Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Army and Immigration Join Hand To Tighten Border Security For Yobe

By:Mariam Ajayi Nigerian Army and Nigerian Immigration Service don promise to work more together to strengthen border security, manage migration and tackle new security threat for Yobe State. Dem make di commitment on Wednesday when Commander Headquarters Sector 2, Joint Task Force North East, Operation HADIN KAI, Brigadier General Edet Effiong, receive di newly posted NIS Yobe Comptroller, Comptroller IZ Abubakar, during a courtesy visit to di Sector Headquarters for Damaturu. Effiong stress say security agencies need to continue working […]

todayAugust 27, 2026 7

OBODO NAIJA

Kwara Police Commissioner Start Surprise Inspection For Police Divisions

By: Mariam Ajayi Kwara State Police Commissioner, Ojo Adekimi, don start surprise inspection of police division and formation across di state to check officers discipline and work condition. Di inspection, wey start on Wednesday, cover Area Command, Metro, Ilorin, plus 12 divisional police headquarter inside Ilorin metropolis. Di State Police Public Relations Officer, Adetoun Ejire-Adeyemi, fry mouth on top dis mata for statement on Thursday. She tok say di exercise go allow di commissioner personally assess officers professionalism and commitment, identify […]

todayAugust 27, 2026 9

OBODO NAIJA

Federal Gorment Say 60% Of Active Electricity Customers Get Meter

By: Mariam Ajayi Federal Gornment don announce say 60 per cent of active electricity customer for Nigeria don get meter as gornment dey work to end estimated bill. Government say 668,000 meter don already dey installed out of di 1.033 million meters delivered under di World Bank-backed programme. Di initiative, wey include Presidential Meter Initiative, dey target di electricity metering gap and stop arbitrary estimated bill for registered customer.

todayAugust 27, 2026 6

Politics

Makinde Pick Anthony Ehilebo As Media Adviser For Im 2027 Campaign.

Oyo State Gofnor and presidential candidate of di Allied Pipo Movement, Seyi Makinde, don appoint Anthony Ehilebo as hin Special Adviser on Media and Digital Communication. Makinde media aide, Sulaimon Olarenwaju, announce di appointment for Ibadan, say e don take immediate effect, while more campaign team appointments go follow. Makinde say Ehilebo’s experience as communication strategist and lawyer go help push APM message and campaign to reset Nigeria ahead of di 2027 presidential election

todayAugust 27, 2026 12

Sports

Italy Withdraw Support For Infantino FIFA Re-Election

By: Yusuf Abuh Italy Football Federation don withdraw dia support for FIFA Presido Gianni Infantino re-election bid, as concern over FIFA governance continues to grow. FIGC make di decision to align with UEFA and Presido Aleksander ÄŒeferin, following controversy over plans to sell 20 per cent stake in FIFA commercial rights company to private investors. FIGC boss Giovanni Malago say dem want football system wey dey based on merit, solidarity, sustainability and fans interest. England, Wales, Ireland, Serbia and some […]

todayAugust 27, 2026 13

obodo oyinbo

How Nepal Floods Kpai kpai Over 160 People As 403 People Missing

By: Yusuf Abuh At least 160 people don die and 403 others still missing after heavy floods and landslides hit northern Nepal near Tibet border on Wednesday, destroying whole communities. Nepali police say dem don recover 157 bodies, while Chinese state media report three deaths and 265 people missing for di Chinese side of di border. Nepal tourism ministry say 403 tourists, including 341 foreigners, don also go missing hours after di disaster hapun. Among di missing foreigners na 142 […]

todayAugust 27, 2026 9

OBODO NAIJA

FG Announce Ogbonge $1bn Funds Wey Dem Wan Use Help Poor Pipo

By: Yusuf Abuh Federal Gornment don launch $1 billion Renewed Hope Social Protection Programme to help poor Nigerians. First Lady Oluremi Tinubu, AKA iya Alakara naim porporly dis mata on Wednesday for Presidential Banquet Hall, State House, Abuja, say dis project wey dem call HOPE-SP go helep create ogbongelicious small businesses for country man and woman. Iya Oluremi say di programme go listen to di specific needs of poor families before gornment action, dis one mean say everybody go dy […]

todayAugust 27, 2026 8

OBODO NAIJA

Baba Presido Tinubu Beg Ogas of Gas to Make Naija Gass Business Work

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don ginger  Naija Liquefied Natural Gas, NLNG to reduce gas flaring and make better use of Nigeria gas reserves so Nigerians fit enjoy more economic benefits. Tinubu make di call on Wednesday for State House, Abuja, when e meet NLNG Board members wey  di company Managing Director and CEO, Adeleye Falade carry come. Baba Seyi say NLNG must look beyond making money from international market and focus more on using Nigeria gas […]

todayAugust 27, 2026 11

Lagos

Lagos Police Join Youths For Peace Waka Against Jaguda Doings

By: Yusuf Abuh Lagos State Police Command don join youths and key stakeholders for Peace Walk to mark International Youth Day 2026 and launch campaign against political and digital thuggery. Di walk, led by Commissioner of Police CP Tijani Fatai, happun to promote peace, responsible citizenship and positive youth engagement across Lagos. Oga CP campaign also dey encourage youths make dem reject violence, online abuse and political thuggery while promoting responsible participation.

todayAugust 27, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds