Blog masonry

Background

National

FCCPC Clear Air Say Airtime Borrowing Still Dey, No Ban At All

FCCPC don come out tuk on Friday for dia official X page say dem never ban airtime borrowing or data advance anywhere for Nigeria, as viral social media posts bin dey claim. Di Commission say those reports na false and misleading. Dem explain say people still fit use all telecom value-added services normal, and dat nothing don change.

todayApril 18, 2026 17

Uncategorized

Governor Sanwo-Olu Hail Ex-IGP Musiliu Smith As E Clock 80

Oga Govo of Lagos, Babajide Sanwo-Olu don wire ogonge  congratulation message to former Inspector-General of Police, Alhaji Musiliu Smith (rtd), as e celebrate im 80th birthday. For statement wey im Special Adviser on Media and Publicity,  Gboyega Akosile release, he hail Smith as person wey get selflessness and strong commitment to public service. Sanwo-Olu  say Smith na visionary and well-respected elder wey serve Nigeria with full dedication. E also praise am say as IGP, E do im work with professionalism […]

todayApril 18, 2026 16 1

Uncategorized

Why Lagos Court Frees Policemen Wey Kpai Innocent Traders Over Land Wahala

Say Lagos State Ministry of Justice don free di four policemen and one developer, Abiodun Ariori, wey dem accuse of kpaing  traders for Owode Onirin, Kosofe area.  Directorate of Public Prosecutions tuk say di policemen act on self-defence, and no strong evidence dey to charge dem for manslaughter. Di victims kpai after di policemen, Musa Bala, Ahmed Abass, Ibrahim Kasimu and Ibrahim Garba, open fire during di incident. Report show say Ariori carry di policemen come from Nasarawa to enforce […]

todayApril 18, 2026 14

National

Police Arrest 7 Suspects for Benue Kidnap Case

Security operatives for Benue State don arrest seven suspects wey dem link to di kidnapping wey hapun for Otukpo Local Government Area. Police PRO, Udeme Edet, naim dey konfamate  di mata for statement wey dem release on Friday. Recall say, di attack hapun on Wednesday when gunmen stop one Benue Links bus, rob di passengers and carry some of dem enter bush. Police tuk say na 14 people dem kidnap, though some reports say e fit reach 17, and one […]

todayApril 18, 2026 25

Lagos

First Lady Insist Say Na Unity, Love And Respect Go Push Nigeria Forward

First Lady, Oluremi Tinubu again don press tuk  say national development go only work, when citizens joinbodi share values like love, tolerance, peace, sacrifice, compassion and service to humanity. She yarn this one on Friday for wia  she go do inauguration of Odo-Noforija Ultra-Modern Central Mosque for Epe, Lagos State. She no dey there physically, she send message through her Senior Special Assistant on Public Affairs and Strategy, Wahab Alawiye-King take ru di mata. She still emphasize say Nigeria strength […]

todayApril 18, 2026 43

Sports

Saudi Arabia Sack Coach Renard Weeks Before 2026 World Cup

French coach Herve Renard don lose im job as Saudi Arabia national team coach, just few weeks before 2026 World Cup go start. Di French man naim by imself dey konfamate dis development for interview on Friday. Renard, wey be 57 years old, come back to coach Saudi for second time for 2024, after  carry dem go last World Cup and even beat Argentina that time. Before dis Saudi waka, Renard don coach big teams before, including Zambia and Ivory […]

todayApril 17, 2026 12

obodo oyinbo

Iran insist say Strait of Hormuz Go Remain Open till Ceasefire End

Iran don talk say Strait of Hormuz dey fully open for all commercial ships to pass as ceasefire dey between Israel and Lebanon. Abbas Araghchi yarn this one for X, say as dem agree ceasefire, ships fit move freely for the remaining time. Dem also talk say make vessels follow the normal coordinated route wey Ports and Maritime Organisation of Iran don already announce. Di so called  ceasefire wey dem say go last 10 days, still dey uncertain, as e […]

todayApril 17, 2026 19

OBODO NAIJA

Ondo Monarchs Beg Tinubu to Share Pipeline Surveillance Power for Ilaje 

Monarchs from Ilaje Local Government Area for Ondo State don wire  appeal  letter wi oga  Presido,  Bola Tinubu make dem dis pipeline surveillance work touch everywia. Di traditional rulers under Ilaje Council of Obas tuk dis one inside letter wey dem send to President and sign by Secretary, Oba Obafemi Ogbaro, after dem meet for Igbokoda headquarters on Friday. Dem explain say di current central system dey limit community involvement and e dey create security gap wey fit affect oil […]

todayApril 17, 2026 12

Lagos

NSCDC Burst Baby Factory for Badagry, Rescue 18 Pregnant Women, 10 Pikin 

NSCDC Lagos Command spokesman, Afolabi Babawale, tuk say dem do small jet li  burst one baby factory for Okuju, Ilado for Badagry on Wednesday night into Thursday morning after dem get tip-off about the illegal operation. Babawale explain say operatives raid di place, rescue 18 pregnant women and 10 pikin, and arrest the operators, Joy Okeke and Raphael Agwu. According to am, the victims wey dey  between 18 and 30 years join the centre through Facebook offer, where dem promise […]

todayApril 17, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds