Blog masonry

Background

National

Lassa Fever Don Kpai 263 People For Nigeria

By: Kofoworola Olayinka Lassa fever don kpai 263 pipo and infect 1,115 others for 24 states for Naija, according to di Nigeria Centre for Disease Control and Prevention, NCDC. For di agency report wey cover September 14 to 20, 2026, NCDC say dem record 11 new cases, compared to 17 cases di week before. Di new cases come from Ondo, Edo and Taraba states, and 119 local gornment areas don record cases this year. NCDC say five states  Bauchi, Ondo, […]

todayOctober 9, 2026 8

Lagos

Train Jam Car For Lagos, But Di Driver Escape Wunjure

By: Kofoworola Olayinka Ehwooo, make God shout for satan, na so devil one bin take di life of One 55-year-old driver, but hin  escape with  serious wunjure after train jam im Honda car for PWD railway crossing for Lagos. according by lagos traffic oga, Olalekan Bakare-Oki, Di train bin dey go Agege when di askident happen, and di car spoil wetin nor good. Beofr LASTMA officials and security men rescue di driver and comot di car from di railway track, […]

todayOctober 9, 2026 10

Sports

Eagles Coach Chelle scarra Say Young Boys to Enter Senior Team

By: Kofoworola Olayinka Super Eagles coachie Eric Chelle don go drop micro soft word dey shake everwia, jigijigi, say the young players wey play 3-3 draw with Russia get doings to play with di senior boys. U sabi say, Di coach use experimental squad wey get nine debutants, including three boys wey just be 19 years old play russia. Chelle explain say after how the boys take fight for Nizhny Novgorod, e go dey wrong for Nigeria to look those […]

todayOctober 9, 2026 10

Politics

FG tuk on how Tinubu reforms take reposition Naija economy

By: Kofoworola Olayinka Di Federal gornment don fire defence for wi oga Presido, Bola Tinubu, say hin economic reforms, like fuel subsidy removal, dey work wonders for di naija economy. Minister of Information, Mohammed Idris, and Finance Minister, Taiwo Oyedele, naim settle down fire dis mata wetin nor gud inside press conference wey dem do for Abuja. Dem explain say na di iron hand wey Tinubu take hold di naija economy, naim make investors dey come, if not everything for […]

todayOctober 9, 2026 8

Lagos

Lagos Fire Service Records 1,324 Emergency Call In Nine Months

By: Kofoworola Olayinka Lagos State Fire and Rescue Service don record 1,324 emergency incidents between January and September 2026, including 1,135 fire calls, as di state gorment beg resident to take fire prevention serious during dry season. Di service Senior Public Affairs Officer, Fadairo Maria, yarn dis for di third-quarter activity report, wey show say di incidents include 79 rescue calls, 100 salvage operations, nine collapsed-building incident and one gas-related explosion. Di report show say emergency responder rescue 210 pipu alive and […]

todayOctober 9, 2026 11

Lagos

Train Ram Car For PWD Railway Crossing, Driver Escape Injury

By: Kofoworola Olayinka A 55-year-old driver escape injury after train ran im Honda car for PWD railway crossing for Lagos as di vehicle suffer heavy damage. Di Lagos State Traffic Management Authority, LASTMA, say im officials and security personnel rescue di driver and clear di damaged car from di railway track. Di agency say di train wey dey head towards Agege continue im journey after dem clear di track, but traffic congestion still dey around PWD area. LASTMA General Manager, […]

todayOctober 9, 2026 10

Politics

ACF Tell FG Make Dem Set Time To Reduce Naija Suffering

By: Kofoworola Olayinka Di Arewa Consultative Forum don urge Federal Gorment to admit say e miscalculate di impact of economic reforms on Naija pipu and set timeto improve dia living conditions. Di Forum Publicity Secretary, Professor Tukur Mohammed-Baba, tuk dis as e point to rising cost of food, rent, transportation, electricity and insecurity as signs of di hardship wey Naija dey face. Mohammed-Baba say gorment suppose introduce measures within three months to reduce pipu suffering, and explain how e go […]

todayOctober 9, 2026 7

Sports

CAS Table Senegal Appeal Based on AFCON Title Drama

By: Kofoworola Olayinka Court of Arbitration for Sport don start to hear Senegal appeal, dia on side of di story, on how  dem take win  Africa Cup of Nations title, CAF con carry  give Morocco via Gmail. U sabi say dis one  hapun for Lausanne, ten months, after Pape Gueye extra-time goal give Senegal win against di host country. Wetin really play dat, na when di  Teranga Lions players comot field because referee give Morocco late penalty, na Brahim Diaz […]

todayOctober 9, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Promise No Attack For Iran Again Until November 3rd

By: Mariam Ajayi Iran military force don konfamate say dem dey do operation every night inside Strait of Hormuz to catch any ship wey break dia law. Mean wider, President Donald Trump say US for dia on part sef dey tuk with Iran and promise say, dem nor go attack dem before di November 3 midterm election. Already Dis tension don make oil price jump up by four percent, carry Brent go 104 dollars and WTI go 91 dollars per […]

todayOctober 9, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds