Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Atiku Condem FG 30 days Giveaway Petrol Plan

By: Mariam Ajayi Pepper bodi every wia as wi Federal gorment take announce say dem wan package 30 days give away price for petrol inside NNPC filling stations across di obodo Naija. Latest to fire mouth untop di mata, na di Africa Democratic Congress, ADC, presidential candidate, Atiku Abubakar. Di b4 vice presido say di APC gorment na desperado naim dey do dem and dis wan nor go do anything for di hardship wey nigerians dey face.

todayOctober 9, 2026 10

Lagos

Lagos Gorment Beg Youth To Put Bodi For Military Recruitment

By: Mariam Ajayi Lagos State Gornment don begin toast lagos youths wey dey between 18 and 26 years say make dem join  military sake of say di state need meet  dia recruitment quota. Say dis nor be to look and thruway face like say insecurity nor concern youth, dat naija reallyneed beta collabo and energy to battle insecurity. Senior man Seco to di Gornment, Abimbola Salu-Hundeyin, naim drop dis micro soft word during meeting with local gornment secretaries and Police […]

todayOctober 9, 2026 8

Entertainment

US Consul General Honours Nollywood Stars For Lagos

U.S. Consul General, Brandon Hudspeth, don host special reception for distinguished Nollywood actors and big names for Naija creative industry. Di private event wey happen for U.S. Consul General residence celebrate dia contributions to Nigerian storytelling and creative industry. Di gathering bring together Nollywood talents, industry leaders and cultural ambassadors wey dey help put Nigerian stories for global stage. Di event also highlight di strong connection between Hollywood and Nollywood, as creatives come together to celebrate dia work and achievements.

todayOctober 8, 2026 17 1

Lagos

Hit And Run Driver Jam Teenager For Onipanu BRT Lane

By: Mariam Ajayi One teenage boy don land for hospital after hit and run driver jam am as e dey cross Onipanu BRT corridor dey go Fadeyi for Lagos State on Wednesday. Di boy sustain serious head and leg injuries for di accident, according to wetin di Permanent Secretary of LASEMA, Dr. Olufemi Oke-Osanyintolu, talk. LASEMA Cobra Team sharp-sharp run reach di scene within two minutes around 4:32 pm to give di boy first aid treatment. After dem give am […]

todayOctober 8, 2026 13

OBODO NAIJA

AAU Lecturer Kpai Inside Hotel Room For Edo State

By: Mariam Ajayi One senior lecturer for Ambrose Alli University, Ekpoma, Dr. Matthew Uwuigbe, don kpai inside one hotel room for Edo State after e reportedly lodge with one 21-year-old woman. Police say di woman comot go buy water for am, but when she come back, she see di lecturer kpai for di room and raise alarm, as police don arrest her, di hotel owner and manager for investigation. AAU don confirm say Uwuigbe na dia academic staff, but di […]

todayOctober 8, 2026 13 2

obodo oyinbo

China Don Put Forward Song Li To Head WHO

By: Kofoworola Olayinka China don nominate maternity health expert, Song Li, to become di next Director-General of World Health Organization, WHO. China Foreign Ministry spokesperson, Mao Ning, announce di nomination on Thursday, say e show Beijing strong support for and global health. Song Li, wey dey head Department of Women and Child Health for China National Health Commission, get 21 years experience for women and children health matters. She go contest di position against candidates from Qatar, Saudi Arabia, Belgium, […]

todayOctober 8, 2026 10

OBODO NAIJA

NAF Helicopter Land For Farm After Kidnapper Operation

By: Kofoworola Olayinka Nigerian Air Force, NAF, don explain say one of dia helicopters wey land for farmland for Makurdi, Benue State, dey return from operation against suspected kidnappers along Enugu-Benue boundary. NAF spokesman, Air Commodore Ehimen Ejodame, say di helicopter provide close air support to ground troops during operation for Ogbadigbo area, wey help disrupt activities of di suspected kidnappers. Ejodame say di pilot later make precautionary landing about 10 nautical miles from di airfield after e complete di […]

todayOctober 8, 2026 8

Sports

Shooting Stars Fans Vex, Say Make Coach Salisu Yusuf Comot

By: Kofoworola Olayinka Di Oluyole Warriors don win only one game for dia last six league matches. Dis kind result  make dia fans vex wetin nor good. As di match finish, fans for di stadium begin shout, Salisu must go! Dem continue di chant as dem show say dem no happy with wetin di team dey do. Shooting Stars go meet Kun Khalifat for dia next league game. Di Oluyole Warriors go need win for dat match to stop di […]

todayOctober 8, 2026 9

obodo oyinbo

Trump Tuk Say Iran War Go End Soon

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don tuk say di war between US and Iran fit end soon. E tuk dis one for a campaign rally for San Antonio, Texas on Wednesday. Trump say Steve Witkoff, wey be US tok tok pesin wen dey follow iran pipo dem tok, dey work on how dem fit stop di war. E say Witkoff dey do well for di tuk Trump also say Iran no go ever get nuclear weapon. E praise […]

todayOctober 8, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds