Lagos State Gornment don confirmate say dem suspend di anaesthesiologist as dem dey investigate wetin happen for […]

todayJanuary 12, 2026 10 34

National

NARD Stop Strike Say Dem Dey Make Progress FG

By: Esther Ayoola Di National Association of Resident Doctors (NARD) don suspend dia planned nationwide strike say negotiation with Federal Government dey make progress. Di decision come during virtual Emergency National Executive Council (E-NEC) meeting wey dem hold on Sunday, to review status of dia demands and recent developments. NARD Secretary-General, Dr Shuaibu Ibrahim, tuk say di suspension dey strategic and conditional, and e allow NEC check tangible progress for next meeting wey go start on 25 January 2026. Di […]

todayJanuary 12, 2026 3

National

Police Gbab 4 Jaguda Bandits, Nab 65 Stolen Cows for Kaduna

By: Esther Ayoola Police for Kaduna State don show beta workings arrest four Jaguda bandits for Kakura area, Chikun Local Government, on Monday, wey dey carry 65 stolen cows. Police tuk tuk, DSP Mansir Hassan, wey tuk to our correspondent, say anti-kidnapping operatives follow correct intelligence, say ni dem take track di suspects. According to Hassan, di arrested people na Ibrahim Shuaibu alias Magaji, Buhari Ibrahim, Musa Haruna, and Abdullahi Idi, and dem dey from Kakura, Gora, and Dan Damisa […]

todayJanuary 12, 2026 7

Sports

Carrick Dey Lead Di Race To Take Over Man United As Caretaker Coach

By: Esther Ayoola Michael Carrick don turn favourite to take over as Manchester United caretaker coach, as people wey close to di club tuk am. According to transfer expert, United bosses wan choose person before players resume training on Wednesday, and discussion don reach final stages with Carrick. Di 44-year-old  don bin do di work  before back in 2021 after Ole Gunnar Solskjaer sack, and e win two matches draw one. Though Solskjaer sti dey tuk with di club about […]

todayJanuary 12, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app