Blog masonry

Background

Lagos

FAAN, Cargo Agents Agree ₦15 Per Kg Cargo Charge For MMIA

By: Esther Ayoola For Lagos, FAAN and cargo agents for Murtala Muhammed Airport don agree to new cargo charge of ₦15 per kilogramme. Director of Public Affairs, Henry Agbebire, ni dey explain dis mata on Tuesday to tori pipo say, di agreement land afta stakeholders meeting wey the Director of Cargo Development, Lekan Thomas, preside on Monday. Both sides agree say dem discuss seriously before dem settle on di new charge. FAAN tuk say di arrangement go help standardize cargo […]

todayFebruary 10, 2026 18

National

US Humanitarian Group Land Southern Kaduna To Check Public Hospitals

By: Esther Ayoola Senator wey dey represent Kaduna South, Sunday Katung, don carry one humanitarian group from America, Project C.U.R.E., to checkmate some public hospital for Southern Kaduna. Katung say di team, wey Rose Polycarp, wey be registered nurse from US dey lead, come assess how health facilities and services dey work for Kaduna. Say Dem don already visit Kagarko General Hospital, Kachia General Hospital and General Hospital Gwantu, while Zonkwa General Hospital and Sir Patrick Ibrahim Yakowa Hospital for […]

todayFebruary 10, 2026 4

National

FG Hail Committee As Naija Collobi IMO Council Seat

By: Esther Ayoola Di  Federal Government don commend nine members of Inter-Ministerial Committee wey help Nigeria secure Category C seat for International Maritime Organisation (IMO) Council, di Minister of Marine and Blue Economy, Dr Adegboyega Oyetola, yan on Tuesday for Lagos. Oyetola tuk say di commendation follow di committee contribution wey naija Nigeria to win di seat for 2026–2027 biennium. Nigeria secure di seat during IMO Council elections wey hold on Nov. 28, 2025, for London. Di Minister say di […]

todayFebruary 10, 2026 4

obodo oyinbo

Germany Top Court Go Rule On Arms Export To Israel

By: Esther Ayoola For Germany, di Federal Constitutional Court go rule on Thursday whether Palestinian civilian from Gaza fit challenge German arms export to Israel, case wey human rights groups say fit set big precedent. Di complaint come from Gaza resident wey lose im wife and pikin during Israeli military strikes, with support from European Center for Constitutional and Human Rights and Palestinian partner groups. Lower courts bin earlier dismiss di case, even as di man still dey live with […]

todayFebruary 10, 2026 4

Sports

Ukrainian Athlete Get Permission To Wear Black Armband For Olympics

By: Esther Ayoola For Milan Cortina Winter Olympics, Ukrainian skeleton racer Vladyslav Heraskevych don get di go ahead from Olympic Organisers to wear black armband to honor Ukrainian sports pipo wey Russia kill for war. IOC tuk, tuk, Mark Adams normally dis move dey against Olympic rules, tuking about political symbols, so dem bin ban am b4. Meanwhile, Ukrainian Presido, Volodymyr Zelensky support Heraskevych right to show respect to fallen athletes. IOC say, athletes fit express dia views for press […]

todayFebruary 10, 2026 5

Lagos

APC For Ikorodu Rally Support For Tinubu 2027

By: Esther Ayoola Chairmo of Di All Progressives Congress, Lagos branch, Cornelius Ojelabi, and Lagos East Senator, Tokunbo Abiru, don dey ginger boys for Ikorodu make dem gather support for baba Seyi for 2027 election. Dem yarn dis one during one ogbonge  stakeholders’ meeting for Ikorodu wey APC members put body for President Bola Tinubu for second term. Abiru tuk say di meeting na to unite party members and make sure say dem get strong support for di baba Seyi.

todayFebruary 10, 2026 10

Lagos

NAFDAC Burst Big Fake Drug Racket For Lagos

By: Esther Ayoola Operatives of National Agency for Food and Drug Administration and Control, NAFDAC don burst one serious fake drug racket for Lagos, seize over 10 million fake and banned medicine wey dem hide inside warehouse for Trade Fair–Navy area, Lagos. Director of Investigation and Enforcement for NAFDAC, Martins Iluyomade, say na sharp intelligence wey dem get afta training meeting on February 3, nai make dem uncover di place. E call di operation one of di worst wey don […]

todayFebruary 10, 2026 8 4

Lagos

Makoko Residents Beg Gornment As Lagos Lawmakers Inspect Demolitions

By: Esther Ayoola On Monday for Makoko waterfront inside Lagos, residents and children cry out, dey beg, (say "Jọwọ") as members of Lagos State House of Assembly come visit di area to check ongoing evictions. Di lawmakers, wey come under House Committee on Rules and Business for fact-finding mission, hear from students of Makoko Students Association wey sing national anthem and tell gornment say “our community, na our home,” begging dem make dem no demolish am. Di visit come afta […]

todayFebruary 10, 2026 5 2

National

Osogbo Imam, Four Others Enter Court For Murder Case

By: Esther Ayoola Imam Abdulgafar Sakariyah, and four oda people don appear for Osogbo Chief Magistrates’ Court over how one worshipper, Ahmed Najeem, kpai during early morning prayers. Say dem jaguda boys beat Najeem afta e allegedly try to attack Imam for Ummu Haani Adigun Memorial Central Mosque on January 30. All of dem do face like stonecold as police arrest dem for di murder charge. Say aproko pipo now dey call make dem install CCTV cameras for all worship […]

todayFebruary 10, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app