Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Edo Gov Swear In New Commission Boss

Edo State Gofnor, Monday Okpebholo, don swear in Terry Igiebor and Shittu Shaibu as chairmen of two state commissions for Benin on Thursday, to improve ecological management and electricity regulation. Prof. David Osifo, Thomas Inegbedion, Abdulrask Abubakar, Alex Oniawu and Patrick Iluobe also join as members. Okpebholo congratulate dem and say dia appointments come with big responsibility. E say di electricity commission especially important to help improve power supply and achieve better development for Edo people.

todayAugust 27, 2026 9

OBODO NAIJA

65 Nigerians Comot South Africa On Top Foreigners Wahala

By: Mariam Ajayi Another 65 Nigerians don return from South Africa as xenophobic attack and protest against foreigners. The returnees, wey include 30 adults, 34 children and one infant, arrive Lagos on Wednesday night through South African Airways. Foreign Affairs Minister, Bianca Odumegwu-Ojukwu, say private individuals fund the repatriation. She appeal to state governments to support the returnees, especially those wey leave their businesses and properties for South Africa.

todayAugust 27, 2026 11

OBODO NAIJA

Police Track N3.6bn Yahoo Money From Crypto

By: Mariam Ajayi Nigeria Police Cybercrime Centre, don trace more dan N3.6 billion suspected criminal money tru cryptocurrency conversion scheme. AIG Akaninyene Ezima disclose dis for Abuja, saying one Business Email Compromise suspect don make over N100 million from cyber fraud. E also say investigation into sextortion and romance scam uncover several victims linked to di same criminal identity.

todayAugust 27, 2026 9

OBODO NAIJA

Accord Candidate Say Petrol Fit Drop to ₦200 Under Hin Gorment

By: Mariam Ajayi Accord Party presidential candidate, Gbenga Olawepo Hashim, don tok say petrol no suppose pass ₦605 per litre if Accord enter gornment. Hashim say ₦605 go be di sustainable start price, and with time, petrol price fit drop reach as low as ₦200 per litre. E insist say cheap petrol no go affect government revenue or money wey dey enter FAAC. Di Accord candidate, wey oppose removal of petrol subsidy, describe di earlier reason wey government give for […]

todayAugust 27, 2026 9

OBODO NAIJA

Federal Gorment Start Nationwide Toktok for New National Water Compact

By: Mariam Ajayi Federal Gorment don begin nationwide consultation with states and other stakeholders to develop a National Water Compact wey go help tackle Nigeria water and sanitation problems and strengthen water security across di country. Minister of Water Resources and Sanitation, Prof. Joseph Utsev, disclose dis on Thursday for Abuja during di stakeholders’ consultation workshop for di development of Nigeria National Water Compact. Utsev say di initiative important because di water sector still dey face challenges like rapid urbanisation, […]

todayAugust 27, 2026 10

Sports

Chelsea Wan Sign Atalanta Young Defender Honest Ahanor

By:  Mariam Ajayi Chelsea dey in talk to sign Atalanta defender, Honest Ahanor, with di Italian club ready to sell di  highly-rated 18-year-old if Chelsea fit meet dia €40m (£34.3m) price. According  to report, Chelsea first show interest in Ahanor when dem dey negotiate di signing of Atalanta right-back Marco Palestra for July. Ahanor, wey mainly dey play left-back, join Atalanta from Genoa last summer for around €16m, with another €4m fit come as add-ons. Di young defender enjoy impressive […]

todayAugust 27, 2026 10

Entertainment

Love Relationship: Heartbreak Fit Make Pesin Enter Depression

She wake up for 1am, depression hold am, she siddon for her bedside dey cry and sweat. She check her phone, no message enter her phone at all, according to one app wey dey her phone, she don open WhatsApp 334 times, dey wait desperately for message from her lover since around 9pm di previous night. She check her phone as she dey dress for work, as she dey chop, even while seh dey go work. All she want na […]

todayAugust 27, 2026 27 1

OBODO NAIJA

Nasarawa Gofnor Order Torchlighting Untop Missing Hospital Tins

By: Mariam Ajayi Nasarawa State Govo, Abdullahi Sule, don order immediate torchlighting into reported missing mattresses and fans wey dem donate to Umaisha General Hospital for Toto Local Government Area. Di  matter come up after lawmaker representing Umaisha/Ugya constituency for Nasarawa State House of Assembly, Sa’ad Abdullahi, raise alarm say hospital staff no fit account for some medical items wey e buy and donate to di facility. Di lawmaker, wey be member of APC, visit di hospital to check di […]

todayAugust 27, 2026 6

Sports

Ander Herrera Go Back To Real Zaragoza

By: Mariam Ajayi Former Manchester United midfielder, Ander Herrera, don return to hin boyhood club, Real Zaragoza, after 15 years away, e say to play for di Spanish side for free na dream come true for am. Di 37-year-old midfielder join on  free transfer from Boca Juniors as e look to help di club rebuild and return to better days. Herrera start hin professional football career with Zaragoza before e later play for Athletic Club, Manchester United, Paris Saint-Germain and […]

todayAugust 27, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds