Blog masonry

Background

south west

Gunmen Carry Former Minister Of Power Adelabu Sister And Twins For Ibadan

By: Esther Ayoola Former Minister of Power, Adebayo Adelabu, don cry out say armed men kidnap im younger sister, Olaide Busayo Adegoke John-Paul, and her 12-year-old twin boys for Ibadan. According to wetin im media aide, Femi Awogboro, talk, di attack happen early morning Wednesday as she dey carry di children go school, when gunmen block road and force dem enter motor. As Yoruba elders take tuk am, “when bush catch fire, even tortoise go run,” so di family don […]

todayJune 3, 2026 14

Sports

Liverpool Appoint Iraola As New Manager Afta Slot Sack

By: Esther Ayoola Liverpool don reach agreement to appoint Andoni Iraola as dia new manager afta successful tuks. Transfer expert Fabrizio Romano confirm di deal for X, say agreement don almost complete with im famous “here we go” update. Dis move come just few days afta di club sack Arne Slot following end-of-season review of dia performance. Iraola, wey lead AFC Bournemouth finish sixth and secure dia first-ever European qualification, na Liverpool preferred choice for di job.

todayJune 3, 2026 8

Entertainment

FIFA Pick Davido For World Cup 2026 Concert For LA

By : Jolayemi Olajide FIFA don announce say Nigerian music star Davido go perform for Los Angeles leg of the World Cup 2026 Countdown Concert wey go hold on Wednesday, June 10. Di event go also feature Diplo Major Lazer, with more artistes still expected to join the lineup. FIFA tuk say di concert na part of global music series wey go hapun for Canada, Mexico and United States as World Cup build-up. Di show go hold for Crypto.com Arena […]

todayJune 3, 2026 16

obodo oyinbo

US-Iran War Spread enter Gulf as Missile, Drone Attack Increase

By : Jolayemi Olajide As US and Israel war against Iran enter 96th day, fight don spread reach Gulf region as both sides dey report fresh military action. US military tok say dem carry out “self-defence” strike for Iran Qeshm Island on Wednesday, while Iranian media report say explosion shake di area. Kuwait say im air defence system stop some drones and missiles, while Bahrain activate warning sirens as tension rise for the region.

todayJune 3, 2026 8

obodo oyinbo

Wetin be dis?! Striking teachers pull down giant football statues for Mexico, threat to scatter World Cup!

By : Jolayemi Olajide   Dey say goat wey stubborn follow lion enter bush, na im body go tell am say forest no be play ground. na serious wahala wey dey brew for Mexico City. Teachers wey dey vex don use rope pull down three giant football player statues, tear jersey commot, even set am on fire. Dem dey para say gornment no answer dem for dia labour demands as cost of living wan kpai di living. Di teachers’ union, […]

todayJune 3, 2026 9

Sports

Late Drama As Wales Hold Ghana 1-1

By: Esther Ayoola Lewis Koumas score late equaliser for added time as Wales draw 1-1 with Ghana for friendly match wey happen for dia home ground. Di result mean say Ghana never fit win any of dia last four matches, with three losses and one draw for dia recent games. Di Black Stars miss chance to start well under coach Carlos Queiroz as part of dia preparation for World Cup.

todayJune 3, 2026 8

obodo oyinbo

Benin New President Visit Niger As Both Countries Try Fix Dia Relationship

By: Esther Ayoola Benin new leader, Romuald Wadagni, don visit Niger on Tuesday, marking di first presidential visit since di 2023 coup wey happen for Niamey. Di visit show say tension between di two neighbours don reduce afta Niger military gornment close border with Benin. Niger junta leader, Abdourahamane Tiani, naim receive Wadagni as dem plan tuk on how to restore security cooperation between both countries.

todayJune 3, 2026 7

National

Court Luck 5 Police Officers For Prison For Di Ogidi Killing Inside Effuren

By: Esther Ayoola Delta State High Court for Asaba don order make dem lock di ASP Usman Nuhu, and im four gang member for Ogwashi-Uku Correctional Centre. Dis officers dey face case say dem do extrajudicial killing of 28-year-old Oghenemene Ogidi, wey people know as OG Millan, for Effurun, Delta State. Di incident happen on April 26, 2026, and e cause serious public outrage afta video of di shooting circulate online. Court order say make dem remain in custody for […]

todayJune 3, 2026 11

National

How 13 Reps Members Switch Party For House As Dem Resume Work

By: Esther Ayoola As House of Representatives resume from four-week break on Tuesday, na 13 lawmakers announce say dem don change political parties. Speaker Abbas Tajudeen read di defection notices during plenary, with lawmakers from Nasarawa, Cross River, Edo, Katsina, Oyo, Delta and Bauchi states joining different parties. Most of di lawmakers wey defect say internal crisis, leadership quarrel and factional divisions for dia former parties naim be di reason wey push dem to move go new political platforms. Dem […]

todayJune 3, 2026 11 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds